7
Solomon Dedikate Di Temple
Wen Solomon don pray finish, fire kom down from heaven kon burn di ofrin and di sakrifice, den God present kon full inside di temple. Di priests nor fit enter God Temple, bikos God present full der. Wen evribody for Israel si sey fire kom down and God present full di temple, dem knee down kon face groun. Dem kon dey woship and tank God dey sey,
“True-true, God dey good;
en love wey nor dey fail,
go dey forever!”
Di king and di pipol kon offa sakrifice give God. King Solomon sakrifice 22,000 kattle and 120,000 sheep. Den en and all di pipol dedikate God Temple. Di priests stand for where dem put dem, plus all di Levi pipol wey dey play music to take praiz God. (Dis na di tins wey King David make to take give God tanks and David dey use dem wen ever e dey praiz God sey, “True-true, yor love dey with us forever.”) Di priest stand near Levi pipol dey blow di trumpets, while evry oda tribe for Israel, stand dey praiz God.
Solomon santify di kourtyard centre wey dey God Temple front. Di burnt sakrifice, di korn ofrin and di fat part for di peace ofrin, e offa dem for der, bikos di bronze altar wey Solomon make, too small to kontain all di ofrins.
For dat time, Solomon and Israel pipol celebrate for seven days. Pipol from Hamat for nort go rish Egypt wotaside for sout, still dey join dis pipol too. For di eight day, dem gada evribody togeda, bikos dem don dedikate di altar for seven days kon celebrate for anoda seven days. 10 For di twenty-third day for di sevent mont, Solomon kon tell all di pipol make dem dey go dia house. Dem happy well-well as dem dey go, bikos of di good tins wey God don do for David, Solomon and Israel pipol.
God Tok To Solomon
11 Afta Solomon don build God Temple, di royal palis and evritin wey e plan for God Temple and en royal palis finish, 12 God appear to am for nite kon sey:
“I don ansa yor prayers kon choose dis place as my temple where dem go for dey make sakrifice.
13 Wen I klose di sky so dat rain nor go fall, or kommand lokust make dem distroy di plant for di land, or kause betta wahala and diziz, 14 if my pipol go honbol demsef kon pray to mi and turn from dia sins, I go hear and ansa dem from heaven kon forgive dia sins, den heal dia land. 15 I go listin and ansa dia prayers wey dem go pray for dis place. 16 I don choose and santify dis temple, so dat e go bi my permanent house; I go always dey here.
17 Yu must serve mi, just as yor papa David do. Make yu do evritin wey I kommand and obey my rules well-well. 18 Den I go make yor shidren rule forever, just as I promise yor papa David sey, ‘Yu go always get pikin wey go rule ova my pipol, Israel.’
19 But if yor pipol turn from mi kon dey disobey di rules and kommand wey I sey make dem keep and dem kon dey serve anoda god, 20 I go remove dem from my land wey I give dem; I go forget dis temple wey I santify with my present kon make pipol laf and fool dem among all di nashon. 21 But for dis temple, wey bin dey good and okay, evribody wey dey pass am go shok kon sey, ‘Wetin make God do like dis to dis land and dis temple?’ 22 Odas go ansa sey, ‘Na bikos dem nor obey di Oga wey bi dia grand-grand papa God; di One wey take dem komot from Egypt. Dem dey serve and woship oda god with all dia mind. Na dis make God dey ponish dem like dis.’ ”