24
King Joash
Joash na seven years wen e start to rule. E rule for forty years from Jerusalem. Na Zibaya wey kom from Beersheba bi en mama. King Joash obey God thru-out di time wen Priest Jehoiada dey alive. Priest Jehoiada choose two wife for King Joash and e get sons and dotas.
Wen e don bi king for sometaim, e kon won ripair God Temple. E gada di priest and Levi pipol kon orda dem sey, “Make una go Judah towns go kollect plenty money kom from di pipol make wi take ripair God Temple.” E sey make dem kwik-kwik kollect am, but Levi pipol nor kwik rish der.
So, di king koll Priest Jehoiada kon sey, “Wetin make yu neva tell Levi pipol make dem kollect di tax from Judah and Jerusalem pipol, just as dem rite am for God savant Moses book?”
(Atalaya wiked well-well and en sons break enter God Temple kon use all di tins wey dey der take woship Baal juju.)
Di king orda sey make dem make one box kon put am outside God Temple gate. So dem send message go Jerusalem and Judah make evribody bring di tax, wey God savant, Moses, sey make Israel pipol dey pay wen dem dey wildaness. 10 All di ofisas and di pipol kon happy as dem dey put dia silva inside di box till e full. 11 Anytime wen Levi pipol si sey di box wey di royal money dey don full, doz wey dey kount di money go remove all di money kon karry di box go back to di gate. Na so dem dey do am evriday, until dem kollect plenty money. 12 Di king and Priest Jehoiada give di money to doz wey dem sey make dem ripair God Temple. Dem hire karpenter, doz wey get handwork, doz wey dey do bronze and iron sey make dem ripair God Temple.
13 Dem work well-well kon ripair di temple. Dem follow as di measurement bi for di temple kon do am like dat. 14 Wen dem don finish, dem karry di silva wey remain go give di king and Priest Jehoiada. Dem use am make difren tins for God Temple: tins wey dem take dey serve God for di temple; tins to take burnt sakrifice; pans with oda tins wey dem use gold and silva take make. Wen Priest Jehoiada dey alive, dem dey always burnt sakrifice for di temple.
15 Priest Jehoiada old well-well and e die wen e bi one hundred and thirty years. 16 Dem beri am for David Town with di oda kings, bikos e do good tins for Israel and for God Temple.
17 Wen Priest Jehoiada don die, Judah leaders kon visit di king, bikos of dia respet for Jehoiada. Di king kon listin to dia advise. 18 Dia Oga wey bi dia grand-grand papa God, dem leave en temple kon bigin woship Asherah and difren juju. Bikos of dia sin, God kon dey vex for Judah and Jerusalem pipol. 19 God send profet go meet dem, so dat dem go turn back kom meet am. Dem warn dem well-well, but dem nor gri listin.
20 God Spirit kon enter Zekaraya wey bi Jehoiada pikin. E stand up kon tell di pipol, “Dis na wetin God tok: ‘Why una nor dey obey God kommand? Una nor go prosper and God don rijet una, bikos una nor gri obey am!’ ”
21 Dem plan kon stone Zekaraya die for God kourtyard. 22 Di king forget di love wey Priest Jehoiada wey bi Zekaraya papa show am kon kill en pikin. Wen Zekaraya dey die, e shaut kry sey, “Make God si and ponish una for dis tin wey una dey do!”
23 As di year dey start, Siria sojas attack Judah and Jerusalem kon karry many tins go Damaskus. 24 Even doh Siria sojas small, God let dem win Judah sojas, bikos dem don turn from en wey bi dia grand-grand papa God. Like dis, God kon ponish King Joash. 25 Dem wound am well-well. So wen dem don fight finish, den two of en ofisas kon plan and kill-am for en bed, bikos of Zekaraya wey e kill. Dem beri am for David Town, but nor bi for di royal beri groun.
26 Doz wey plan against am na, Zabad wey one Ammon woman, Shimeat born and Jehozabad wey one Moab woman, Shimrit born. 27 King Joash sons names, di tins wey dem profesai against Joash and as e take build God Temple again, dem rite am put for di kings book. Amazaya en pikin kon take-ova as king.