20
War With Edom Pipol
Afta, Moab and Ammon pipol with some pipol from Meun kon attack Jehoshafat.
Some messenjas go tell Jehoshafat sey, “Plenty sojas dey attack yor town from di oda side for di Dead Sea for Edom side, for Hazezon Tamar wey bi En-Gedi.” Jehoshafat kon dey fear, so e go meet God. E kommand evribody for Judah sey make dem fast. Judah pipol from difren town gada togeda kom sey make God help dem.
King Jehoshafat stand for where Judah and Jerusalem pipol gada put for di kourtyard front, wey dey God Temple kon pray:
“My Oga wey bi awa grand-grand papa God, na Yu bi God wey dey for heaven and na Yu dey rule di whole world. Na Yu get all pawa and nobody fit stand against Yu. Awa Oga God, Yu porshu doz wey dey dis land before kon gi-am to yor friend Abraham and en shidren-shidren Israel, wey bi yor pipol. Dem stay di town kon build temple put as respet for Yu sey, ‘If wahala kom meet us like sojas attack us, judgement, sickness or sey food nor dey, wi go kry kon meet Yu with awa pain, so dat Yu go hear and diliver us.’
10 Naw, Ammon, Moab and pipol for Mount Seir dey kom! Wen Israel pipol komot from Egypt, Yu nor gri make dem fight dis pipol. Dem just pass and dem nor tosh dem. 11 But naw, make Yu si how dem dey pay us back. Dem dey kom drive us komot from awa land wey Yu give us! 12 Awa Oga God, Yu nor go judge dem? Wi nor get pawa rish dis plenty sojas wey dey kom attack us so o-o. Wi nor know wetin wi go do, so wi kom meet Yu make Yu help us.”
13 All di men for Judah, dia wifes and shidren kon stand for God front.
14 Den Zekaraya wey Benaya born, God Spirit kon enter en pikin Jahaziel, for all di pipol present. Na Jeiel wey Matanaya born bi Benaya papa. Dem bi Levi pipol from Asaf family.
15 Jahaziel kon sey, “Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem with Jehoshafat, make una listin! Dis na wetin God dey tok, ‘Make una nor fear, bikos of dis plenty sojas! Bikos di fight nor bi una own, but na God go fight am.’ 16 Make una go fight dem tumoro as dem dey kom Ziz. Una go si dem for one small river for Jeruel Desert front. 17 Una nor go fight for dis war. Make una just stand kon si how God go diliver una wey bi Judah and Jerusalem pipol. Make una nor fear, make una go fight dem tumoro, bikos God dey with una.”
18 King Jehoshafat kon bow and Judah pipol with doz wey dey stay Jerusalem, bow woship God. 19 Den some Levi pipol wey kom from Kohat and Korah get up kon shaut dey praiz God.
20 Di next day for early morning, dem mash go Tekoa Desert. Wen dem don ready to move, Jehoshafat kon stand sey: “Make una listin, una wey bi Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem! Make una trust di Oga una God and E go save una! Make una trust en profet words and una go win.” 21 Jehoshafat go meet en pipol kon choose doz wey go dey sing and praiz God wey dey holy. As dem dey mash go meet di sojas, dem kon dey sey,
“Make wi tank God,
bikos en love na forever and ever.”
22 As dem dey sing, na wons God attack Ammon, Moab and di men from Mount Seir wey dey kom fight Judah pipol, so Judah men win all of dem. 23 Ammon and Moab men attack di men wey kom from Mount Seir kon distroy dem. Wen dem kill Seir men finish, dem kon start to kill demsef.
24 Wen Judah men rish di war front for di desert, na only dead body, dem si for groun. 25 King Jehoshafat with en men kon go pak di sojas tins. Dem pak dia klot and many oda betta tins. E take dem like three days to pak all di tins, bikos dem plenty well-well. 26 For di fourt day, dem gada go Beraca Valley kon praiz God for der. Na Beraca Valley dem dey koll dat place till today.
27 All di men for Judah and Jerusalem kon dey happy as dem dey go Jerusalem and na Jehoshafat dey lead dem. God don give dem viktory ova dia enemies. 28 Dem enter Jerusalem with trumpet and oda tins wey dem take dey sing kon dey happy and dance go God Temple.
29 All di oda kingdom wey near dem kon dey fear God wen dem hear as E fight Israel pipol enemies. 30 So, Jehoshafat kon get peace, bikos God dey protet am for evry side.
King Jehoshafat Die
31 King Jehoshafat reign for Judah. E bi thirty-five years wen e start to rule and e rule for twenty-five years from Jerusalem. En mama na Azuba wey bi Shilhi pikin. 32 E follow wetin Asa en papa do and e dey kareful and dey do only wetin God wont. 33 But e nor still skata all di place where dem for dey serve juju and di pipol nor use all dia mind serve dia grand-grand papa God.
34 Di remainin tins wey Jehoshafat do from biginnin go rish end, dem rite am for Hanani pikin, Profet Jehu book kon put am join Israel kings history book.
35 Leta, King Jehoshafat make friend with King Ahazaya for Israel wey do many wiked tins. 36 Dem agri to make ship wen dem go take travel go Tarshish and dem make di ship for Ezion-Geber. 37 Dodavahu pikin Elieza from Maresha kon tok against King Jehoshafat sey, “Bikos yu enter agriment with King Ahazaya, God go skata wetin yu don make.” Di ship sink and e nor fit go Tarshish again.