20
Jesus Authority
One day wen Jesus dey tish pipol for di temple, di priest oga dem and di law tishas kon meet am, dey sey, “Make yu tell us, na wish pawa yu take dey do dis tins? Na who give yu di pawa sef?”
Jesus ansa dem, “Make I still ask una one kweshon and make una ansa mi. John baptizim kom from heaven, abi na from pipol?”
Dem kon dey tok with each oda sey, “If wi sey na from heaven, e go sey, ‘Den why una nor bilive am?’ But if wi sey, ‘Na from pipol’, dis pipol go stone us, bikos dem bilive sey, John na profet.”
So dem kon tell Jesus sey dem nor know where di baptizim from kom.
Den Jesus tell dem, “Mi too nor go tell una who give mi di pawa to do all dis tins.”
Di Tenants Parabol
Jesus kon tell di pipol one parabol: “One man rent en grape farm give tenants, den e travel. 10 Wen harvest time rish, e kon send one savant go meet di tenants make dem gi-am en share from di harvest. But di tenants beat di savant kon send am go back with empty hand. 11 So e send anoda savant and dem still beat and do am anyhow, den dem kon send am back with empty hand. 12 Di man kon send di third savant go, but di tenants wound am kon trow am outside too.
13 “So di grape farm owner kon sey, ‘Wetin I go do naw? I go send di only pikin wey I get, may bi dem go respet am.’
14 “But wen di tenant si di pikin, dem kon sey, ‘Na di owner pikin dey kom so, make wi kill-am, so dat all di propaty go bi awa own!’ 15 Dem karry di pikin go outside, kon kill-am. So, wetin una tink sey di owner go do di tenants? 16 E go kom distroy all dis tenant, den give di grape farm to new tenants.”
Wen di pipol hear dis, dem kon sey, “Make dis tin nor happen o-o!”
17 But Jesus look dem for face kon ask, “Wetin God word mean wen e sey:
“ ‘Di stone wey di builders rijet,
don turn to di main stone?’
18 Anybody wey fall for dis stone, go break into pieces and di pesin wey di stone fall press, go die.”
19 Den di Farisee pipol and di law tishas won kon arrest Jesus for dat place, bikos dem know sey Jesus dey tok against dem. But dem dey fear di pipol.
Pay Tax Give Caesar
20 Den di Farisee pipol and di law tishas kon dey wosh Jesus well-well. Dem send some pipol go pritend like sey dem dey follow Jesus, so dat dem go fit use en word against am, kon ripot am to di Roman Govnor. 21 So dem ask am, “Tisha, wi know sey wetin yu dey tok korrect and yu nor dey do wayo, bikos yu dey tish di trut about God. 22 Make yu tell us, ‘E good make wi pay tax give Caesar?’ ”
23 But Jesus know sey na trap, so e kon tell dem, 24 “Make una show mi di money. Wish pesin face and name dey?” Dem ansa, “Na Caesar own.”
25 So Jesus tell dem, “Den make una give Caesar wetin bi Caesar own and make una give God wetin bi God own.”
26 So dem nor fit get am with en word for di pipol present. Dem sopraiz for di ansa wey e give and dem nor fit tok again.
Marriage And Resureshon
27 Den some Sadusi pipol (wey nor bilive sey pipol go wake-up from deat) kom meet Jesus, 28 dey sey, “Tisha, Moses Law sey, ‘If pesin die leave en wife and di woman nor born for am, en broda must marry di woman wey en husband don die, so dat e go born shidren for di broda wey don die.’ 29 E get one family wey get seven brodas. Di first one marry, but dem nor born before di man die. 30 Den di sekond one kon marry di woman, 31 den di third one, until nomba seven die too, but di woman nor still born for any of dem. 32 At last, di woman kon die too. 33 For di day wey pipol go wake-up from deat, wish pesin wife di woman go bi, since all di seven brodas marry am?”
34 So Jesus ansa dem, “Pipol for di word naw dey marry. 35 But di pipol wey God go wake-up from deat karry go heaven, nor go marry. 36 Dem go bi like angels and dem nor go die again. Dem go bi God shidren, bikos dem don wake-up from deat. 37 But even Moses tok sey pipol wey don die go wake-up. Moses tok like dis wen e rite about how e koll God, ‘Abraham, Isaak and Jakob God’, wen e dey di bush wey dey burn. 38 Awa God nor bi God for dead pipol, but na God wey dey alive, bikos for God eye, evribody dey alive.”
39 Den some law tishas ansa, “Tisha, yu don tok well!” 40 So dem nor dare ask Jesus kweshon again.
Mezaya: David Pikin, Na-im Bi Oga God
41 Jesus kon tell dem, “Wetin make dem sey Mezaya na David pikin? 42 Bikos David ensef tok for Psalms Book sey,
“ ‘God tell my oga sey,
“Sidan for my rite hand,
43 until I go put yor enemies
under yor leg.” ’
44 If David koll am ‘Oga God,’ how e kon take bi David pikin?”
Put Body Dan
45 As all di pipol dey listin, Jesus kon tell en disciples, 46 “Make una guide unasef from di law tishas. Dem like to dey waka with long klot make pipol dey shaut dia name for market and chairs wey betta pass for sinagog, na der dem dey like to sidan. 47 Dem dey sofa wimen wey dia husband don die and kollect dia tins kon dey pray long prayer make pipol for si dem. So na dia ponishment go big pass.”