3
Moab And Israel Pipol
Ahab pikin, Joram kon bi king for Israel and e rule from Samaria for twelf years and dat na di eighteen year wey Jehoshafat dey rule for Judah. Even doh e nor gri follow God kommand, e nor bi like en papa and mama, bikos e skata di Baal juju wey en papa make. But just like Jeroboam, Nebat pikin wey bi king before am, e still kontinue to lead and enkourage Israel pipol to sin.
King Mesha for Moab dey barb sheep hair and e dey always give Israel king 100,000 lamb and 100,000 rams wool, but wen King Ahab die, Moab king kon go fight with Israel king. So King Joram mash from Samaria go gada Israel sojas togeda. Den e send message go meet King Jehoshafat for Judah sey: “Moab king sey en won fight mi. Yu go follow mi go fight am?”
King Jehoshafat ansa, “Okay! I go follow yu, bikos as yu bi, na so I bi too. My pipol na yor pipol and my horse dem na yor own too.”
Den e ask am, “Na where wi go pass go.”
King Joram ansa, “Wi go pass thru Edom Wildaness.”
So Israel, Judah and Edom kings kon dey go fight. Afta dem don waka anyhow for seven days, dia sojas and animals nor kon get wota to drink again.
10 Den Israel king sey, “True-true, na God bring us kom here so dat Moab King and en pipol go kill us.”
11 But King Jehoshafat ask, “Wi nor get any profet among us for here? Make e help us find out from God.”
One of Israel king savant kon ansa, “Shafat pikin, Elisha wey bin dey pour wota for Elijah hand, dey here.”
12 King Jehoshafat kon sey, “True-true, God dey tok thru am.” So di three kings kon go meet am.
13 Elisha kon ask Israel king, “Wetin mi and yu get togeda? Make yu go meet yor papa and mama profets.”
But Israel king ansa, “Nor tok like dat, bikos na God bring dis three kings togeda make Moab king and en pipol for kill us.”
14 Elisha kon sey, “As long as di God of all gods dey alive and as I stand for en present, if nor bi sey I dey respet King Jehoshafat, I nor for even look yor face. 15 But naw, make una bring one pesin wey sabi sing kom.”
Wen di pesin dey sing, God spirit kon enter Elisha 16 and e sey, “Dis na wetin God dey tok, ‘Make una dig gutta for di wildaness; 17 even doh una nor go si breeze or rain, wota go full di wildaness and una with una animals go drink beleful.’ ” 18 Elisha still sey, “Dis tin dey eazy for God eye. E go give Moab and en pipol to una. 19 Den una must skata and distroy evry strong town for der. Evry good tree for der, una must kut am down kon stop and klose where wota from dey flow. All di betta land for der, una go skata dem with stones.”
20 Di next morning, around di time wen dem won offa di meat ofrin, wota flow kom from Edom kon full di land.
21 So, wen Moab pipol hear sey di kings dey kom fight dem, dem gada evribody wey fit wear soja uniform, both small and big kon go stand for di borda. 22 Wen dem wake-up di next morning, di sun dey shine on-top di wota and Moab pipol for di oda side si am kon sey di wota red like blood. 23 Dem kon sey, “Dis na blood o-o! Di kings don fight and kill each oda, so make wi go pak and take evritin wey dey dia kamp.”
24 But wen dem rish Israel kamp, Israel pipol kill dem well-well and di remainin ones kon dey run; but Israel pipol porshu and kill dem as dem dey run. 25 Dem distroy di town and each of dem kover all di good land wey dey der, with stones. Dem stop di place where wota for dey flow kon kut all di betta trees for der. Dem distroy evriwhere escept Kir-Heres wey bi di main town. Den di men wey karry katapault kon attack and distroy am.
26 Wen Moab king si sey di war too strong for am, e take 700 men follow body, so dat dem go fit eskape go meet Siria king, but e nor fit. 27 So e take en first son wey go bi king afta am kon kill-am as ofrin for God. Fear kon katch Israel pipol well-well, so dem kon go back to dia land.