13
Jehoahaz Rule Israel
For di twenty three year wen King Joash, Ahazaya pikin dey rule Judah, Jehoahaz wey bi Jehu pikin kon bi king for Israel. E rule from Samaria for seventeen years. E nor obey God. E dey wiked like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin. God vex for Israel pipol kon make dem serve King Hazael for Siria and en son Ben-Hadad, for many years.
Jehoahaz kon tell God make E forgi-am and God ansa en prayer, bikos E si sey King Hazael really dey sofa Israel pipol. God diliver Israel pipol and dem kon dey free from Siria king. So Israel pipol kon dey live for peace. But just like Jeroboam family, dem nor gri turn from sin kon meet God. Dem even make Asherah juju for Samaria.
King Jehoahaz nor get any sojas, escept fifty men wey fit use horse, ten shariot and 10,000 sojas for groun. Siria king don kill and mash all en men like san-san.
Di remainin tins wey Jehoahaz do, plus all wetin e get, dem rite dem for Israel kings history book. Jehoahaz die and dem beri am for Samaria. En pikin Jehoash kon take-ova as king.
Jehoash Rule Israel
10 For di thirty-seven year wey King Joash dey rule Judah, Jehoahaz pikin, Jehoash kon bi king for Israel. E rule from Samaria for sixteen years. 11 E nor obey God kommand. E bad like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.
12 Di remainin tins wey Jehoash do, plus all wetin e get, dem rite am for Israel kings history book. 13 Jehoash die and Jeroboam kon take-ova as king. Dem beri am with di kings for Samaria.
Elisha Profesai Again
14 Wen Elisha dey sick di sickness wey finally kill-am, Jehoash wey bi Israel king go visit am kon dey kry for en front sey, “My papa! My papa! Di shariot and soja for Israel!”
15 Elisha tell am, “Make yu go take bow and arrow.” So e take bow and arrow. 16 Den Elisha tell Israel king, “Target with di bow.” Di king kon do am. Den Elisha put en hand on-top di king hand 17 kon sey, “Make yu open di window face east.” So di king do as di profet tell am. Elisha kon sey, “Make yu shot!” So di king kon shot. Elisha tell am again, “Dis arrow mean di viktory wey God won give yu ova Siria king and en pipol. Yu go distroy Siria for Afek!”
18 Den Elisha sey, “Take di arrow!” So di king take am. E tell di king, “Nak di groun with am!” Di king nak di groun three times kon stop. 19 Di profet vex kon tell di king, “If to sey yu nak di groun rish five or six times, yu for distroy Siria finish! But naw, na only three times yu go win Siria.”
20 So Elisha die and dem kon beri am. But as anoda year dey start, Moab pipol kon attack di land. 21 One day, some men dey beri pesin wen dem si some pipol dey kom attack dem. So dem kon trow di dead body inside Elisha grave. As di dead body tosh Elisha bone, di man wey don die kon wake-up.
22 So, thru-out di time wen Jehoahaz dey rule Israel, King Hazael for Siria dey opress dem. 23 But God look Israel pipol kon sorry for dem. God help dem, bikos of di promise wey E make with Abraham, Isaak and Jakob. Till today, E nor like to distroy or remove dem from en present.
24 Wen King Hazael for Siria die, en pikin Ben-Hadad kon take-ova as king. 25 Jehoash wey bi Jehoahaz pikin kon kollect all di land wey Ben-Hadad papa, Hazael, don take from en papa hand for war. Jehoash win three times kon kollect all di land and towns wey bi Israel pipol own.