18
Afta King Jehoshafat get money kon popula well-well, e sey make one pesin for en family marry from King Ahab family for Israel. Afta some years, Jehoshafat travel go meet King Ahab for Samaria. King Ahab kill many sheep and melu as respet for King Jehoshafat with en men wey kom visit am. E beg King Jehoshafat make e join am attack Ramot pipol for Gilead town. King Ahab ask King Jehoshafat, “Yu go follow mi go attack Ramot Gilead?”
Jehoshafat ansa, “Mi and my sojas dey ready, if yu ready. But make wi ask God first.”
So King Ahab koll almost 400 profets kon ask dem, “Make I go attack Ramot Gilead or not?”
Dem ansa, “Make yu go attack am, bikos God go make yu win.”
But King Jehoshafat ask, “E nor get anoda profet wey wi fit use take ask God?”
King Ahab ansa, “E get anoda one, en name na Mikaya wey Imlah born. But I hate am, bikos e nor dey profesai anytin wey dey good give mi, na only bad tin e dey tell mi.”
King Jehoshafat kon sey, “Make yu nor tok like dat!”
Den King Ahab koll di offisa for di kourt kon sey make e go bring Profet Mikaya kom.
Di two kings wear dia royal robes kon sidan for dia thrones for di gardins for Samaria gate and all di profets bigin profesai for dem. 10 One among dem wey en name na Kenaana wey Zedekaya born kon use iron make horn, den e tell King Ahab, “Dis na wetin God tok, ‘Na dis tin yu go take fight Siria pipol kon win dem finish.’ ”
11 All di oda profets tok di same tin sey, “Make yu go fight for Ramot Gilead and yu go win dem, bikos God go give yu viktory.”
12 Di ofisas wey go koll Mikaya, tell am, “All di oda profets don profesai viktory give di king. So make yu do di same tin.”
13 But Profet Mikaya ansa, “I promise una with God wey dey alive sey, I go tok wetin God sey make I tok!”
14 Wen Profet Mikaya rish where King Ahab dey, di king ask am, “Profet Mikaya, Make mi and King Jehoshafat go attack Ramot Gilead or make wi nor go?”
Mikaya ansa, “Make una go attack am, bikos God go give una viktory.”
15 But King Ahab ask am, “How many times I go tell yu sey, if yu dey tok to mi with God name, make yu dey tell mi di trut?”
16 Mikaya ansa, “I si Israel soja wey skata for evriwhere for di hill like sheep wey nor get who dey kare for dem. And God sey, ‘Dis men nor get leader, make dem go house with peace.’ ”
17 King Ahab tell King Jehoshafat, “I nor tell yu sey e nor dey profesai anytin wey dey good for mi? Na only bad tin e dey profesai for mi!”
18 Mikaaya still sey, “Make yu listin to wetin God tok! I si God sidan for en throne for heaven with all en angels as dem stand round am. 19 Den God ask, ‘Na who go-go deceive King Ahab, so dat dem go kill-am for Ramot Gilead?’
“Di angels kon dey tok difren tins, 20 until one spirit kom out kon tell God, ‘I go-go deceive am.’
21 “God ask, ‘How yu wont take deceive am?’
“Di spirit ansa, ‘I go make all di profets lie for Ahab.’
“God kon sey, ‘Make yu go deceive am, bikos e go hear yu.’ ”
22 Profet Mikaaya still sey, “Dis na how God wont make e bi. God don make dis profets lie to yu, bikos en ensef don sey, yu go si wahala!”
23 Den Profet Zedekaya wey bi Kenaana pikin, waka kom meet and slap Mikaya, den e ask am, “Since wen God Spirit leave mi kon dey tok to only yu?”
24 Mikaya ansa, “Wen yu go don hide inside yor room, den yu go know di trut.”
25 King Ahab kon orda sey, “Make una arrest and karry Mikaya go Amon wey bi di main town where Prince Joash bi govnor. 26 Una go tell dem make dem put am for prison kon gi-am bread and wota till I go kom back.”
27 Mikaya ansa, “If yu kom back alive, den God nor tok thru mi!” E still sey, “Make all of una listin to wetin I don tok!”
Ahab Die
28 Den King Ahab for Israel and King Jehoshafat for Judah kon go attack Ramot town for Gilead. 29 King Ahab tell King Jehoshafat, “As wi dey go di war so, I go shange mysef, but make yu wear yor royal robe.” So Israel king shange kon go di war.
30 Siria king don kommand en kommanders wey dey use shariot sey make dem nor attack anybody escept Israel king. 31 So wen dem si King Jehoshafat, all of dem tink sey na Israel king bi dat, so dem bigin attack am. But King Jehoshafat shaut and God help am. 32 Den Ramot sojas kon know sey e nor bi Israel king, so dem stop to attack am.
33 Leta, one Siria soja shot en arrow kon shuk King Ahab for belle. King Ahab tell di man wey dey ride en horse sey, “Dem don wound mi! Make yu turn komot for here!” 34 As dem dey fight thru-out dat day, di king just sleep for en shariot face Siria pipol. For evening wen sun don go down, di king kon die.