23
For di sevent year, Priest Jehoiada kon make plan with five sojas wey bi: Zabud wey Jeroham born, Ishmael wey bi Jehohanan pikin, Zabud wey Obed born, Maaseaya wey bi Adaya pikin and Elishafat wey Zikri born. Dem travel go Judah kon gada Levi pipol wey dey di towns with Israel pipol family leaders kom Jerusalem. All di pipol wey gada, kon make kovenant with di king for God Temple.
Priest Jehoiada tell dem, “Di king pikin go rule as God promise dia family. Dis na wetin una go do. Wen dem don divide di priest and Levi pipol wey dey duty for Sabat Day, one part must dey wosh di door. Anoda part go stand for di palis gate and di oda part go dey di foundashon gate. All di pipol wey remain go stand for di kourtyard for God Temple. Make nobody enter God Temple escept di priest and Levi pipol wey dey duty. Dem fit enter bikos dia hand klean, but make di oda pipol dey outside. Levi pipol must gada round di king and evribody go hold en weapon for hand. Anybody wey won enter di temple, make una kill-am. Una must follow di king go anywhere wey e dey go.”
So Levi pipol and Judah men do as Priest Jehoiada tell dem. Di kommander gada all di men wey dey duty and doz wey nor dey duty for dat Sabat Day. Priest Jehoiada give di sojas King David spears and shields wey dey God Temple. 10 E put all di men for pozishon with dia spear for dia hand. Dem line-up from di sout go rish nort for di temple and dem stand near di altar for di temple kon gada round di king.
11 Priest Jehoiada and en sons lead di king pikin kom out with di crown and king klot wey dem wear for en body. Dem make am king kon pour oil for en head dey shaut, “Make di king live forever!”
12 Wen Atalaya hear di royal guards dey shaut and praiz di king, e kon go where di pipol gada for di temple. 13 E si di king stand near di pila for where dem take dey enter di temple. Di ofisas and doz wey dey blow trumpet stand near di king and all di pipol for di land happy dey blow dia trumpet. Doz wey dey sing, dey der with difren instrument as dem dey lead di song. Atalaya tear en klot kon dey shaut, “Dis na wayo! Dis na wayo!”
14 Priest Jehoiada koll di ofisas oga kon tell dem, “Make una karry am go outside di temple kon gi-am to di guards. Make una kill anybody wey won stop una.” Di priest do like dis, bikos e nor wont make dem kill-am for inside God Temple. 15 Dem seize Atalaya, karry am go di palis kon kill-am for di horse gate.
16 Priest Jehoiada kon make kovenant sey en with all di pipol and di king go dey obey God. 17 All di pipol kon go distroy di juju temple. Dem skata di altar with all di juju wey dey inside. Dem kill Mattan wey bi Baal priest for di altar front.
18 Priest Jehoiada put di priest and Levi pipol make dem dey work for di temple. E sey make dem do di duty wey King David give dem and burn di sakrifice wey dem give God with joy kon dey play music, just as dem rite am for Moses Law. 19 Priest Jehoiada still put guards for God temple gate, so dat doz wey dey plan bad tin against di king, nor go fit enter di temple.
20 E koll di soja ofisas, di eldas, doz wey dey rule di pipol and all di pipol for di land, den kon lead di king komot from God Temple. Dem use di gate for up take enter di palis and di king kon sidan for en throne. 21 Di pipol for di land kon dey celebrate, bikos since dem kill Atalaya, di town kon get peace.