5
Jesus Koll En Disciples
Jesus stand near Gennesaret and pipol gada make dem for hear God word. E si two kenu for di wotaside, but di Fisha men wey get dem, don kom down dey wosh dia net. E enter inside one kenu wey bi Simon Pita own kon tell am make e push di kenu enter wota small. Den Jesus kon sidan dey tish di pipol from di kenu.
Wen e don tok finish, e kon tell Simon, “Push di kenu go where deep pass for di wota, make una for fit katch fish.”
Simon ansa, “Oga God, wi dey here from nite till day break and wi nor katch anytin. But as yu tok, wi go trow awa net inside wota.”
So, dem trow dia net inside wota and dem katch many fish sotey dia net kon start to tear. So, dem kon do sign give di oda pipol wey dey follow dem work, make dem kom help dem. Wen dem put all di fish inside di two kenu, di kenu dem kon dey won sink.
Wen Simon si wetin happen, e kon knee down for Jesus front dey sey, “Abeg, nor near mi Oga God, bikos I bi sina.” Pita and all di pipol wey dey with am sopraiz well-well wen dem si all di fish wey dem katch. 10 James and John wey bi Zebedee shidren, wey dey follow Pita work, sopraiz too.
Den Jesus tell Simon Pita, “Make yu nor worry, from today go, na pipol yu go dey katch.” 11 So wen dem don push dia kenu rish groun for di wotaside, dem leave evritin kon follow Jesus.
Jesus Heal Leper
12 Wen Jesus dey for one town, one man wey get leprosy kom meet am. Wen di man si Jesus, e fall face groun kon beg am sey, “Oga God, if yu like to do am, yu go fit heal mi.”
13 So Jesus tosh di man kon sey, “I like to do am. ‘Oya! Make yor body klean naw!’ ” At wons, di leprosy komot for di man body.
14 Jesus tell di man, “Make yu nor tell anybody, but go show yorsef to di priest and pay di ofrin wey Moses kommand sey, pipol wey dia leprosy don komot for dia body go bring, so dat di priest go know sey yu don really well.”
15 But di news about Jesus kon spread pass before and many pipol kom meet am make dem for fit hear en word and make e for heal dem. 16 But Jesus komot go pray for wildaness, where pipol nor dey.
Jesus Heal And Forgive Who Nor Fit Waka
17 One day, wen Jesus dey tish, some Farisee pipol and di law tishas kon kom from all di village wey dey Galilee, Judea and Jerusalem, dem sidan near Jesus and God pawa dey with am to heal pipol. 18 Some men karry one man for bed wey nor fit waka, kom. Dem kon dey try to karry am enter di house kom meet Jesus, 19 but bikos pipol many, dem nor fit karry am pass, so dem kon open di zink for di housetop, drop di man with di bed small-small, till e rish Jesus front for di pipol centre. 20 Wen Jesus si how dia faith big rish, e kon tell di man, “My friend, I forgive yu all yor sins.”
21 So di law tishas and di Farisee pipol kon dey tell diasef sey, “Who bi dis man wey dey shalenge God like dis? Who fit forgive sin escept God?” 22 Jesus know wetin dem dey tink, so e ask dem, “Why una dey tink like dis sef? 23 Wish one eazy to tok? ‘I forgive yu yor sin?’ or ‘Get up make yu waka?’ 24 But make una for know sey Man Pikin get pawa for dis world to forgive sin, e kon tell di man wey nor fit waka, ‘I tell yu, get up, karry yor bed make yu dey go house.’ ” 25 At wons, di man kon get up for dia present, karry di bed wey e liedan put before kon dey praiz God as e dey go house. 26 Evribody for der sopraiz well-well. Fear katch dem and dem kon dey wonder dey sey, “Na wonderful tin awa eye si today so o-o!”
Jesus Dey Chop With Sinnas
27 Afta dis one, Jesus go out and e kon si one tax kollector sidan for where e for dey kollect tax, en name na Levi. Jesus kon tell am, “Make yu follow mi.” 28 Levi get up, leave evritin kon follow am.
29 Den Levi do party for en house bikos of Jesus, so many tax kollectors and oda pipol kom chop with dem for di party. 30 But di Farisee pipol and some law tishas kon dey vex for Jesus disciples sey, “Why una dey chop and drink with tax kollectors and sinnas?”
31 Jesus ansa dem, “Pipol wey well nor nid doctor, na only doz wey nor well, nid am. 32 I nor kom koll good pipol to turn from sin kom meet God, but na sinnas, I kom koll.”
Betta Tins Wey Dey Kom
33 Den some pipol tell Jesus, “John disciples dey fast and pray and di Farisee disciples dey do di same tin too, but yor disciples just dey chop and drink anyhow.”
34 So Jesus ansa dem, “Yu go fit sey make pipol wey kom marriage dey fast wen di man wey dey marry dey der? 35 But time dey kom wen di man wey dey marry nor go dey with dem, dat time, dem go fast.”
36 E still tell dem one parabol sey: “Nobody dey tear new klot take pash old one. If e do like dat, e go fit spoil di new klot and di new klot piece nor go mash di old one. 37 And nobody dey pour new wine inside old wine bag. If e do like dat, di new wine go tear di bag, di wine go trowey and di bag go skata. 38 Instead, pipol suppose pour new wine inside new wine bag. 39 Nobody go like to drink new wine afta e don drink old wine. Bikos e go sey, ‘Na di old wine betta pass.’ ”