19
Jesus With Zakius
Jesus enter Jeriko kon waka go inside di town. For der, e get one man wey en name bi Zakius. E get money well-well, bikos e bi tax kollectors oga. E don tey wey e dey won si Jesus, but e nor fit si am, bikos e bi short man and pipol too plenty. So e run go klimb one sikamore tree make e for fit si am, bikos Jesus go pass dat road.
Wen Jesus rish dat place, e look up kon sey, “Zakius, kom down kwik-kwik, bikos I must stay for yor house today.” So Zakius kom down kon welkom Jesus with happiness.
Wen di pipol si wetin happen, dem kon dey komplain dey sey, “Jesus don go visit dat man wey bi sina.”
But Zakius stop kon tell Jesus, “Oga God si, I go give half of wetin I get to poor pipol and evribody wey I don shit before, I go pay am back four times!”
Den Jesus sey, “Salvashon don kom dis house today, bikos dis man na Abraham pikin too. 10 Man Pikin kom find and save pipol wey lost before.”
Ten Talent Parabol
11 As Jesus dey waka near Jerusalem, e kon tell di pipol one parabol to show sey God Kingdom nor go just kom like dat. 12 Jesus kon sey, “One big man travel go one far kountry where dem for won make am king and afta, e kom back. 13 Before e go, e koll ten of en savant kon give each one money sey, ‘Make una take dis money trade and make profit till I kom back.’
14 “But e own pipol nor like am, so dem kon send message follow am sey, ‘Wi nor wont dis man to bi awa king!’
15 “Wen e kom back afta e don get di kingdom, e kon koll en savants wey e give money make e for know how mush dem don gain.
16 “So di first one stand for en front sey, ‘Oga God, I don gain ten koins join di ones wey yu give mi.’
17 “Di oga kon tell am, ‘Yu do well, yu bi good savant! Bikos yu dey faithful with small tin, I go make yu oga ova ten towns.’
18 “Den di sekond one sey, ‘Oga God, I don gain five koins join di ones wey yu give mi.’
19 “So di oga tell am, ‘Yu go bi oga for five towns.’
20 “Den anoda savant kon sey, ‘Oga God, si di money wey yu give mi. I keep am inside klot. 21 Bikos I dey fear and know sey yu hash well-well. Yu dey chop food wey nor bi yor own and yu dey plok fruit wey yu nor plant!’
22 “Di oga kon tell am, ‘Na yor word I go take judge yu, yu wiked savant! So yu know sey, I bi hash man; dey chop food wey nor bi my own and I dey plok fruit wey I nor plant? 23 Den why yu nor put my money for bank, so dat wen I kom, I go kollect am with intrest wey go dey on-top?’
24 “Den di oga tell di oda savants, ‘Make una take di money from am, gi-am to di savant wey get ten.’
25 “Dem ansa, ‘Oga God, di man don already get ten!’
26 “Di oga kon sey, ‘I tell una, anybody wey get, God go gi-am more, but di pesin wey nor get, even di small one wey e get, God go take am from am. 27 But doz my enemy wey nor wont make I bi dia king, make una go bring and kill dem for my front!’ ”
Jesus Enter Jerusalem As King
28 Afta Jesus tok dis word, e kon go Jerusalem. 29 Wen e rish Betpage and Betany, for di place wey dem dey koll Mount Olives, e kon send two of en disciples sey, 30 “Make una go di village wey dey front. Wen una enter, una go si one small donkey wey nobody don sidan put before, wey dem tie for der. Make una luz am kom give mi. 31 If anybody ask una, ‘Why una dey luz am?’ Make una ansa, ‘Di oga nid am.’ ”
32 So di pipol wey dem send go, kon rish di place wey Jesus tell dem. 33 As dem dey luz di donkey, di owner kon ask dem, “Why una dey luz am?”
34 Dem ansa, “Di oga nid am.” 35 Dem take di donkey kon put dia klot on-top am, den Jesus sidan put. 36 As Jesus dey ride dey go, pipol kon spread dia klot for road.
37 As e dey enter di road wey go Mount Olives, all di disciples kon dey happy, dey praiz God with loud vois for all di mirakles wey dem si.
38 “God don bless di king wey dey kom with en name!
Make peace dey for heaven and make all di glory bi God own!”
39 But some Farisee pipol wey dey among di pipol kon tell Jesus, “Tisha, make yu tell yor disciples make dem kwayet.”
40 Jesus ansa, “I tell una true word, if dem kwayet, even stones go start to dey shaut!”
Jesus Cry Bikos Of Jerusalem
41 Wen Jesus near Jerusalem, e look di town kon dey kry, 42 den e sey, “I wish sey una know wetin go give una peace today! But naw, God don hide am from una. 43 Time go kom wen una enemies go surround una for evry korna kon block una road. 44 Dem go distroy una and una shidren and dem nor go leave one block on-top anoda, bikos di time wen God kom visit una, una nor know.”
Jesus Klean Di Temple
45 Jesus enter di temple kon drive all di pipol wey dey sell tins for der, 46 e kon sey, “God word sey, ‘My house na prayer house’, but una don turn am to house where tif dey hide put!”
47 Jesus kon dey tish evriday for di temple. Di priest oga dem, di law tishas with di big leaders among di pipol kon dey find how dem go take kill Jesus. 48 But dem nor get any shance, bikos pipol dey listin to wetin Jesus dey tish.