4
Devil Tempt Jesus
Di Holy Spirit enter Jesus body kon karry am from Jordan River go inside wildaness. For der, devil kon tempt am for forty days. Dat time, Jesus dey fast, so e nor chop food, but afta e fast finish, e kon dey hongry.
Devil kon tell am, “If na true sey yu bi God Pikin, make yu kommand dis stone make e turn to food.”
Den Jesus ansa, “God word sey, ‘Nor bi only food man suppose to chop for dis world, but na evry word wey God tok.’ ”
Den devil take Jesus go on-top one mountin kon show am all di kingdom wey dey dis world. Den e tell am, “I go give yu all dis place and all di honor wey follow am as yor kingdom, bikos dem don gi-am to mi and I fit gi-am to anybody wey I wont. So, if yu bow down woship mi, I go give yu evritin.”
Jesus ansa, “God word sey, ‘Na only God yu must woship and serve.’ ”
Den devil take Jesus go Jerusalem kon make am stand on-top di place where high pass for di temple kon tell am, “If yu really bi God Pikin, make yu jump go down, 10 bikos God word sey,
“ ‘God go tell en angels make dem guide yu’
11 and,
‘Dem go karry yu for dia hand,
so dat yu nor go use yor leg nak stone.’ ”
12 Jesus ansa am, “God word sey, ‘Make yu nor test God wey bi yor Oga God.’ ”
13 So wen devil don tempt Jesus finish, e kon leave am until anoda time.
Jesus Start En Ministry For Galilee
14 As di Holy Spirit pawa full Jesus body, e kon go back to Galilee and en story bigin spread for di whole aria. 15 E bigin tish for dia sinagog and evribody kon dey praiz God.
16 Afta, Jesus go Nazaret where e for grow up, e enter di sinagog for Sabat Day as e dey always do and e kon get up make e read. 17 Dem gi-am di book wey Profet Isaya rite. Jesus kon open am rish di place wey dem rite sey,
18 “God Spirit dey my body,
bikos E don anoint mi
make I prish Good News give poor pipol.
E send mi make I prish freedom
give pipol wey dey prison
and make blind pipol for si.
E still sey make I free doz
wey dem dey opress
19 and make I announce sey
di time wen God won save en pipol, don rish.”
20 Jesus klose di book kon gi-am back to di pesin wey dey hold am, den e go sidan. So evribody wey dey di sinagog kon dey look am. 21 Den Jesus tell dem, “Today, di tins wey dem rite for God word for where I read, don happen, just as una hear am wen I dey read am.”
22 Evribody dey tok good about Jesus, dem sopraiz for di sweet-sweet word wey dey kom out from en mout. So dem kon ask, “Dis nor bi Josef pikin?”
23 Jesus tell dem, “I know sey una go kwote proverb for mi sey, ‘Doctor, make yu cure yorsef!’ And una go sey, ‘For here wey bi yor home-town, wi won make yu do wetin wi hear sey yu do for Kapanaum.’ ”
24 Jesus still sey, “Make I tell una true word, profet nor dey get respet for en home-town. 25 But I tell una di trut, wimen wey dia husband don die many for Israel for Elijah time, wen God stop rain for three and half years and betta honga kon dey evriwhere. 26 But God nor send Elijah go meet any of doz wimen, escept one woman wey en husband die for Zarefat inside Sidon. 27 Pipol wey get leprosy many for Israel for profet Elisha time, but God nor heal any one escept Naaman, wey kom from Siria.”
28 Wen dem hear dis tins, all di pipol for di sinagog kon dey vex. 29 Dem push Jesus komot from di town kon take am go di hill wey dia town dey on-top, make dem for trow am down. 30 But Jesus pass dia centre, waka komot.
Jesus Ministry For Kapanaum
31 So Jesus kon go Kapanaum, wey dey Galilee and e bigin tish pipol for Sabat Day. 32 Dem sopraiz well-well for en tishing, bikos e dey tok with authority.
33 Inside di sinagog, one man wey evil spirit dey en body kon dey shaut, 34 “Abeg, make yu leave us alone, Jesus wey kom from Nazaret! Yu don kom distroy us? I know who yu bi, yu bi God savant wey holy.”
35 But Jesus tell am: “Make yu shut up! Yu demon, komot for en body.” Di demon trow di man for groun for dia front kon komot for en body, but di man nor wound.
36 Di pipol sopraiz kon dey ask each oda, “Wetin dey happen so? Dis man dey use God pawa take kommand demon and dem dey obey am!” 37 So di news about Jesus kon spread enter di whole aria for Galilee.
38 Afta Jesus komot for di sinagog, e enter Simon house. Simon wife mama get fever and dem kon beg Jesus make e heal am. 39 So Jesus stand near di woman kon kommand di fever komot for en body. Kwik-kwik, di woman get up, bigin kare for Jesus and di odas wey dey di house.
40 As day dey dark, evribody wey get pipol wey nor well kon bring dem kom meet Jesus. E tosh dem for head and dem kon well. 41 Demons dey shaut dey komot from many pipol body, dey sey, “Yu bi God Pikin!” But Jesus warn dem make dem nor tok, bikos dem know sey, naim bi di Mezaya.
42 Wen day break, Jesus komot go one place where nobody dey. But pipol find am rish der and dem kon dey try to hold am make e nor for leave dem. 43 But Jesus tell dem, “I must prish dis Good News about God Kingdom give pipol wey dey oda towns, bikos na wetin God send mi kom do, bi dat.” 44 So e kontinue to prish for di sinagogs wey dey Judea.