8
Solomon Reward
Twenty years afta Solomon don build God Temple and en royal palis, e ribuild di town wey Hiram gi-am kon put Israel pipol for der. E go Hamat-Zoba kon seize am. E build Tadmor for di wildaness and all di towns wey dem for dey keep tins wey E build for Hamat. Di Uppa Bet-Horon and di Lowa Bet-Horon, Solomon make di towns strong with walls and iron gates and e build Baalat. Na en get all di towns where dem for dey keep tins, plus di town where dem keep shariot and ordinary horse put. E build anytin wey e wont for Jerusalem, Lebanon and evriwhere for en kingdom.
For dis time, many pipol wey nor bi Israel pipol still dey di land afta Joshua don win Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol. Dia shidren-shidren still dey di land (Israel pipol nor fit porshu all of dem komot from di land). So, Solomon kon use dem take dey do en work and na savant dem bi till today. Solomon nor give Israel pipol dis kind work, bikos na dem bi sojas, ofisas, doz wey dey ride shariot and doz wey dey kommand di sojas. 10 Dis pipol so, dey work for Solomon as supavisor; dem bi 250 wey dey supavise dis pipol.
11 Solomon karry Fero dota from David Town go di palis wey e build for am kon sey, “My wife nor go stay for di palis wey bi Israel king, David own, bikos di place where di Kovenant Box enter, dey holy.”
12 Den Solomon offa sakrifice give God on-top di altar wey e build for di temple front. 13 E do evritin for di sakrifice, just as Moses tok about Sabat Day, New Moon festival and di three celebrashon wey dem dey do wey bi: Bread Wey No Get Yist Feast, Di Week Feast and Di Shelta Feast. 14 As en papa David tok, Solomon choose difren priests to do difren tins. E choose Levi pipol wey go dey lead woship and help di priest for dia work evriday and doz wey dey guide di gate. Dis na wetin David, God savant tok. 15 Dem do evritin wey di king orda koncerning di priest, Levi pipol and di propaty dem.
16 All di work wey Solomon sey make dem do, rite from di day wey dem lay di foundashon for God Temple until dem finish am, dem do all komplete. So, dem kon finish all di work for God Temple.
17 Den Solomon go Ezion-Geber, before e kon go Elat wey dey Edom wotaside. 18 Hiram send sheep and some pipol wey sabi kontrol sheep go meet am. Men wey know how to drive for sea. Dem drive with Solomon men go rish Ofir kon take 450 gold from der, den dem bring am kon give King Solomon.