7
Jesus Heal Roman Soja Savant
Afta Jesus tish di pipol all dis tins, e kon go Kapanaum. For der, one Roman soja get one savant wey e like well-well, but di savant nor well and e nearly die. Wen di soja hear about Jesus, e kon send some Jew eldas go meet am sey, make e kom heal en savant. Wen dem si Jesus, dem beg am well-well sey, “E good make yu kom help am, bikos e love awa pipol and e even build sinagog for us.” So Jesus follow dem go.
As Jesus near di house, di soja kon send some for en friends go meet am sey, “Oga God, nor trobol yorsef, bikos I nor big rish who yu go enter en house. Na dis make mi nor waka kom meet yu, instead, make yu just give orda and my savant go well. Bikos mi too get pipol wey big pass mi and I get di ones wey I big pass. If I tell one, ‘Go!’ E go-go and anoda one, ‘Kom!’ E go kom and if I tell my savant, ‘Do dis tin!’ E go do am.”
Wen Jesus hear dis, e sopraiz and belle sweet am, naim e look di pipol wey dey follow am kon tell dem, “I tell una true word, I neva si dis kind faith before, even for Israel.” 10 So, wen doz wey di soja send go back to di house, dem kon si sey di savant don well.
Jesus Wake Widow Pikin
11 Afta, Jesus go one town wey dem dey koll Nain, en disciples with many pipol follow am. 12 Near di town gate, dem meet pipol dey karry one dead body go beri. Di man mama na widow and naim bi di woman only pikin, so plenty pipol from di town kon follow am. 13 Wen Jesus si di woman, e sorry for am kon tell am, “Make yu nor kry again.”
14 Den e waka go tosh di koffin and di men wey karry am kon stop. Jesus kon sey, “Yong man, get up!” 15 So di man get up kon start to tok. Jesus kon gi-am back to en mama.
16 Fear katch all of dem and dem kon dey praiz God sey, “Na big profet kom meet us so-o!” and “God don kom help en pipol!” 17 Di news about Jesus spread round Judea and all di place wey near der.
Jesus And John Di Baptist
18 John disciples kon tell John about di tins wey dey happen. So e koll two of en disciples 19 kon send dem go ask Jesus sey, “Na yu bi di pesin wey wi dey espect, abi make wi wait for anoda pesin?”
20 Wen dem si Jesus, dem kon sey, “John di Baptist send us make wi ask sey, ‘Na yu bi di pesin wey wi dey espect, abi make wi wait for anoda pesin?’ ”
21 For dat same time, Jesus heal many pipol wey get difren sickness, pipol wey get evil spirit and pipol wey nor fit si, kon dey si. 22 So, Jesus ansa dem, make una go tell John wetin una don si and hear: “Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka before, dey waka, pipol wey get leprosy, dia body don klean, pipol wey nor dey hear, don dey hear naw, pipol wey don die, don wake-up and even poor pipol, don hear di Good News. 23 God go bless pipol wey nor dey doubt mi.”
24 Wen John messenjas don go, Jesus kon bigin tok to di pipol about John: “Wetin una go find for inside wildaness? Na grass wey breeze dey blow? 25 Wetin una go out go si? Na man wey wear fine klot? No! Bikos pipol wey dey wear fine klot and dey enjoy life, na king palis dem dey stay. 26 Wetin una go out go si? Na profet? Yes! I tell una, e even big pass profet. 27 Dis na wetin dem rite about am,
“ ‘I dey send my messenja go yor front,
wey go-go prepare yor road for yu.’
28 I tell una true word, among all di pipol wey woman born, nobody big rish John di Baptist, but di pesin wey small pass for God Kingdom, big pass am.”
29 (Naw, evribody wey hear dis tins, even di tax kollectors, know sey God dey do wetin dey rite, bikos John di Baptist, baptize dem. 30 But di Farisee pipol and di law tishas rijet wetin God plan for dem, bikos John nor baptize dem.)
31 How I won take tok about pipol wey dey for dis world naw? 32 Dem bi like shidren wey sidan for market dey tell each oda,
“ ‘Wi play music for una,
but una nor gri dance;
wi sing beri song for una,
but una nor gri kry.’
33 Wen John di Baptist kom, e nor chop food or drink wine, but una sey, ‘E get demon!’ 34 But God Pikin kom, dey chop and drink and una sey, ‘Si am, long-trot, drunkard, na tax kollectors and sinnas bi en friend.’ 35 But doz wey get wisdom, know sey evritin about am, na trut.”
Jesus Anointin
36 One Farisee kon invite Jesus kom chop for en house, so Jesus enter di Farisee house kon sidan. 37 Den, wen one woman from dat town wey bi sina hear sey Jesus dey chop for di Farisee house, e kon bring one fine oil bottol, wey dey send well-well, kom. 38 E knee down for Jesus front dey kry and e kon dey wet Jesus leg with di tears from en eye. E klean Jesus leg with en hair kon kiss dem, den e pour di oil put.
39 Wen di Farisee wey invite Jesus si wetin dey happen, e kon tok for en mind sey, “If dis man na profet true-true, e for know sey dis woman wey dey tosh am so, na sina e bi.”
40 Jesus kon tell di Farisee, “Simon, e get wetin I won tell yu.”
Simon kon sey, “Tisha, I dey listin.”
41 “E get one man wey get two savant wey dey owe am money, one dey hold am 5,000 and di oda one, five hundred. 42 Wen two of dem nor fit pay di money back, e kon sey make dem forget about di money. Afta dat, wish of dem go like di man pass?”
43 Simon ansa, “Na di one wey en money big pass.”
Jesus kon tell am, “Wetin yu tok, korrect.”
44 Den Jesus look di woman kon ask Simon, “Yu dey si dis woman? I enter yor house, yu nor give mi wota wosh leg, but di woman don wosh my leg with en tears kon take en hair klean am. 45 Wen I enter yor house, yu nor kiss or greet mi as awa tradishon bi, but since I enter, dis woman neva stop to kiss my leg. 46 Yu nor pour oil for my head, but dis woman don anoint my leg with oil wey dey send well-well. 47 Make I tell yu, I don forgive dis woman en many sins, so en love don big well-well, but di pesin wey dem forgive small sin, en love go small.”
48 Den Jesus tell di woman, “I forgive yu all yor sins.”
49 But di pipol wey sidan dey chop with Jesus kon dey tell each oda, “Who bi dis man wey dey forgive sin?”
50 So, Jesus tell di woman, “Yor faith don save yu; make peace follow yu go.”