43
Dem Take Jeremaya Go Egypt
Wen I don tell di pipol evritin wey di Oga dia God sey make I tell dem, Azaraya wey bi Hoshaaya pikin and Johanan wey Kareah born with di oda sturbon men for Jerusalem kon tell mi, “Na lie yu dey lie! Di Oga awa God nor sey make yu tell us make wi nor go Egypt. But na Baruk wey Neraya born, na-im sey make yu tell us dis kind lie, so dat Babilon pipol go kill or karry us go Babilon, bikos dem get pawa pass us.” So Johanan, di sojas offisa and di oda pipol nor gri stay for Judah, just as God kommand dem. Den Johanan kon karry doz wey remain for Judah; both di men, wimen, shidren, di king dotas and di pipol wey kom from oda nashons, go Egypt. Evribody wey Nebuzaradan wey bi di sojas oga leave for Gedalaya kare, dem karry dem go Egypt. Dem still karry mi and Baruk follow body. Dem nor obey wetin God kommand and dem kon go Tahpanhes town for Egypt.
God tok to mi for Tahpanhes sey, “Make yu take some big-big stone for Judah pipol front kon go beri dem for Fero house front for Tahpanhes. 10 Den tell di pipol sey, ‘Mi wey bi Israel God wey dey mighty go bring my savant, King Nebukadnezzar for Babilon kom dis place and e go put en throne kon spread en royal tent on-top dis stone wey Jeremaya beri so. 11 Nebukadnezzar go kom win Egypt. Di pipol wey I don sey diziz go kill, na diziz go kill dem; doz wey dem go karry go as prisonas, dem go karry dem go and doz wey dem go kill for war, go die for war. 12 I go set fire for Egypt gods temple and Babilon pipol go burn dia gods or karry dem go. Just as shepad dey kill and remove all di lice wey dey en klot, na so too Babilon king go kill and remove Egypt pipol from dia land. 13 E go distroy dia juju pila wey dey di Sun Temple with all di gods for Egypt; den e go burn dia temple rish groun.’ ”