22
Judas Sell Jesus
Time kon rish for Bread (wey nor get yist) Feast, wey dem dey koll Passova. Di priest oga dem and di law tishas dey fine how dem go take kill Jesus, but dem dey fear di pipol. So, Satan enter inside Judas Iskariot, one of Jesus twelf disciples. E kon go tell di offisa wey dey guide di temple sey e go sell Jesus give dem. Dem happy well-well kon promise am sey dem go gi-am money. Judas gri and e kon bigin find sekret way to sell Jesus give dem, so dat pipol nor go know.
Di Passova Feast
Di day for di Bread (wey nor get yist) Feast, wen dem dey kill sheep for sakrifice, kon rish. Jesus tell Pita and John, “Make una go prepare di Passova food wey wi go chop.”
Dem kon ask, “Na for where yu wont make wi prepare am?”
10 Jesus ansa dem, “Listin, wen una enter di town, una go meet one man wey karry wota pot, make una follow am enter di house wey e go enter, 11 make una tell di pesin wey get di house sey, Di Tisha sey make wi ask yu, ‘Where di room wey mi and my disciples go for chop di Passova food?’ 12 E go show una one big room where tabol and chair dey for upstair. Make una prepare evritin for der.”
13 Wen dem go, dem kon si evritin as Jesus tell dem sey e go bi, so dem prepare di Passova food for der.
Di Last Evening Food
14 Wen di time rish, Jesus sidan for where dem dey chop and en disciples kon join am. 15 Jesus tell dem, “I really won chop dis Passova food with una before I go sofa. 16 Bikos I tell una, I nor go chop am again, until evritin don komplete for God Kingdom.”
17 Den Jesus take one cup wey get wine, afta e tank God, e kon sey, “Make una take dis cup and divide am among unasef. 18 Bikos I tell una, from naw go, I nor go drink dis wine again, until God Kingdom go kom.”
19 Den Jesus take bread, afta e tank God, e divide am kon gi-am to dem sey, “Na my body bi dis, wey God don give una. Make una dey always do dis tin to take remember mi.”
20 Like dat, Jesus still take di cup afta dem don chop finish kon sey, “Dis cup wey God give una, na di new agriment with my blood.”
Last Word
21 “I wont make una know sey, di pesin wey go sell mi give my enemy dey chop with mi for dis tabol. 22 Bikos Man Pikin go die as God plan am, but curse dey for di pesin head wey go sell am!” 23 So di disciples kon bigin ask each oda wish of dem go sell Jesus.
Who Big Pass
24 Dem kon dey kworel among diasef sey wish of dem big pass. 25 So Jesus tell dem, “Gentile kings dey give dia pipol orda, yet di pipol still dey koll dem, ‘Pipol Friends.’ 26 But una nor suppose to bi like dat; di pesin wey big among una, must do like sey naim small pass and di leader, go bi like savant. 27 Na who big pass? Na di pesin wey sidan for tabol dey chop or di pesin wey dey serve am? Nor bi di one wey sidan for tabol? But I dey do like savant among una. 28 Na una stay with mi wen I dey pass thru wahala. 29 So, I give una pawa to rule, just as my Papa don give mi. 30 For my kingdom, una go sidan chop and drink for my tabol and una go sidan for difren thrones dey judge di twelf tribes for Israel.
31 “Simon! Simon! Make yu listin! God don allow Satan make e test all of una, so dat God go fit separate bad pipol from di good ones. 32 But Simon, I don pray for yu make yor faith nor for fail. Wen yu don turn back kom meet God, make yu help yor brodas too.”
33 Pita tell am, “Oga God, I dey ready to follow yu go prison and even die with yu.”
34 But Jesus sey, “Pita, make I tell yu di trut, fawol nor go do ‘Kukuruku’ dis nite until yu don tok three times sey yu nor know mi.”
35 Den Jesus tell dem, “Wen I send una go out, without money, bag or sandals, e get anytin wey una nid wey una nor get?”
Dem ansa, “No!”
36 E kon tell dem, “But naw, pesin wey get money or traveling bag must karry am. And pesin wey nor get swod must sell en klot kon use di money by one. 37 Bikos I tell una, wetin dem rite for God word about mi must happen sey, ‘Dem kount am join criminals.’ Bikos wetin God rite about mi dey happen naw.”
38 Di disciples kon sey, “Oga God, si two swod for here.”
Jesus ansa, “E don do.”
On-top Mount Olives
39 Den Jesus komot, kon waka as e dey always do, go Mount Olives and en disciples follow am. 40 Wen dem rish der, Jesus kon tell dem, “Make una pray so dat una nor go fall enter temptashon.” 41 Den e leave dem, waka go far small, kon knee down dey pray, 42 “Papa, if yu like to do am, make yu let dis sofa cup pass mi. But make e bi as yu wont, nor bi as I wont am.” 43 One angel appear from heaven kon give Jesus pawa. 44 Bikos Jesus dey struggol well-well for mind, e pray sotey en sweat kon bi like blood.
45 Wen e pray finish, e go meet en disciples kon si sey dem dey sleep, bikos dem don taya well-well. 46 So Jesus tell dem, “Why una dey sleep? Make una get up pray, so dat una nor go fall enter temptashon!”
Dem Arrest Jesus
47 As Jesus still dey tok, at wons, some pipol waka kom and na Judas lead dem. E waka go meet Jesus kon kiss am for face. 48 So Jesus ask am, “Judas, na kiss yu take sell Man Pikin?”
49 Wen doz wey dey near Jesus si wetin won happen, dem ask am, “Oga God, make wi use awa swod?” 50 Den one among dem attack di priest savant kon kut en rite ear komot.
51 But Jesus shaut for am make e stop, den tosh di man ear kon heal am.
52 Den Jesus ask di priest oga dem, di ofisas wey dey guide di temple and di eldas wey kom meet am sey, “Una karry swod and wood like sey una dey kom arrest tif? 53 Since wen I dey with una for di temple una nor arrest mi. But na una time bi dis, di time wey darkness pawa go rule.”
Dem Kondemn Jesus
54 Den dem arrest Jesus, karry am go di High Priest house. But Pita dey follow dem for back-back. 55 Wen dem don make fire for di kompond centre kon sidan togeda, Pita sidan with di pipol too. 56 One savant girl si Pita sidan near di fire, e look am for eye kon sey, “Dis man bin dey with Jesus too o-o.”
57 But Pita sey, “Woman! Nor bi mi, I nor know am.”
58 Afta sometaim, anoda pesin si am kon sey, “Yu dey with dem, nor bi so?”
But Pita sey, “My friend! I nor dey with dem o-o.”
59 Wen one hour don pass, anoda pesin kon sey, “I sey dis man dey with dem, bikos en too kom from Galilee.”
60 But Pita sey, “Oga God! I nor know wetin yu dey tok.” At wons, as e still dey tok, naim one fawol do, “Kukuruku!” 61 Den Jesus turn look Pita for eye and Pita kon remember di word wey Jesus tell am, “Before fawol go do ‘Kukuruku!’ dis nite, yu go don tok three times sey yu nor know mi.” 62 Den Pita go outside, bigin kry.
63 Di guards bigin laf Jesus kon dey beat am anyhow. 64 Dem tie en eye kon dey ask am, “Oya profesai! Na who nak yu so?” 65 Dem still curse am with difren words.
66 Wen morning rish, di eldas with di priest oga dem and di law tishas kon gada. Den dem take Jesus go dia kansol 67 kon tell am sey, “If yu know sey na yu bi Christ, make yu tell us.”
But Jesus ansa, “If I tell una, una nor go bilive mi 68 and if I ask una kweshon, una nor go gri ansa. 69 But from naw go, Man Pikin go sidan for God rite hand where pawa dey.”
70 All of dem kon ask, “So, yu bi God Pikin?”
Jesus ansa, “Na una tok am o-o.”
71 Den dem kon sey, “Why wi nid anoda witness? E don tok evritin by ensef!”