8
Israel Distroy Ai
God tell Joshua, “Make yu nor fear or bigin shake! Take all di sojas make una mash go Ai! Si, I dey give yu Ai king, plus di pipol and di town. Make yu do wetin yu do for Jeriko to Ai, en king and en pipol, but una fit keep dia animals for unasef. Naw, make una dey ready to attack di town from back!” Joshua and all di sojas kon mash dey go Ai town. Joshua choose 30,000 strong sojas kon send dem go for nite. E tell dem, “Make una hide for di town back. Make una nor too go far from di town and all of una must dey ready! Mi and di oda sojas go mash go di town. Wen dem kom out kon fight us like before, wi go run leave dem. Dem go dey porshu us until wi don draw dem go far from di town, bikos dem go sey, ‘Dem dey run from us like before.’ Den una go kom out from where una hide put kon distroy di town. Di Oga una God go give di town to una. Wen una don enter di town, make una start to burn am. Make una do as God don tok! Si, I don give una ordas.”
Joshua send dem and dem kon go hide for di west side for Ai, between Ai and Bethel. Dat nite, Joshua stay with di sojas.
10 As day just break, Joshua gada di sojas with di leaders for Israel and dem kon mash go Ai for front. 11 All di sojas dey mash with am as dem near di town. Dem kon stay for di nort side for Ai wey dey di oda side for di valley. 12 Joshua hide 5,000 men for di west side between Bethel and Ai. 13 Di sojas dem don ready; both di ones wey dey nort and di ones wey dey hide for west. For dat nite, Joshua kon go di valley centre.
14 Wen Ai king si Israel pipol, en and all en sojas kwik-kwik get up di next day go fight Israel for Arabah. But Ai king nor know sey some men hide for di town back. 15 Joshua and all di sojas for Israel kon do like sey Ai men dey win dem, so dem kon dey run go di desert. 16 Ai king kon sey make all en sojas porshu dem; dem porshu Joshua and e take dem far komot from dia town. 17 No soja remain for Ai or Bethel; all of dem don porshu Israel pipol and dem leave di town open.
18 God kon tell Joshua, “Dis swod wey dey yor hand, make yu point am face Ai, bikos I don gi-am to yu and yor sojas.” 19 Wen e stresh en hand, di men wey hide before kon get up attack di town. Dem enter di town kon bigin burn am at wons.
20 Wen Ai men turn back, dem si smoke from dia town dey go heaven and fear katch dem and dem nor fit run go anywhere. Dis time, di men wey dey run before go di desert kon turn back face Ai men wey dey porshu dem. 21 Wen Joshua and Israel pipol si sey di men wey hide don enter di town and di town don dey katch fire, dem kon turn and bigin kill Ai men. 22 For dat same time, di men wey burn di town don kom out kon fight, so Ai men kon dey di middle. Israel sojas kill all of dem. 23 But dem katch di king alive, bring am kon meet Joshua.
24 Wen Israel pipol don kill all di men for Ai wey porshu dem go desert, all of dem kon go back to Ai go kill evribody wey dey der. 25 Na 12,000 men and wimen die dat day, plus all di men for Ai. 26 Joshua still stresh en swod until Israel don kill evribody wey dey stay for Ai. 27 But Israel pipol keep all Ai tins and animals for demsef, just as God tell Joshua.
28 Joshua burn Ai and nobody fit stay der (na so e bi till today). 29 Joshua hang Ai king for tree kon leave am for der until evening. Wen sun don go down, Joshua kon tell di sojas sey make dem take di king dead body komot for di tree. Dem trow am put for di town gate kon pak stone on-top am (na so e bi till today).
Renew Kovenant
30 Den Joshua build one altar for Israel God for Mount Ebal, 31 just as God savant Moses don kommand Israel pipol. As dem tok for di Law Book wey Moses rite, dem make am with stone wey dem nor kut or break or wey any iron don tosh. Dem burnt sakrifice for der kon do sakrifice for peace. 32 For Israel pipol present for der, Joshua kon rite Moses Law put for di stone. 33 Di pipol, rulers, leaders and judge dem stand for di two side for di box and for di Levi priests wey karry God Kovenant Box. Both Israel pipol and doz wey dey der as strenjas dey for di box front. Half of di pipol stand for Mount Gerizim front and di oda half stand for Mount Ebal front, just as God savant Moses kommand dem to do, before dem kollect di blessing.
34 Den Joshua read all di word for di law, plus di blessing and di curse, just as dem rite am for di Law Book. 35 Joshua read Moses kommand for all Israel pipol front, plus di wimen, shidren and strenjas wey dey stay with dem.