18
Prayer
Den Jesus tell dem one parabol to show sey, e good make pipol dey always pray. E sey, “One judge dey for one town wey nor dey fear God and e nor dey respet anybody. For dat town, e get one woman wey en husband don die. E kon go meet di judge kon beg am, ‘Make yu help mi, bikos some pipol dey shit mi.’
“Di judge nor first listin to am, but afta, e tok for en mind sey, ‘Aldo I nor dey fear God and respet anybody, but bikos dis woman dey disturb mi, I go make sure sey e get wetin e suppose get, oda-wise e nor go let mi rest with dis en beggy-beggy wey nor dey finish.’ ”
Jesus sey, “If di wiked judge tok like dis, una nor tink sey God go help en pipol wey dey kry to am both day and nite? Abi, God go wait tey before E help dem? I tell una true word, God go help dem kwik-kwik. But wen Man Pikin kom back, e go si pipol wey get faith?”
Di Farisee And Tax Kollector
Jesus kon tell dis parabol to some pipol wey bilive and feel sey, na dem holy pass and nobody good rish dem. 10 “Two men go inside Temple go pray. One na Farisee and di oda one na tax kollector. 11 Di Farisee kon stand dey pray about ensef sey: ‘God, I tank yu sey I nor bi like oda pipol wey dey play wayo, dey sin, pipol wey dey kommit adultery or even like dis tax kollector. 12 I dey fast two times a week and I dey pay one out of evry ten tins wey I get, give yu.’
13 “But di tax kollector stand for far place and e nor even look heaven, but kon nak en chest dey sey, ‘God, make yu sorry for mi, bikos I bi sina!’
14 “I tell una true word, na di tax kollector God go forgive, nor bi di Farisee. Bikos anybody wey karry ensef go up, God go bring am down, but di pesin wey put ensef down, God go karry am up.”
Jesus And Small-small Shidren
15 Some pipol kon bring dia pikin make Jesus tosh dem. But wen di disciples si dem, dem kon bigin shaut for di pipol wey bring di shidren. 16 But Jesus koll di shidren kon sey, “Make una allow di small-small shidren kom meet mi, nor stop dem, bikos na pipol like dem get God Kingdom. 17 I tell una true word, anybody wey nor receive God Kingdom like small pikin, nor go enter inside.”
Di Rish Man
18 One day, one Jew oga ask Jesus, “Good tisha, wetin I go do to get life wey nor dey end?”
19 Jesus kon tell am, “Why yu dey koll mi good? Nobody good escept God. 20 Yu know di kommandment dem wey sey, ‘Make yu nor sleep with pesin wey nor bi yor husband or wife, nor kill pesin, nor tif, respet yor papa and mama.’ ”
21 Di man ansa Jesus, “I dey obey all dis law with all my heart since I bi small boy.”
22 Wen Jesus hear wetin di man tok, e kon tell am, “E still get one tin wey yu neva do, make yu sell evritin wey yu get, give di money to poor pipol, den yu go get betta propaty for heaven. Afta dat, make yu kom follow mi.”
23 Wen di man hear dis one, e kon dey vex, bikos e rish well-well. 24 Wen Jesus know sey di man dey vex, e kon tell di pipol wey dey with am, “E go hard well-well for pesin wey rish well-well to enter God Kingdom! 25 E dey eazy for kamel to pass nidol whole dan for pesin wey rish well-well to enter God Kingdom.”
26 Pipol wey hear dis word kon sey, “Den who God go save?”
27 Jesus ansa, “Wetin nor possibol for human being, dey possibol with God.”
28 Den Pita sey, “Oga God, wi don leave evritin wey wi get kon follow yu!” 29 Jesus kon tell dem, “I tell una di trut, anybody wey leave en house, wife, brodas, papa, mama or pikin bikos of God Kingdom, 30 God go bless am with wetin pass all di tins wey e leave, both for dis world and for di life wey dey kom.”
Jesus Tok About En Deat Again
31 Jesus koll di twelf disciples go korna kon tell dem, “Si, wi dey go Jerusalem and evritin wey di profets rite about Man Pikin go happen for der. 32 Bikos dem go gi-am to Gentile pipol and dem go laf, curse and spit for en body. 33 Dem go flog am well-well and dem go kon kill-am. But for di third day, e go wake-up.”
34 But di twelf disciples nor undastand wetin Jesus tok, bikos God hide wetin e mean from dem.
Jesus Heal Blind Man
35 As Jesus near Jeriko, one man wey blind sidan for di road korna dey beg. 36 Wen e hear plenty pipol dey pass, e kon ask wetin dey happen. 37 Dem kon tell am sey Jesus wey kom from Nazaret dey pass.
38 So di man kon dey shaut, “Jesus, David pikin, make yu sorry for mi o-o!”
39 So di pipol wey dey en front kon dey shaut for am make e kwayet, but e kon dey shaut more-more, “David pikin, make yu sorry for mi o-o!”
40 So Jesus stop kon sey make dem bring di beggar kom meet am. Wen di man kom, Jesus ask am, 41 “Wetin yu wont make I do for yu?”
Di man sey, “Oga God, I won si again.”
42 Jesus kon tell am, “Make yu si naw, yor faith don heal yu.” 43 At wons, di man bigin si and e kon follow Jesus, dey praiz God. Wen di pipol si wetin happen, dem kon bigin praiz God.