13
Turn From Sin Kom Meet God
Some pipol wey dey der wen Jesus dey tok kon tell am how Pilate kill some Galilee pipol kon mix dia blood with dia sakrifice. Jesus ansa dem, “Una tink sey na doz Galilee pipol sin pass evribody, bikos dem sofa all dis tins? I tell una true word, nor bi so e bi! Unless una turn from sin kom meet God, all of una go die too! Doz eighteen pipol wey die wen towa fall for dia head for Siloam, una tink sey na dia sin big pass for Jerusalem? I tell una true word, nor bi so e bi! Unless una turn from sin kom meet God, all of una go die too!”
Israel Pipol, Make Una Bear Fruit
Jesus tell dem dis parabol, “One man plant fig tree for en farm, so e kon dey look for fruit from di tree, but e nor si. Naim e kon tell doz wey dey wosh di farm sey, ‘Since three years naw, I dey fine fruit for dis tree, but wen I look, I nor dey si. So, make una kut am down! Why wi still let am dey take space?’ But di farmer ansa, ‘Oga God, still leave am for dis year make I put fertaliza, Den if e bear fruit next year, wi go leave am, but if e nor bear, yu fit kut am trowey.’ ”
Jesus Heal For Sabat Day
10 Wen Jesus dey tish for one sinagog for Sabat Day, 11 one woman wey evil spirit bend en body for eighteen years dey der. 12 Wen Jesus si am, e koll di woman kon tell am, “Woman, yu don free from yor trobol.” 13 Jesus tosh di woman and at wons, en body kon strait and e start to praiz God.
14 But di oga for di sinagog vex sey Jesus heal pesin for Sabat Day, so e kon tell di pipol, “Wi get six days wen pipol suppose work, so make una kom make dem heal una for doz six days, but nor bi for Sabat Day.”
15 Den Jesus ansa am, “Yu wey dey pritend! Una nor dey luz una melu or donkey from rope go drink wota for Sabat Day? 16 So make I nor free dis woman wey bi Abraham pikin, wey dey Satan prison for eighteen years, bikos today na Sabat Day?”
17 Wen Jesus tok dis tin, shame katch all en enemies, so di pipol kon dey happy, bikos of wetin Jesus dey do.
God Kingdom
18 Jesus ask di pipol, “Wetin God Kingdom bi like? How I won take diskribe am? 19 E bi like mustard seed wey pesin plant for en farm. Di seed grow kon turn to big tree and birds build dia house for di tree.”
20 Jesus tok again sey, “Wetin I go tok sey God Kingdom bi like? 21 E bi like yist wey woman mix with three basket of flower so dat di bread go raiz.”
Small Door
22 Jesus travel pass some town and village kon dey tish as e dey go Jerusalem. 23 Somebody kon ask am, “Oga God, na only few pipol God go save?”
Jesus tell dem, 24 “Make una struggol well-well so dat una go fit pass di small door, bikos many pipol go try to enter God Kingdom, but dem nor go fit. 25 If di Oga God wey get di house go lock di door, una go stand for outside dey nok and beg sey, ‘Oga God, make yu let us enter!’
“But e go ansa, ‘I nor know where una from kom.’
26 “Den una go sey, ‘Wi chop and drink with yu and yu tish for awa town too.’
27 “But e go sey, ‘I nor know where una from kom! Make una nor near mi, una bi wiked pipol!’
28 “Una go kry dey grind tit wen una si Abraham, Isaak, Jakob and all di profets inside God Kingdom, but God go trow una for outside. 29 Pipol go from east, west, nort and sout kon sidan for di party for God Kingdom. 30 Den doz wey bi last, go bi first and doz wey bi first, go bi last.”
Jesus Go Jerusalem
31 Dat time, some Farisee pipol kom meet Jesus tok sey, “Run komot for here, bikos Herod won kill yu.”
32 But Jesus tell dem, “Make una go meet dat yeye man tell am, ‘Si, for today, tumoro and next tumoro, I go still dey drive demons dey heal pipol, until my work go finish.’ 33 But for today, tumoro and next tumoro, I go-go my way, bikos e nor fit happen sey dem go kill profet outside Jerusalem.
34 “Jerusalem pipol! Jerusalem pipol! Una wey kill profets and stone pipol wey God send kom meet una! E don tey wey I won gada una shidren as fawol dey gada en pikin under en feada, but una nor gri! 35 Make una look, una shidren don skata! And I tell una true word, una nor go si mi again until una go sey, ‘God don bless di pesin wey kom with en name!’ ”