12
Fear Only God
Plenty pipol gada around Jesus kon dey waka jam one anoda, so Jesus kon tell en disciples, “Make una shine una eye well-well, bikos of di Farisee pipol wey dey pritend. Anytin wey pipol hide naw, go kom out for publik and anytin wey dey sekret naw, God go bring am out. So anytin wey pesin do for darkness, go kom out for lite and anytin wey pesin tok for sekret, pipol go shaut am from on-top house.
“I tell una wey bi my friends, make una nor fear pipol wey fit kill pesin, but dem nor fit do pass dat. But make I tell una who una must fear: Make una fear di Pesin wey get pawa to trow una inside hell-fire afta E don kill una. Yes, I tell una true word, na-im una must fear! Nor bi two koins dem dey sell five sparo bird? But God nor dey forget any one among dem. Si, God know di nomba of hair wey dey una head. So make una nor fear, bikos una betta pass many sparo bird.
“I tell una true word, anybody wey stand up for publik sey en know mi, mi too go stand up for am for where God angels dey. But pesin wey rijet mi for where pipol dey, mi too go rijet am for where God angels dey. 10 And anybody wey tok bad about Man Pikin, God go fit forgi-am, but pesin wey tok bad about di Holy Spirit, God nor go forgi-am.
11 “Wen dem karry una go sinagog or go meet govnors and pipol wey get pawa to judge una kase, make una nor worry about how una go defend unasef or wetin una go tok, 12 bikos di Holy Spirit go tell una wetin to tok, wen dat time rish.”
Landlord Parabol
13 Den one pesin among di pipol kon sey, “Tisha, tell my broda make e divide di propaty wey awa papa die leave for us.”
14 But Jesus ask am, “My friend, na who make mi judge for una two matter?” 15 Den Jesus tell dem, “Make una guide against long-trot, bikos nor bi wetin pesin get for dis life go save am.”
16 So Jesus kon tell dem one parabol: “One rish man plok plenty food from en farm, 17 so e kon tink for en mind sey, ‘Wetin I go do naw? Bikos I nor get anywhere to keep all dis food wey I plok so.’
18 “Den di man sey, ‘I know wetin I go do: I go skata my stores kon build new big-big one wey I go keep all my food and oda tins wey I plok. 19 Den I go tell mysef, “Yu get plenty food wey go last yu for many years, so make yu go sleep, chop and drink, dey enjoy yorsef!” ’
20 “But God kon tell di man, ‘Yu bi fool! Dis nite, yu go die, den who go kon get all dis tins wey yu don gada for yorsef?’
21 “Na so e go bi with pesin wey dey gada money keep for ensef, but en heart nor dey with God.”
Make Una Nor Worry
22 Jesus tell en disciples, “Naw I dey tell una, make una nor worry about una life, wetin una go chop or klot wey una go wear for body. 23 Bikos life good pass food and awa body betta pass klot. 24 Make una tink how birds bi: Dem nor dey plant or plok, dem nor get where dem dey keep food put, but God dey give dem food chop. If God dey kare for dem, wot about una wey betta pass dem? 25 Wish of una go fit add one hour join en life, bikos e dey worry? 26 So, if una nor fit do dis simpol tin, why una dey worry about di odas?
27 “Make una tink of how flowers dey grow: Dem nor dey work or make klot for demsef. But I tell una true word, even Solomon for all di glory wey e get, nor dress fine rish flowers! 28 If God dey dress flowers wey dey today and pipol go kut am trow for fire tumoro, dat God nor go fit kare for una? Una faith small well-well o-o! 29 Make una nor dey worry about wetin una go chop or drink. 30 Na bikos of all dis tins, pipol wey nor know God dey worry demsef, but una Papa for heaven know sey una nid dem. 31 Instead, make una first struggol to enter God Kingdom and God go give una all di oda tins.
32 “Make una nor fear, una wey bi small sheep, bikos una Papa go happy to give una di kingdom. 33 Make una sell evritin wey una get and give di money to poor pipol. Bag wey nor go tear, make una take am gada betta tins for heaven, where tif nor go fit rish and siti-siti nor go fit spoil dem. 34 Bikos na where yor propaty dey, na der yor heart go dey too.
Savant Wey Get Faith
35 “Make una ready to serve God and make una lite dey shine evritime. 36 Make una bi like pipol wey dey wait for dia oga to kom back from party, so dat wen e nok, una go kwik open door for am. 37 Di savant wey en oga go kom back kon meet am dey work, make e happy well-well bikos di oga go prepare ensef make e for serve di savant food for tabol. 38 Make doz savant happy well-well, even if di oga kom for nine or three oklok for nite kon si sey dem neva sleep. 39 But make una know sey, if di owner of di house know wen tif dey kom, e nor go let di tif break enter en house. 40 Una must dey ready too, bikos Man Pikin go kom wen nobody dey espect am.”
41 Den Pita ask am, “Oga God, na only wi yu dey tell dis parabol, abi na evribody?”
42 Jesus ansa, “Who bi di manaja wey get sense and nor dey do wayo? Na pesin wey di oga put make e kare and give di oda savants dia food for di rite time? 43 Di savant wey en oga kom back kon meet am dey do en work, make e happy well-well. 44 I tell una true word, di oga go sey make e kare for all en propaty. 45 But if dat savant tink for en mind sey, ‘My oga go tey small and e bigin beat di oda savants, weda na man or woman; e kon dey chop, dey drink anyhow, 46 den di oga kon kom back for di day wen di savant nor tink sey e go kom. Di oga go ponish di savant kon lock am for where dem dey keep wiked pipol.’
47 “Di savant wey know wetin en oga wont and e nor do am, dem go flog am well-well. 48 But di savant wey nor know wetin en oga wont and e do tins wey go make dem flog am, dem go flog am small. Pesin wey God give plenty tins to, E go ask plenty tins from am and di ones wey God give plenty, E go ask doubol from dem.”
Jesus Word Divide Pipol
49 “I bring fire kom dis world and I wish sey di fire don dey katch! 50 E get one baptizim wey dem go baptize mi and my mind nor go fit rest until e happen! 51 Una tink sey na peace I bring kom dis world? No, I kom divide una! 52 From naw go, family wey bi five go divide, three go dey against two, two go dey against three. 53 Papa go dey against en son and son go dey against en papa, mama go dey against en dota and dota go dey against en mama, husband mama go dey against en pikin wife and wife go dey against en husband mama.”
How To Undastand Wetin Go Happen
54 Jesus tell di pipol, “Anytime una si sey di kloud dey go west, una dey know sey, heavy rain won fall and true-true, e go fall. 55 And wen una si breeze dey blow from east, una go sey, ‘Heat go dey today’ and na so e go bi. 56 Una wey dey pritend! Una fit tok how di weda go bi, but why una nor fit tok wetin dey happen so?”
Pay Wetin yu Whole
57 “Why una nor dey tok wetin dey good for pipol to do? 58 If yu and pesin get kase and una dey go kourt, make yu try setol with am for road, so dat e nor go drag yu go meet di judge, wey go give yu to sojas and dem go trow yu inside prison. 59 I tell una true word, yu nor go komot for der until yu pay all di money wey yu dey whole!”