8
Elisha Help Di Shunem Woman Again
So Elisha advise di Shunem woman wey e wake en pikin from deat sey, “Make yu and yor family go stay for anoda place for sometaim, bikos God don sey honga go dey dis town for seven years.” So di woman do as di profet tell am. En and en family kon go stay for Filistia land for seven years.
Afta dat time, di woman kom back from Filistia kon go meet di king make e gi-am en house and land back. For dis time, di king tell Gehazi wey bi di profet savant sey, “Make yu tell mi all di wonderful tins wey Elisha don do.” As Gehazi dey tell di king how Elisha take wake pesin wey don die, di woman wey Elisha wake en pikin, waka kom ask di king about en house and lands.
So Gehazi sey, “My oga di king, dis na di woman and en son wey Elisha wake from deat!” Di king ask di woman weda di story na trut and di woman kon tell am evritin.
So di king tell one of en kourt ofisas sey make e kare for di woman, den e orda dem, “Make una give dis woman en house and land back, plus di money for evry fruit wey di land produce from di day wey e komot from dis town kom rish naw.”
Elisha Meet Hazael
Elisha travel go Damaskus wen King Ben-Hadad for Siria nor well. Dem kon tell di king, “Di profet don kom.” So di king tell Hazael, “Make yu take gift go give di profet. Tell am make e help yu ask God, ‘I go well from dis sickness at-all?’ ”
Den Hazael kon go visit Elisha. E karry gift and forty kamel wey full with all di fine-fine tins wey dey Jerusalem follow body. Wen e rish der, e stand for di profet front kon sey, “Na yor pikin, King Ben-Hadad for Siria send mi kom ask yu sey, ‘I go well from dis sickness at-all?’ ”
10 Elisha ansa, “Go tell am sey God don show mi sey e go really die, but dis sickness nor go kill-am.” 11 Elisha kon dey look Hazael one kind, sotey Hazael kon konfuse. Den di profet start to kry.
12 Hazael kon ask am, “My oga, wetin make yu dey kry?”
Elisha ansa, “Na bikos I know di kind trobol wey yu go kause for Israel pipol. Yu go burn dia propaty, kill dia yong men, distroy dia shidren and wimen wey get belle, yu go kut dia belle open.”
13 Hazael ansa, “How e won take happen, bikos I nor even betta rish dog?”
Elisha ansa, “God don show mi sey yu go bi Siria king.” 14 So Hazael leave Elisha kon go back to en house. King Ben-Hadad ask am, “Wetin Elisha tok?” Hazael ansa, “E sey yu go well again.” 15 Di next day Hazael take small klot, put am for wota kon use am dey tosh Ben-Hadad face until e die. Den Hazael kon bi Siria king.
Jehoram Rule For Judah
16 For di fift year wen Joram, Ahab pikin dey rule for Israel, Jehoshafat pikin Jehoram kon bi king for Judah. 17 E bi thirty-two years wen e start to rule and e rule for eight years for Jerusalem. 18 E rule as di oda kings for Israel, en wife na Ahab pikin and just like Ahab family, en too join for di wiked tins wey Israel king dey do. E sin against God, 19 but God nor won distroy Judah. E keep Judah, bikos of di promise wey E don make with David en savant.
20 Wen e dey rule, Edom pipol free demsef from Judah kon get dia own king. 21 King Jehoram cross go Zair with en men. Edom pipol surround and attack am for nite kon win en and en men, den Israel sojas run go back to dia land. 22 So till today, Edom pipol dey free from Judah hand. For dat time, Libnah pipol still kause wahala too.
23 Di remainin tins wey Jehoram do, plus evritin wey e build, dem rite dem for Judah kings history book. 24 Jehoram die and dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin Ahazaya kon take-ova as king.
Ahazaya Rule Judah
25 For di twelft year wey Ahab pikin, Joram dey rule Israel, Jehoram pikin, Ahazaya kon bi king for Judah. 26 Ahazaya na twenty-two years wen e start to rule and e rule Jerusalem for one year. En mama name na Atalaya wey bi King Omri for Israel grand-pikin. 27 Bikos Ahazaya na family memba to Ahab thru marriage, en too sin against God, just like Ahab family.
28 King Ahazaya join King Joram for Israel go fight King Hazael for Siria for Ramot for Gilead where Siria pipol for win and wound King Joram for di fight. 29 King Joram go back to Jezrel go trit ensef bikos of di wounds wey Siria sojas giv-am, wen e fight King Hazael. So King Ahazaya, Joram pikin kon go visit am.