8
Jesus Ministry
Afta sometaim, Jesus kon travel go all di town and village dey prish di Good News about God Kingdom. Di twelf apostles and some wimen wey Jesus drive evil spirit and difren sickness komot for dia body, go with am: Mary (wey dem dey koll Magdalin), wey Jesus drive seven demon komot for en body, Joanna, Shuza wife (wey bi managa for Herod house), Susanna and many oda wimen wey dey use dia own money support Jesus and en disciples.
Di Farmer Parabol
Many pipol gada round Jesus and some still dey kom from difren place, so e kon tell dem dis parabol: “One man go plant seed for en farm. As e dey plant, some fall for road, pipol mash dem pass and birds kon chop dem. Some wey fall for where stones dey kon grow and die, bikos wota nor dey dat groun. Odas fall for where shuku-shuku dey and wen dem grow, di shuku-shuku grow too, kon shuk dem die. But di ones wey fall for betta groun, grow kon bear pass hundred seed.”
Den Jesus sey, “Anybody wey get ear, make e hear!”
Den en disciples ask am wetin di parabol mean. 10 Jesus ansa dem, “Una get di shance to know God Kingdom sekret, but dis oda pipol, na only parabol dem go take hear am, so dat
“As dem dey look,
dem nor go si
and as dem hear,
dem nor go undastand.
11 “Na wetin di parabol mean bi dis: Di seed na God word. 12 Di ones wey fall for road, na di pipol wey hear God word, but devil kon tif am from dia heart, so dat dem nor go bilive and God nor go save dem. 13 Di ones wey fall for where stones dey, na di pipol wey hear God word kon receive am with happiness, but dem nor get rut. Dem bilive small, but wen wahala kom, dem nor bilive again. 14 Di seeds wey fall for shuku-shuku, na di pipol wey hear God word, but wahala, plenty propaty and jolly-jolly for dis world kon shuk dem, so di fruit nor even ripe. 15 But di seeds wey fall for betta groun, na di pipol wey hear God word, hold am with betta mind, dey obey God and bear wahala, so dem kon bear plenty fruit.”
Di Lite
16 “Pesin nor go lite kandol kon take bucket kover am or hide am under bed, but e go put am for where pipol go si am wen dem enter di house. 17 Bikos e nor get wetin pipol hide naw, wey God nor go bring out and wetin dey sekret naw, God go bring am out for where lite dey. 18 So make una listin well-well, bikos pesin wey get, God go gi-am more, but pesin wey nor get, even di small one wey e tink sey e get, God go take am from en hand.”
Jesus Family
19 Jesus mama and en brodas kom meet am, but dem nor fit go near am, bikos pipol plenty for der. 20 So pipol tell am, “Yor mama and brodas dey outside, dem won si yu.”
21 Jesus ansa, “My mama and brodas na pipol wey dey hear and obey God word.”
Jesus Stop Breeze For Wota
22 One day, Jesus and en disciples enter kenu, den e tell dem, “Make wi cross go di oda side for di river.” So dem kon go. 23 As dia kenu dey move for di wota, Jesus dey sleep, den strong breeze start to blow and dem kon dey fear, bikos wota dey enter di kenu.
24 Dem kon tell Jesus, “Oga God! Oga God! Na die wi dey so!”
Jesus get up kon kommand di breeze make e stop and di wota wey rof before, stop and evriwhere kon kwayet. 25 Den Jesus ask dem, “Where una faith dey?”
But dem dey fear and sopraiz dey tell each oda, “Wish kind man bi dis sef? Even breeze and wota dey obey am!”
Jesus Heal Man Wey Get Demon
26 Dem kon rish Gerasenes aria wey face Galilee. 27 As Jesus kom down from di kenu, one man wey get demon for di town kom meet am. E don tey wen dis man wear klot or stay inside house, but e dey stay for beri groun. 28 Wen e si Jesus, e fall for en front kon shaut, “Make yu leave mi! Jesus, God Pikin, Abeg yu, nor ponish mi!” 29 E shaut, bikos Jesus don first kommand di evil spirit make e komot for en body (bikos di evil spirit don disturb di man well-well and dem dey shain and guide am. But e dey break di shain and di demon go drive am go inside wildaness.)
30 Jesus ask am, “Wetin bi yor name?” E ansa, “Na Legion, bikos wi plenty inside am.” 31 Di demons kon beg Jesus make e send dem go inside di river.
32 Near di river, many pig dey togeda dey chop and di evil spirits beg Jesus make dem enter inside di pigs. So Jesus allow dem. 33 Di demons komot for di man body go enter di pigs and all of dem rush enter di river go die.
34 Wen di pipol wey dey keep di pigs si wetin happen, dem run go inside town bigin spread di news. 35 So pipol run kom si wetin dey happen and dem meet Jesus for der. Di man wey Jesus drive demon komot for en body, don well and e wear klot sidan near Jesus leg, so fear kon katch di pipol. 36 Pipol wey si wetin happen, tell di town pipol how Jesus heal di man wey get demon before. 37 Den all di pipol for Gerasenes and di aria wey near der, kon tell Jesus make e leave dem, bikos dem dey fear well-well. So Jesus and en disciples enter kenu kon komot for der.
38 Di man wey demon komot for en body beg Jesus make e follow am, but Jesus tell am, 39 “Make yu go yor house go tell dem wetin God don do for yu.” So di man kon go, dey tell pipol for di town wetin Jesus do for am.
Jesus Heal Jairus Dota
40 Wen Jesus go back for di oda side for di river, pipol welkom am for der, bikos e don tey wey dem dey wait for am. 41 Den Jairus wey bi oga for di sinagog waka kom. E fall for groun near Jesus leg, dey beg am make e kom en house, 42 bikos e only dota wey don rish twelf years, dey die.
As Jesus dey go di man house, pipol kon dey waka jam am anyhow bikos dem plenty. 43 One woman dey among dem wey don dey mestrate for twelf years naw, bikos nobody fit heal am. 44 E waka kom Jesus back kon tosh Jesus klot korna and at wons, di blood kon stop.
45 Den Jesus ask, “Na who tosh mi?”
Wen evribody sey dem nor know, Pita kon tell Jesus, “Oga God, plenty pipol gada round yu and all of dem body dey tosh yu!”
46 But Jesus sey, “Somebody tosh mi, bikos pawa komot for my body.”
47 Wen di woman si sey e nor go fit hide again, e kom out dey shake kon fall for Jesus front. For evribody present, e tok wetin make am tosh Jesus and how e kon well at wons. 48 Jesus kon tell di woman, “My pikin, yor faith don heal yu. Make peace follow yu.”
49 As Jesus still dey tok, somebody run kom from Jairus house kon tell Jairus sey, “Yor pikin don die, so make yu nor worry di tisha again.”
50 But wen Jesus hear am, e tell Jairus, “Make yu nor fear, just bilive and yor pikin go well.”
51 Wen dem rish di house, Jesus nor let anybody follow am enter, escept Pita, John and James with di pikin papa and mama. 52 Evribody for der dey kry take body nak groun, but Jesus tell dem, “Make una nor kry, bikos di girl neva die, na sleep e dey sleep.”
53 Dem kon bigin laf am, bikos dem know sey di girl don die. 54 But Jesus whole di girl hand kon sey, “My pikin, get up.” 55 Naim di girl spirit enter di body back and e kon get up at wons. Den Jesus tell dem make dem give di pikin food chop. 56 Di papa and mama sopraiz well-well, but Jesus kommand dem make dem nor tell anybody wetin happen.