23
Dem Take Jesus Go Meet Pilate
Den di Farisee pipol and di oda pipol take Jesus go meet Pilate, dey akuiz am sey, “Wi hear dis man wen e dey deceive and tell awa pipol sey make dem nor pay tax give Caesar and e dey tok sey naim bi Christ, wey bi king.”
Pilate kon ask Jesus, “Na yu bi di Jew pipol king?”
Jesus ansa, “Na as yu tok.”
Den Pilate tell di priest oga dem and di pipol, “I nor si anytin wey go make mi kondemn dis man.”
But dem still sey, “E dey kause wahala with wetin e dey tish pipol for Judea. E start am for Galilee and naw e don kom here!”
Dem Take Jesus Go Meet Herod
Wen Pilate hear dis one, e kon ask weda Jesus na Galilee pesin. Wen e hear sey Jesus kom from Jerusalem, where Herod dey rule for dat time, e kon sey make dem take Jesus go meet am.
Wen Herod si Jesus, e happy well-well, bikos e don tey wen e won si am since e hear about am. E dey hope sey Jesus go do mirakle for en present. Herod kon ask Jesus many kweshon, but Jesus nor ansa am at-all. 10 Di priest oga dem and di law tishas dey akuiz Jesus with vexnashon. 11 Herod with en sojas too dey take Jesus make yeye and dey laf am. Den Herod sey make dem wear fine klot for Jesus body, den make dem take am go back go meet Pilate. 12 Dat day, Herod and Pilate kon bi friends, bikos before dis time dem bi strong enemy.
Dem Take Jesus Go Meet Di Pipol
13 Den Pilate koll di priest oga dem, di eldas and di pipol for dat place 14 kon tell dem, “Una bring dis man kom meet mi sey e dey deceive pipol. Wen I ask am kweshon for una present, I nor si any bad tin wey una sey e do. 15 Even Herod nor still si anytin too, so e sey make dem bring am kom meet us. Dis man nor do anytin wey go make am die. 16 So I go give orda make dem flog am, den I go free am.” 17 (Na dia tradishon sey Pilate must release one prisona anytime wen dem dey do Passova Feast.)
18 But all of dem kon dey shaut, “Take dis man komot! Na Barabas wi wont!” 19 (Barabas na pesin wey dem put for prison bikos e kause wahala and kill pesin for di town.)
20 Pilate kon tok to dem again, bikos e won free Jesus. 21 But dem still dey shaut, “Kill-am trowey, Kill-am trowey!”
22 Again Pilate ask dem, “Why? Wish bad tin e do? I nor si any bad tin wey e do wey go make am die, so I go give orda make dem flog am, den I go free am.”
23 But dem shaut more-more dey sey, “Kill-am trowey.” Dem shaut sotey Pilate kon do wetin dem wont. 24 So Pilate orda en sojas sey make dem give Jesus to di pipol make dem go kill-am. 25 E kon free Barabas, wey di pipol wont, wey dem bin put for prison, bikos e kause wahala and kill pesin for di town.
Dem Nail Jesus For Cross
26 As dem dey take Jesus komot, dem kon katch one man wey dey kom from Sirene and en name na Simon. Dem put di cross for en back make e karry am follow Jesus. 27 Many pipol follow Jesus and di wimen among dem kon dey kry. 28 But Jesus turn look dem sey, “Jerusalem wimen, make una nor kry bikos of mi, but make una kry for unasef and for una shidren. 29 Bikos true-true, di time dey kom wen pipol go sey, ‘E good well-well for wimen wey nor born or feed pikin at-all!’ 30 Den,
“dem go tell di mountins, ‘Make yu fall on-top us!’
And tell di hills, ‘Make yu kover us!’
31 But if dem do dis kind tin for wood wen e still fresh, wetin go happen wen di wood don dry?”
32 Dem still take two oda men wey bi tif, wey dem wont kill, follow Jesus. 33 Wen dem rish di place wey dem dey koll, “Di Skull,” dem kon nail Jesus for cross with di two tif, one for en left and di oda for en rite side. 34 (Den Jesus kon sey, “Papa, make yu forgive dem, bikos dem nor know wetin dem dey do.”) So, di sojas kon gambol to know who go take Jesus klot.
35 Di pipol still stand der dey look, but dia leaders dey laf Jesus sey, “E save oda pipol. Make e save ensef if e bi di Mezaya wey God choose!”
36 Di sojas still dey laf Jesus and dem kon gi-am wine wey don sawa make e drink, 37 den sey, “If yu bi di Jew pipol king, make yu save yorsef!”
38 Dem kon rite on-top en cross sey, “Dis na, ‘Jew Pipol King.’ ”
39 One of di tif dey shaut for Jesus, “Nor bi yu bi di Mezaya? Make yu save yorsef and us naw!”
40 But di oda tif kon shaut for di first tif, “Yu nor dey fear God as e bi sey na di same ponishment wi dey sofa? 41 Na dis ponishment fit us, bikos na wetin wi do naim make dem dey ponish us so. But dis man nor do any bad tin.”
42 Den e tell Jesus, “Wen yu rish yor kingdom, make yu remember mi!”
43 Jesus ansa am, “I tell yu di trut, today yu go dey with mi for paradise.”
44 By naw, twelf oklok don nearly rish for aftanoon and darkness kover di whole kountry until three oklok for dat aftanoon, 45 bikos sun stop to shine. Di Temple curtain kon tear into two. 46 So, Jesus shaut, “Papa, I put my spirit for yor hand!” Afta e tok finish, e kon die.
47 Wen di soja oga si wetin happen, e kon praiz God sey, “True-true, dis man na good pesin!” 48 So wen all di pipol wey gada dey look si wetin happen, dem kon dey kry go dia house. 49 And evribody wey know Jesus before, stand for far and di wimen wey follow Jesus kom from Galilee, si di tins wey happen.
Dem Beri Jesus
50 E get one man for di kansol, wey bi Josef and e kom from Arimatea wey dey Judea. E bi betta pesin wey dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God Kingdom go kom. 51 (E nor gri with di oda kansol membas with dia plan and for wetin dem do so.) 52 E go meet Pilate kon ask for Jesus dead body. 53 Den e karry di body from di cross, wrap am with linen klot kon put am for di grave wey e dig inside rock, where dem neva beri anybody put before. 54 Dat day na Friday wen dem dey ready for Sabat Day serimony.
55 Di wimen wey follow Jesus from Galilee kon follow Josef go si di grave. So dem put Jesus body inside. 56 Den di wimen go house go prepare betta perfume. But for Sabat Day, dem kon rest as Moses Law tok.