5
Elisha Cure Naaman
E get one man wey en name na Naaman and na-im bi Siria sojas oga. Siria king like and dey respet am well-well, bikos thru am, God don make Siria pipol win many war. Naaman sabi fight well-well, but e get one kind diziz for body.
So, wen Siria sojas go fight war for Israel, dem katch one small girl kon gi-am to Naaman wife, as en savant. One day, di girl kon tell en madam, “If to sey my oga go gri go meet di profet for Samaria, e go fit cure am from dis diziz.”
So Naaman go tell di king wetin di Israel girl tok. Siria king kon sey, “Make yu go meet am and I go give yu leta wey yu go give Israel king.” So as Naaman dey go, e karry silva wey heavy rish 750 pounds; gold wey heavy rish 150 pound and ten difren klot. E take di leta go give Israel king wey sey: “Dis leta na to let yu know sey na mi send my savant, Naaman kom meet yu, so dat yu go heal am from en sickness.”
Wen Israel king read di leta, e tear en klot kon sey, “Na mi bi God wey get pawa to give and take life? Wetin make di king tink sey I go fit cure dis man? If yu tink am well-well, yu go si sey e dey find as e go take fight mi.”
Wen Elisha, God profet hear sey di king tear en klot, e kon send pipol go meet and tell di king, “Wetin make yu tear yor klot? Send am kom meet mi and e go know sey Israel really get betta profet wey God send kom.” So Naaman with all en men go meet and stand for Elisha door-mot. 10 Elisha sey make en savant go tell Naaman, “Make yu go wosh yorsef seven times for Jordan River, den yu go well.”
11 But Naaman vex waka komot dey sey, “I bin tink sey e go kom outside kom meet mi, den koll en God name and wave en hand for di diziz, so dat I go well. 12 Amanah and Farpar for Damaskus nor betta pass all di rivers for Israel? Why e nor send mi go one of dem, so dat I go well?” So Naaman vex komot from der.
13 Den en savants go tell am, “Awa oga! If to sey di profet sey make yu do one big tin, yu nor go rush go do am? So dis one wey e sey make yu do, nor hard at-all, just go wosh yor body, so dat yu go well.” 14 So Naaman go wosh ensef inside Jordan River seven times, just as God profet kommand am. Afta di sevent time, en skin kon smooth like small pikin own.
15 Den Naaman and all en men go back go meet and stand for di profet front kon sey, “True-true, I don know naw sey e nor get any God for dis eart escept Israel own! Abeg make yu take dis gift from yor savant.”
16 But Elisha ansa, “God Forbid! As long as di Oga God wey I dey serve dey alive, I nor go take anytin from yu.” Naaman beg am well-well, but e nor gri.
17 So Naaman sey, “Since yu nor gri take anytin, abeg make yu give us two donkey wey wi go use take pak una san go awa land, bikos I nor go ever offa any ofrin give any oda god escept yor God. 18 I pray make God forgive mi for dis tins: Wen my oga wey bi Siria king dey go woship en juju Rimmon for en temple, I go nid to follow am go, bikos na mi bi en rite-hand-man. But make God forgive mi even as I go bow to Rimmon for di temple.”
19 So Elisha tell am, “Make peace follow yu as yu dey go.”
Afta Naaman don travel small, 20 Gehazi wey bi Elisha savant kon tink for en mind, “Si, my masta nor gri take wetin Naaman bring kom. As far as God dey alive, I go run go meet am kon kollect some tins for mysef.”
21 So Gehazi porshu Naaman. Wen Naaman si sey pesin dey run kom meet am, e kom down from en horse kon ask, “Hope evritin dey okay?”
22 Gehazi ansa, “Yes! Evritin dey okay. Na my oga send mi kom meet yu sey, ‘Two of di profets savant just kom meet mi from Efraim hill kountry. So make yu give dem silva wey heavy rish seventy-five pounds and two difren klot.’ ”
23 So Naaman ansa, “Abeg make yu take silva wey heavy rish one hundred and fifty pounds.” E beg Gehazi well-well kon pak am inside two bags with two difren klot. Naaman give dis tins to two of en savant make dem karry am follow Gehazi. 24 Wen Gehazi rish di hill, e karry di gift from dem kon keep am for en house. Den e tell di men make dem dey go, so dem kon go.
25 Leta wen Gehazi go stand near en masta, Elisha kon ask am, “Gehazi, where yu go since?”
Gehazi ansa, “I nor go anywhere o-o.”
26 Elisha kon tell am, “My spirit dey der with yu wen di man kom down from en horse kon meet yu. Dis nor bi di rite time to kollect money, klot, olive oil, vineyard, animal or savants. 27 Bikos of dis tin wey yu do so, Naaman diziz go katch yu and yor shidren-shidren forever.” So wen Gehazi komot from Elisha front, di diziz kon katch am and en body kon dey white like snow.