4
Elisha And One Woman
One day, one woman wey en husband bi profet before e die kon kry go meet Elisha sey, “Yor savant my husband don die. Yu know sey yor savant dey follow God kommand. Naw, doz wey e dey owe money before e die, won kom take my two sons as slave.”
Elisha ask di woman, “Wetin yu wont make I do for yu?” Make yu tell mi, “Wetin yu get for yor house?”
Di woman ansa, “Yor savant nor get anytin escept one small oil.”
Den Elisha tell am, “Make yu go borrow plenty empty gallon kom. Afta yu don borrow dem, make yu enter house kon lock yor door, den pour di oil put for all di gallons and wons one full, put am for korna.”
So di woman leave am kon lock en and en sons wey bring di gallon, for inside dia house. Den e bigin pour di oil put for inside di gallons. Wen dem don full, e kon tell en sons, “Make una bring anoda gallon kom.”
But di boys ansa, “All of dem don full.” So di oil kon stop to pour kom out.
Den di woman go tell Elisha wetin happen and Elisha sey, “Go sell di oil, use di money take pay yor debt, den make yu and yor sons sell di rest kon use di money take buy food make una chop.”
Elisha And Di Woman From Shunem
One day, Elisha go Shunem, where one woman wey get money dey stay. Di woman kon sey make Elisha kom chop for en house, so wen ever Profet Elisha dey go Shunem, e go stop chop for der. Den di woman tell en husband, “My mind dey tell mi sey, dis man wey dey always pass and kom here, na God profet e bi, 10 so make wi make one small room for up kon put bed, tabol, chair and lantan for der, so dat wen ever e kom, e go stay here with us.”
11 So one day, Elisha kom visit dem; den e go rest for di room for up. 12 E kon tell en savant Gehazi, “Make yu go koll di woman kom.” So di savant do as e tell am and di woman kon follow am kom. 13 Elisha tell Gehazi, “Make yu tell di woman, ‘Yu do well as yu dey kare for us, so wetin yu wont make wi do for yu? Abi yu wont make I go tell di king and en sojas oga sey yu bi good pesin?’ ”
Di woman ansa, “I get evritin wey I wont, as I dey stay among my pipol.”
14 So Elisha tell Gehazi, “So na wetin yu wont make I do for am?” Gehazi ansa, “Dis woman nor get pikin and en husband don old.”
15 Elisha kon sey, “Make yu koll am kom.” So Gehazi koll am and di woman kon stand for di door-mot. 16 Den Elisha tell am, “For dis same time next year, yu go karry yor son for yor hand.”
Den di woman ansa, “No o-o! My oga! Yu bi God profet, so make yu nor deceive mi yor savant.”
17 Just as Elisha don promise am, di woman get belle kon born for di time wey Elisha tok.
18 Di pikin kon dey grow well-well. One day, e follow en papa go farm, 19 den e kon dey kry give en papa sey, “My head! My head dey pain mi!”
Den en papa tell en savant, “Make yu karry am go meet en mama.” 20 So, di savant karry am go meet en mama. Di pikin sidan for di mama leg till aftanoon, den e kon die. 21 So di woman karry di pikin dead body go put for Elisha bed for up kon komot der.
22 E koll en husband kon sey, “Abeg make yu send one among yor savant and one donkey kom, so dat I go kwik rush go meet di profet kon kom back.”
23 But di husband ask, “Wetin make yu wont go si am today? Today nor bi new moon or Sabat Day.”
But di woman ansa, “Evritin dey okay.”
24 Den e enter di donkey kon tell en savant, “Make yu drive fast as yu fit drive rish, unless I sey make yu slow.” 25 So di woman drive go meet Profet Elisha for Mount Karmel.
Wen Elisha si di woman from far, e kon tell en savant Gehazi, “Si, na dat Shunem woman dey kom so. 26 Make yu run go meet am kon ask am, ‘Evritin dey okay? Yor husband dey okay? Wot about yor pikin, e dey okay?’ ” Wen di savant run go meet and ask am, di woman ansa am, “Evritin dey okay.”
27 Wen di woman waka meet di profet on-top di mountin, e kon fall hold am for leg. Gehazi won kon porshu am komot, but di profet sey, “Leave am, dis woman dey pass thru pain and God nor let mi know before naw.”
28 Den di woman sey, “My oga, na mi ask yu for pikin? I know tell yu sey, ‘Make yu nor deceive mi.’ ”
29 So Elisha kon tell Gehazi, “Tie yor garment well make yu follow dis woman with my walkin stik. If yu meet anybody for road, make yu nor greet am and if anybody greet yu, make yu nor ansa. Den if yu rish here, take my walkin stik take tosh di pikin.”
30 Den di pikin mama sey, “As long as God and yu dey alive, I nor go-go without yu.” So Elisha kon follow di woman go.
31 Gehazi don dey go for dia front. E put di walkin stik on-top di pikin face, but di boy nor even shake body, so e kon go back go tell Elisha, “Di boy nor wake-up o-o.”
32 Wen Elisha rish di house, e kon si di boy dead body for en bed. 33 So e enter inside di room, klose di door kon pray to God. 34 Den e stand up kon go sleep on-top di dead body. E use en own mout take kover di boy mout, en eye for di boy eye and e hold di boy hand tie, den e stresh ensef on-top di boy and di pikin body kon warm. 35 Den Elisha get up kon dey waka up-and-down for di house. E waka go meet di pikin kon sleep on-top am again, den di boy kough seven times kon open en eye.
36 Elisha koll Gehazi kon sey, “Make yu go koll di Shunem woman kom.” So Gehazi go koll di woman. Elisha tell am, “Make yu go karry yor pikin.” 37 Di woman bow kon use en face tosh groun for Elisha front, den e karry en pikin kon waka komot.
Bad Food
38 Elisha go Gilgal and betta honga dey di land. Di profets sons sidan round am. E kon tell en savant, “Make yu put big pot for fire kon make food for dis pipol.”
39 So, one among dem enter di field go gada leaf and vine wey e go take kook. Wen e kom back, e kut dem put for di stew, but dem nor know wetin dem dey do or wish kind leaf e bi. 40 Dem serve some give di men make dem chop, but as dem chop di stew, dem kon shaut dey sey, “Profet! Dis pot of stew go kill us o-o!” So dem nor fit chop am.
41 Den Elisha sey, “Make una give mi some flower.” E pour di flower inside di pot kon sey, “Serve some give di men make dem chop.” So di food kon dey good to chop.
Elisha Feed Hundred Pipol
42 Naw, e get one man from Baal-Shalishah wey bring en first food kon give Elisha. Di bread na twenty. Elisha kon sey, “Make yu gi-am to di pipol make dem chop.”
43 But Elisha savant sey, “Make I give twenty bread to dis hundred men?”
Elisha ansa, “Give am to di pipol make dem chop, bikos God sey, ‘Dem go chop taya and di food go remain.’ ” 44 So e give di pipol and just as God tok, dem chop beleful and some still remain.