23
Josaya Distroy Di Juju For Israel
King Josaya gada all di leaders for Judah and Jerusalem togeda kon go God Temple and all di pipol for Judah, doz for Jerusalem, di priests and di profets kon follow am. All di pipol dey der, both small pikin, yong men and old pipol. E read di kovenant wey dey di book wey dem si for di temple. Di king stand near di pila kon promise to obey di kovenant wey dem make with God before. E promise to use en whole heart take obey God law, evry oda tin wey God tok and to do evritin wey dey di book. All di pipol agri to obey di kovenant too.
Di king kon orda Hilkaya wey bi di High Priest, di priest wey follow am and di guards sey, evritin wey dem take dey woship Baal and Asherah juju and all di stars wey dey God Temple, make dem bring am kom out. Di king burn dem outside Jerusalem for Kidron Valley kon karry dia ashes go Bethel. E kill all di priest wey nor know God wey Judah kings bin choose sey na dem go dey offa sakrifice for di high place for di towns for Judah and di arias around Jerusalem. (Dem dey offa sakrifice to Baal, di sun and moon; to di planets and all di stars for di sky.) E remove Asherah juju pole from God Temple kon burn am outside Jerusalem for Kidron Valley. E burn am to ashes kon trow am put for where dem for dey beri pipol. Di men ashawo house wey dey di temple and di place where wimen for dey weave for Asherah juju, e distroy dem.
E bring all di priests from Judah kon skata di high place where dem for dey offa sakrifice from Gibeah go rish Beersheba. E skata di high place dem for di goat juju wey dey di door-mot for Joshua gate wey bi di main town wey dey di left side. (For dis time, di priests for di high place dem nor go God altar for Jerusalem go serve am, but dem follow di oda priests chop from di bread wey nor get yist).
10 Di king skata Tofet for Ben-Hinnom Valley, so dat nobody go fit sakrifice en pikin for Molek juju again. 11 All di horse image wey di kings for Judah put for di temple gate to take woship di sun, di king skata all of dem. (Dem keep dem near Natan Melek; di lawyer room wey dey near di kourtyard.) Di king burn all di shariot wey dem take dey woship di sun.
12 Di altars wey Judah kings build for Ahaz room for up, plus di one wey Manasseh build for di two kourtyard for God Temple, di king burn all of dem kon trow dia ashes for Kidron Valley. 13 Di king skata all di high place for Jerusalem east and Distroshon Mountin for sout, wey King Solomon build for Sidon pipol juju, Astarte and Kemosh di ashawo juju for Moab pipol, plus Ammon pipol juju wey bi Milkom. 14 E skata dia juju pila finish kon kut Asherah juju pole rish groun, den e pak human being bones full di shrine.
15 E still skata di altar for Bethel and na Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin, build am. Den e burn all di high place to ashes kon distroy Asherah juju. 16 As King Josaya turn, e kon si di grave for di mountin, so e sey make dem bring di bones kom out. E burn dem for di altar kon skata di ashes. Dis tin happen, just as God tok thru en profet for di time wey King Jeroboam stand for di altar, wen dem dey do one feast. King Josaya turn kon si di grave of di profet wey tok dis tins.
17 E kon ask, “Wetin bi dis sign wey I dey si so?” Di men from di town kon ansa, “Di profet wey kom from Bethel kon tok about dis tin wey yu don do to Jeroboam grave and Bethel altar, na en grave bi dis.”
18 Di king kon sey, “Make una nor skata or tosh en grave! Make nobody disturb am at-all.” So dem leave di profet grave, plus all di oda profets for Israel wey dem beri for der.
19 King Josaya still distroy all di shrine for di high place for Samaria town. Na Israel kings build dem and dem dey make God vex. As e take distroy di altar for Bethel, na so too e distroy all dis ones. 20 All di priests for di high place, e sakrifice dem for di altars wey dey der kon burn human being bones for der. Den e go back to Jerusalem.
21 Di king kommand di pipol, “Make una dey obey di Oga una God Passova, just as E dey dis kovenant book.” 22 E tok like dis bikos, dem neva celebrate Passova afta di time wey judge rule di kountry. Since dat time, no king for Israel or Judah don celebrate am. 23 But for eighteen years wen King Josaya dey rule, dem kon celebrate God Passova for Jerusalem.
24 King Josaya still distroy all di pit from where dem for dey koll evil spirit kom out. Di pipol wey dey do majik; dia juju for house; di yeye image and all di juju wey dey for Judah and Jerusalem land, e distroy dem too. Like dis, e kon do all di tins wey dem rite for di book wey Priest Hilkaya si for di temple. 25 E nor get any king before or afta wey turn kom meet God like King Josaya wey use en whole heart take serve God, just as Moses Law tok.
26 Plus all dis ones, God still dey vex for Judah, bikos of all di wiked tins wey Manasseh do. 27 God sey, “Just as I komot Israel from my eye, na so too I go komot Judah pipol. I go rijet dis town wey I choose, both Jerusalem and di temple wey I sey, ‘I go stay.’ ”
28 Di remainin tins wey Josaya do plus evritin wey e get, dem rite am put for Judah kings history book.
29 Wen King Josaya still dey rule, Fero Neko wey bi Egypt king with en men kon go River Eufrates go support Assyria king for war. King Josaya and en men go fight dem, but wen King Neko si am for Megiddo, e kon kill-am. 30 King Josaya savant karry en oga dead body from Megiddo on-top horse go back to Jerusalem for where dem for beri am for en grave. Di pipol for di land take Josaya pikin, Jehoahaz, pour olive oil for en head kon make am king for Judah.
Jehoahaz Rule Judah
31 Jehoahaz na twenty-three years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for three monts. En mama name na Hamutal wey bi Jeremaya from Libnah, pikin. 32 E nor gri follow God kommand, just like en grand-grand papa dem. 33 Fero Neko katch am put for prison for Riblah wey dey Hamat land, so dat e nor go fit rule Jerusalem pipol. Neko sey make di pipol for di land pay am 7,500 pound for silva and 75 pound for gold. 34 Fero Neko make Josaya pikin Eliakim king kon shange en name to Jehoiakim. E take Jehoahaz go Egypt where e for die. 35 Jehoiakim dey give Fero di normal amount wey e sey make dem dey gi-am. But to make sure sey e meet dis payment, e kon dey tax di pipol for di land. E dey kollect plenty money from each pesin, so dat e go fit pay Fero Neko.
Jehoiakim Rule Judah
36 Jehoiakim na twenty-five years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for eleven years. En mama na Zebidah wey bi Pedaaya from Rumah pikin. 37 E nor gri obey God, just like en grand-grand papa dem.