12
For di sevent year wen Jehu dey rule, Jehoash kon bi king; e rule Judah for forty years from Jerusalem. En mama na Zibaya wey kom from Beersheba. Thru-out di time wey Jehoash dey rule, e do as God kommand, just as Priest Jehoiada tish am. But e nor skata di juju place dem; so di pipol still dey go offa sakrifice and burn incense for der.
Jehoash tell di priests, “All di silva wey dey God Temple, di ones wey dem kollect wen dem dey kount di pipol, all di silva wey dem kollect as vow and di ones wey pipol just drop on dia own, make una use dem ripair di Temple. Make una kollect di money from doz wey dey keep am kon ripair anywhere wey spoil for di Temple.”
For di twenty-three years wen Jehoash don bi king, di priests neva still ripair where spoil for di Temple. So King Jehoash koll Jehoiada with oda priests kon sey, “Wetin make una neva ripair where spoil for di Temple? Naw, make una nor take any money again escept una won use am ripair di Temple.” Di priests dem gri sey dem nor go kollect money from di pipol, so dat nobody go akuiz dem sey dem nor ripair di Temple.
But Jehoiada take one box kon kut hole put for en top and put am for di rite side for di altar where dem dey pass enter God house. Den di priest wey dey di temple gate, go pak and put all di money inside di box. 10 Wen dem si sey di box don full, di royal seketry and di High Priest go kount and keep di money. 11 Den dem give di money to di pesin wey dey ripair di Temple. Dem hire karpenters and builders wey go work for di Temple, 12 plus brick-laya and doz wey dey kut stone. Dem bring wood and chisel wey dem go take ripair di part wey spoil for di Temple kon pay for evry oda tin.
13 Di money wey dem bring kom God Temple, dem nor use am for silva bowl, wetin dem take dey burn incense, basins, trumpets or anytin wey bi gold or silva. 14 Dem give di money to di workers wey go ripair God Temple. 15 Di pesin wey dey pay di workers, dem nor ask am how e take dey spend di money, bikos dem trust and bilive am. 16 (Di money wey dem kollect, plus di ripair and sin ofrins, dem nor bring dem kom God Temple, bikos na di priests own.)
17 For dat time, King Hazael for Siria kon attack and seize Gat. Hazael still attack Jerusalem. 18 King Jehoash for Judah kollect all di holy tins wey en grand-grand papa Jehoshafat, Jehoram and King Ahazaya keep for di Temple for Judah, plus di holy tins wey en ensef keep and all di gold wey dey for God Temple and di king palis kon send dem go give King Hazael for Siria, so dat e nor go kom attack Jerusalem again.
19 Di remainin tins wey Jehoash do, plus all wetin e get, dem rite dem for Judah kings history book. 20 En ofisas plan kon kill-am for Bet-Millo for di road wey face Silla. 21 Di pipol wey kill-am na Jozaka, wey Shimeat born and Jehozabad wey bi Shoma pikin. Dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin, Amazaya kon take-ova as king.