19
Wen King Jehoshafat for Judah rish en house for Jerusalem, Profet Jehu wey bi Hanani pikin go meet di king kon sey, “E dey good make wi help and follow wiked pipol wey hate God? Wetin yu do so, don make God dey vex for yu. But yu don still do some good tins before. Yu remove Asherah juju from di town and yu really won follow God.”
Judge
As Jehoshafat dey stay for Jerusalem, e dey follow di pipol travel from Beersheba go di hill kountry for Efraim and e dey advise dem make dem follow dia grand-grand papa God. E put judge for all di land for Judah towns wey dem dey guide. King Jehoshafat tell di judge dem, “Make una dey kareful for wetin una dey do, bikos una nor dey judge for men, but na for God wey go dey with una wen una dey make decision. Make una respet God as una dey take decision, bikos di Oga wey bi awa God nor dey like wayo, bribe or anyhow tins.”
For Jerusalem, King Jehoshafat put some Levi pipol, priest and some Israel family for Israel as God judge and to dey setol wahala. E kommand dem sey, “Make una get respet for God as una dey do una work with klean heart. 10 Wen ever una kountry man kon ripot matter give una (weda e koncern pesin wey dem kill or about di law and kommandments), make una warn dem sey make dem nor sin against God. If una nor do like dat, God go vex for una and doz wey dey work with una, but if una obey am, una go dey free.
11 “Any matter wey koncern di king, una go ripot to Amaraya wey bi di shief priest and Ishmael pikin, Zebadaya wey dey lead Judah family. Levi pipol go bi una ofisas. Make una do una work well! Make God dey with doz wey dey do well!”