19
Wen King Hezekaya hear wetin dem tok, en too tear en klot kon wear sak go God Temple. E send Eliakim, Shebna and di priest oga with di sak klot wey dem wear sey make dem go meet Profet Isaya, Amos pikin, sey: “Dis na wetin Hezekaya tok: ‘Today na bad day, bikos na curse and trobol full am. E just bi like wen woman wey get belle won born, but e nor get pawa to push di pikin out. May bi di Oga yor God go hear all di tins wey di shief adviser sey Assyria king sey make e tok against God wey dey alive. Wen di Oga yor God hear, may bi E go ponish Assyria king for all di tins wey e tok. So make yu pray to God for awa pipol wey remain.’ ”
Wen Isaya hear King Hezekaya message, e kon sey, “Make una go tell di king sey: ‘God sey make yu nor let Assyria king treaten yu sey, en wey bi God nor go fit save yu. God go put one kind spirit for inside am wey go make am hear rumor, den e go-go back to en own kountry, den God go kill-am for der.’ ”
Wen di shief adviser hear sey Assyria king don komot from Lakish go fight for Libnah; e kon go der go meet am.
Di king hear sey, King Tirhakah for Ethiopia dey mash kon fight am. E kon still send message go meet Hezekaya sey: 10 “Make una tell King Hezekaya for Judah sey: ‘Make yu nor let di God wey yu trust fail yu wen E sey, “Assyria king nor go fit seize Jerusalem.” 11 True-true yu don hear wetin Assyria king do to di oda lands. Yu tink sey God go save yu? 12 Where di kountries wey my grand-grand papa dem distroy. Where Gozan, Haran, Rezef and di pipol for Eden for Telassar? Dia gods save dem? 13 Where di kings for Hamat, Arpad, Lair, Sefarvaim, Hena and Ivvah?’ ”
14 Hezekaya take di leta from di messenja kon read am, den e go God Temple kon spread am on-top di altar. 15 Hezekaya pray to God kon sey: “Oga wey bi Israel God, na Yu bi king among di creatures wey get feadas! Na only Yu bi God ova all di kingdoms for dis eart. Na Yu make di sky and di eart. 16 My God, make Yu listin well-well! Make Yu open yor eye si tins for yorsef! Listin to di message wey Sennakerib send kom and as e curse Yu wey dey alive!
17 “My God, na true sey, Assyria king don distroy all di kountries and dia lands. 18 Dem don burn di gods for di oda kountries, bikos dem nor really bi god, bikos na human being make dem with dia hand from wood and stone. Dat na why Assyria king fit distroy dem. 19 Naw, my Oga God, make Yu save us with yor pawa, so dat all di kingdoms for dis eart go know sey na Yu bi Oga and di only God wey nor dey die.”
20 Amos pikin, Profet Isaya kon send message go meet King Hezekaya sey, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok: ‘I don hear yor prayers about King Sennakerib for Assyria. 21 And dis na wetin I tok about am:
“ ‘ “Zion dota wey neva sleep with anybody before,
dey curse and laf yu;
Jerusalem dota
dey shake head follow yu.
22 Na who yu dey trobol and curse like dis?
Na who yu dey shaut for and look with bad eye?
Na di Holy One for Israel?
23 Yu send yor messenja make e kon boast for mi sey,
yu use yor shariot and men take
konker di highest mountin for Lebanon.
Yu dey boast sey yu don kut di tall cedars
and all di betta trees.
And di part wey deep pass for di forest,
yu boast sey yu don rish der.
24 Yu dey boast sey yu dig well kon drink wota from strenjas land
and yor sojas use dia leg take dry River Nile for Egypt.
25 Dem nor tell yu sey
na mi plan all dis tins before dem happen?
I don do as I plan dem.
Na mi give yu pawa to turn towns wey dem guide well-well,
to where dem dey trowey dirty put.
26 Di pipol wey dey for doz land nor get pawa
and fear won kill dem trowey.
Dem bi like grass wey dey field
or plant wey dey grow on-top roof,
but wen strong sun kom out,
dem go die.
27 But I know evritin about yu;
both di tins wey yu dey do
and di place where yu dey go.
I know how yu dey plan against mi.
28 I don hear evritin about yor plan for mi
and yor pride.
From naw go, I go put hook for yor nose
kon klose yor mout,
den take yu go back thru di same road wey yu take kom.” ’ ”
29 Den Isaya kon tell King Hezekaya, “Dis na sign of wetin go happen.
“ ‘For dis year and next year,
yu go chop only food wey just grow on en own,
but as from di oda year,
yu fit chop from di tins wey yu plant.
30 Doz wey remain for Judah go prosper like plant wey en rut enter groun
kon dey produce betta fruit.
31 For Mount Zion and Jerusalem,
pipol go dey save,
bikos God sey dis tins must happen.’
32 “So dis na wetin God tok about Assyria king:
“ ‘E nor go enter di town
or shot one arrow against am.
No soja go kom near di wall
and nobody go build kamp near di town.
33 Assyria king go-go back as e take kom.
E nor go enter dis town at-all.
Mi, wey bi God, don tok.
34 Bikos of my own honor
and di promise wey I make to my savant David,
I go defend and protet dis town.’ ”
35 For dat nite, God send en angel go kill 185,000 sojas for Assyria kamp. Wen day break, all of dem don die. 36 So King Sennakerib for Assyria run komot from di kamp. E go en house kon stay for Nineveh.
37 One day as e dey woship en god for Nisrok temple, en sons, Adrammelek and Shareza kon kill-am with dia swod, den dem run go Ararat land. Sennakerib pikin, Esarhaddon kon take-ova as king.