22
Josaya Rule Judah Well
Josaya na eight years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for thirty-one years. En mama name na Jedidah wey bi Adaya wey kom from Bozgat, pikin. E do wetin God kommand kon dey work like David, en grand-grand papa. E nor do bad tins at-all.
For eighteen years wen King Josaya dey rule, di kourt seketry Shafan wey bi Azalaya pikin and Meshullam grand-pikin, go God Temple kon sey: “Make yu go meet Hilkaya, di High Priest sey make e kount di money wey God pipol bring kom give di guards for di temple. Tell dem make dem give and pay di men wey dey ripair God Temple, with doz wey dey build and do oda tins. Make dem still buy wood and chisel stone wey dem go use take ripair am. Nor sey make di men kon tell yu as dem take use di money, bikos dem use am well.”
Hilkaya wey bi di High Priest kon tell Shafan di kourt seketry sey, “I don si di Law Book for God Temple.” Hilkaya give di book to Shafan and e read am. Shafan go meet di king kon tell am, “Yor savant don gada di money for di temple kon give di men wey won ripair di Temple.” 10 E still tell di king, “Priest Hilkaya give mi one book.” Den Shafan read di book for di king.
11 Wen di king hear di laws wey dey di book, e kon tear en klot. 12 Di king kon orda Priest Hilkaya, Shafan pikin Ahikam, Mikaya pikin Akbor, Shafan wey bi di kourt seketry and Asaya wey bi di king savant sey, 13 “Make una go meet and ask God for mi and Judah pipol. Make una find out wetin di words for di book mean. God don dey vex for us, bikos awa grand-grand papa nor gri obey wetin dey dis book at-all.”
14 So Priest Hilkaya, Ahikam, Akbor, Shafan and Asaya kon go meet Profetes Hulda wey bi Shullam wife. Shullam papa na Tikvah and na Harhas wey dey kare for di wardrobe bi en grand-papa. (Di woman dey stay for Mishneh aria for Jerusalem.)
Dem go meet am kon tell am wetin make dem kom, 15 so di woman sey: “Make yu tell di man wey send yu kom meet mi sey, ‘God sey: 16 “I won kause wahala for dis place and for doz wey dey stay here. Wetin I go do, dey for di book wey Judah king don read. 17 Dis tins go happen, bikos dem don forget mi kon dey offa sakrifice give oda gods and dem dey make mi vex, bikos of di juju wey dem make with dia hand. Una go feel my vexnashon for dis place and una nor go fit stop am.” ’ 18 Make una tell Judah king wey send una kom ask from God sey: ‘Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok about di word wey yu hear: 19 “Yu show sey yu dey sorry for di bad tins wey una do kon respet God wen yu hear how I won use dis place and di pipol wey dey stay here, as strong ezample for pipol wey dem curse.” ’ God sey, ‘Yu tear yor klot kon kry for my present and I don hear yu. 20 So I go let yu die first and dem go beri yu well.’ ”
So, dem kon go tell di king evritin wey di profetes tok.