7
Elisha ansa, “Make una hear God word, ‘By dis time tumoro, three kilogram for di best flower and six kilogram for barley, una go dey buy dem with one silva.’ ”
One of di king ofisas ansa, “Abeg. Dat nor fit happen! Even if God ensef dey drop food from heaven, e nor go fit happen!”
Elisha ansa, “Yu go si am dey happen, but yu nor go ever chop from am!”
Siria Sojas Run
Four men wey get diziz for body, sidan for di town gate. So dem tell demsef, “Wetin make us just sidan for here dey wait di time wey wi go die? If wi enter di town, hongry go kill us and if wi stay here, hongry go still kill us! So make wi go Siria sojas kamp. Di highest wey dem fit do, na to kill us, but may bi dem go fit still sorry for us.”
So, as day dey dark, dem kon go Siria sojas kamp, but wen dem rish der, dem nor si anybody, bikos God don make Siria sojas hear nois like sey many sojas with dia shariot dey kom fight dem. So Siria sojas tell demsef, “Si, Israel king don go hire Hit and Egypt kings with dia sojas, so dat dem go kom attack us.” So dat evening, Siria sojas run leave dia kamp, horse, donkey and evritin wey dem get for di kamp.
Wen di four men rish di kamp door-mot, dem enter di tent, chop and drink beleful kon kollect and go hide di silva, gold and klot wey dem si. Den, dem enter anoda tent kon do di same tin.
Den dem tell each oda, “Wi nor suppose to dey do like dis! Wi get betta news and wi must go tell awa pipol. If wi wait until tumoro morning before wi tok, di king go ponish us. So make wi go naw go tell di king ofisas!”
10 So dem go Samaria kon tell di guards wey dey di gate sey: “Wi go Siria sojas kamp and wi nor si anybody for der; dem run leave all dia horse and donkey and di tent bi as dem leave am.” 11 Di guards announce di news and dem kon go tell di king.
12 By dat time, day don dark well-well, but di king tell en ofisas, “I go tell una wetin Siria sojas dey plan! Dem know sey honga one kill us, so dem don leave dia kamp go hide, bikos dem dey hope sey, wi go leave awa town go find food for dia kamp, den dem go katch us alive kon konker dis town.”
13 One of di ofisas ansa, “Di pipol wey dey di town don taya already, bikos dem bi like pipol wey don already die. So make wi send some men with five horse from di ones wey remain for di town. (Even if dem kill dem, na di same tin go still happen to evribody wey dey Israel, bikos all of us go still die!) Make wi send dem go, so dat wi go really know wetin dey happen.”
14 So dem choose some men and di king kon send dem go with two shariot sey, “Make una go look wetin happen to Siria sojas.” 15 As di men dey travel go Jordan aria, na klot and swods wey Siria sojas drop as dem dey run, full di road. So dem go back kon tell di king wetin dem si. 16 Den Samaria pipol rush enter Siria kamp kon pak evritin wey dey der. And as God tok, three kilogram for di best flower or six kilogram for di best korn, dem kon dey sell am for one silva.
17 So Israel king put en own offisa as guide for di town gate. But di pipol mash am die for der, just as Elisha tell di savant wen di king kom meet am. 18 Elisha don tell di king before sey by dis time tumoro for Samaria gate, dem go dey sell three kilogram for di best flower and six kilogram for di best korn for one silva 19 and dat ofisas bin ansa sey, “E nor fit happen, even if God ensef go send korn kom naw-naw!” And Elisha tell am, “Yu go si am dey happen, but yu nor go ever chop from di food.” 20 And dat na wetin just happen to di man. Pipol mash am die for di town gate.