18
Hezekaya Rule Judah
For di third year wen King Hoshea, Elah pikin dey rule for Israel, Ahaz pikin, Hezekaya kon bi king for Judah. E bi twenty-five years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for twenty-nine years. En mama name na Abi wey bi Zekaraya pikin. E obey God, just like en grand-grand papa David. E distroy di high place dem with dia juju, shrine and Asherah juju. E still distroy di bronze snake wey Moses make, bikos till dat time, Israel pipol still dey offa sakrifice gi-am. Dem dey koll am, “Nehushtan.”
E trust di Oga wey bi Israel God; so e nor get any king like am wey don rule Judah before or wey go rule Judah again. E dey loyal to God and e always dey follow en kommand. E obey all di kommandment wey God give Moses. God dey with am, so evritin wey e dey do, dey prosper. E fight against Assyria pipol and e nor fear dem. E win Filistia pipol for Gaza and di aria wey dey near der; rite from dia gate go rish di towns wey dem guide well-well for der.
For di fourt year wen King Hezekaya dey rule (dat na seven years wey Elah pikin, King Hoshea don dey rule for Israel), King Shalmanesa for Assyria go fight Samaria kon surround di town. 10 Afta three years, e kon seize Samaria (dat na di six years wey Hezekaya don dey rule) and na nine years wey King Hoshea don dey rule for Israel. 11 Assyria king kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) for Medes town. 12 Dis tin happen, bikos Israel pipol sin against di Oga wey bi dia God kon break di agriment wey dem make. Dem nor gri listin or obey evritin wey God kommand dem thru Moses, en savant.
Sennakerib Attack Judah
13 For fourteen years wen King Hezekaya dey rule, King Sennakerib for Assyria attack all di towns wey dem guide well-well for Judah kon seize dem. 14 King Hezekaya for Judah send message go meet Assyria king for Lakish sey, “I know sey I don go against awa agriment. If yu leave us, anytin wey yu sey make wi do, I go do am.” So Assyria king kon ask for three hundred silva and thirty golds from King Hezekaya. 15 King Hezekaya gi-am all di silva wey dey God Temple and for di palis.
16 For dat time, King Hezekaya for Judah, komot all di iron wey dem take make God Temple door kon give dem to Assyria king.
17 Assyria king send en sojas oga, di kourt oga and di adviser with many sojas from Lakish go meet King Hezekaya for Jerusalem. Wen dem rish der, dem kon go stand near di wota wey dey for di road wey dem dey pass go di field where dem for dey wosh and dry klot. 18 Dem sey make dem go koll di king kom, so Hilkaya pikin, Eliakim wey dey guide di palis, with Shebna wey dey rite wetin dey happen for di palis and Joah pikin Asaf wey bi di palis seketry kon go meet dem.
19 Di shief adviser kon tell dem, “Make una tell Hezekaya sey:
‘Di great king for Assyria sey: Wetin dey give yu strong mind? 20 To dey boast sey yu don plan well to fight mi, nor mean anytin. Na who dey give yu mind sey yu fit fight mi? 21 Si, yu really dey bilive sey Egypt pipol go kom help yu? Egypt wey bi like shuku-shuku; if pesin won rest put, e go wound di pesin hand. Dat na wetin King Fero for Egypt dey do to evribody wey dey trust am. 22 May bi yu go tell mi sey, “Wi dey trust di Oga awa God.” But na Hezekaya skata en high place, distroy en altars kon tell Judah and Jerusalem pipol sey, “Una must dey woship for only dis altar for Jerusalem.”
23 So, make yu follow my oga di king for Assyria enter agriment and e go give yu 2,000 horse as long as yu go fit find men wey go ride dem. 24 True-true, yu nor go sey no to even di smallest ofisas wey my masta get, bikos yu bilive sey Egypt pipol go kom help yu. 25 I wont make yu know sey na as God kommand, I go take mash kon distroy dis place, bikos God sey, “Make yu mash go distroy dis land.” ’ ”
26 Eliakim pikin Hilkaya, Shebna and Joah kon ansa di adviser sey, “Make yu use Aramaik language take tok to yor savant, bikos wi undastand am. Nor tok to us with Hibru bikos of di pipol.”
27 But di shief adviser ansa, “My masta nor send mi sey make I kon tok dis message to only una and una oga. Dis message na for di pipol too wey sidan for di wall, bikos dem go chop dia own shit kon drink dia piss.”
28 Di shief adviser kon from der shaut with Hibru language, “Make una listin to di message wey di great king for Assyria sey make I tell una. 29 Dis na wetin di king tok: Make una nor let Hezekaya deceive una, bikos e nor go fit save una from my hand! 30 Make una nor let Hezekaya tell una sey, ‘Make una trust God, bikos E go save us; so Assyria king nor go fit do us anytin.’
31 “Make una nor listin to Hezekaya! Bikos Assyria king sey, ‘Make una rite leta kom sey una go respet am and do anytin wey e tok. Den each of una fit chop from di vine and fig kon drink wota from well, 32 until e go kom take una go one land wey bi like una own. Land wey food and wine full, where bread and vineyard dey; betta land wey get olive tree and honey. Den una go live and e nor go kill una.’
“So make una nor listin to Hezekaya, bikos e dey deceive una wen e sey, ‘God go save us.’ 33 E get any god for di oda kountry wey don save en pipol from Assyria king pawa? 34 Where di gods wey dey Hamat and Arpad? Where di gods wey dey Sefarvaim, Hena and Ivvah? True-true, una tink sey any god fit save Samaria from my pawa? 35 Among all di gods for di land, na wish one don fit save en pipol and land from my pawa? So how God won kon take save Jerusalem and en pipol from my hand?”
36 Di pipol kwayet and dem nor tok, bikos di king don tell dem sey, “Make nobody ansa.”
37 Eliakim pikin Hilkaya, Shebna and Asaf pikin Joah kon tear dia klot go meet and tell Hezekaya wetin di shief adviser tok.