7
Akan Sin
Israel pipol disobey wetin dem tell dem about di tins wey dey Jeriko. Akan wey bi Karmi pikin, wey Zabdi born, wey Zera born from Judah tribe, kon tif some tins from Jeriko, so God kon dey vex for Israel pipol.
Joshua send men from Jeriko sey make dem go spy Ai town (Ai town dey near Bet-Aven, di east side for Bethel land) e kon tell dem, “Make una go spy di land.” So di men kon go spy di town.
Dem kom back kon tell Joshua, “Nor send all di sojas go, about two or 3,000 sojas go distroy di whole Ai town. Nor disturb di whole sojas, bikos Ai na small town.” So about 3,000 men kon go, but dem run from Ai men. Ai men kill about thirty-six from dem kon porshu di rest of dem from di town gate go rish di low aria. Di pipol pawa fail dem like ice-blok wey dey melt.
Joshua tear en klot; en and di leaders for Israel fall for groun before di Kovenant Box until evening and dem pak dirty full dia head Joshua kon pray, “My Oga God! Wetin make Yu take us cross Jordan River kon give us to Amor pipol, so dat dem go distroy us?
“Why wi nor just stay for di oda side for Jordan River! Wetin I go tok naw wey Israel pipol dey run from dia enemies? Wen Kanaan pipol and evribody wey dey stay di land go hear wetin happen so, all of dem go kom distroy us and nobody go remember us. My Oga God, wetin Yu go do to keep yor respet?”
10 God ansa Joshua, “Make yu get up! Wetin make yu face groun dey mourn? 11 Israel pipol don sin; dem don go against my kommandment! Dem take some tins wey I sey make dem keep for mi from Jeriko; dem tif dem kon put dem join dia own propaty. 12 Israel pipol nor fit stand for dia enemies front; dem run bikos disgrace don dey follow dem. I nor go dey with una again, unless una distroy wetin make dis wahala dey happen to una.
13 “Make yu get up! Go santify di pipol make yu tell dem: ‘Make una santify unasef before tumoro, bikos Israel God sey, “Israel pipol, una body dey dirty! Una nor go fit fight una enemies until una remove wetin make una dirty.”
14 “ ‘Wen day break, una must kom akordin to tribe. Di tribe wen God go choose go kom akordin to village. Di village wey God go choose go kom akordin to family. Di family wey God go choose must kom man by man. 15 Di pesin wey dem katch with di propaty, dem must burn am with evribody wey bi en own, bikos e nor do wetin God tok and e don disgrace Israel pipol.’ ”
16 Di next day for early morning, Joshua kon tell Israel pipol make dem kom tribe by tribe and God kon choose Judah tribe. 17 Joshua sey make di pipol for Judah kom village by village and God kon choose Zera village. Joshua sey make Zera pipol kom family by family and God kon choose Zabdi family. 18 Joshua sey make Zabdi Family kom man by man and God kon choose Akan wey en papa na Karmi and Karmi papa na Zabdi wey bi Zera pikin and Zera kom from Judah tribe wey God choose.
19 So Joshua kon tell Akan, “My pikin, respet Israel God make yu praiz am! Tell mi wetin yu do; nor deceive mi at-all!”
20 Akan kon tell Joshua, “Na trut. I don sin against Israel God: 21 From di tins wey wi karry from Jeriko, I si one fine klot from Babilon, with two silva koin and one gold wey heavy rish fifty fit. I like dem, so I take dem. I hide dem under di groun for my tent centre.”
22 So Joshua send pipol go di tent. Di tins dey for di tent and di silva dey under dem. 23 Dem take all of dem from di tent centre kon go give Joshua and Israel pipol kon put am for where God go for si am.
24 Den Joshua and Israel pipol take Akan, Zera pikin with di klot, di silva, di gold, en shidren, melu, donkey, sheep, tent and evritin wey bi en own go Akor Valley (wey mean Wahala Valley). 25 Joshua kon sey, “Wetin make yu bring wahala for awa head? God go put wahala for yor head today!”
So, evribody for Israel stone en, en family and evritin wey e get until dem die finish, den dem kon burn dem. 26 Dem pak many stones on-top dem (di stones dey der till today) and God vexnashon kon stop. So till today, na Akor Valley dem dey koll dat place.