11
Di Two Witness
Den, dem give mi one ruler wey bi like walkin stik kon tell mi sey, “Get up make yu measure God Temple, di altar and di pipol wey dey woship for der. But nor measure di temple varanda, bikos God don gi-am to Gentile pipol and dem go mash am for forty-two monts.” I go give my two witness authority to profesai for 1,260 days and na sak klot dem go wear. Na dem bi di two olive tree and di two lampstand wey stand before di Oga God wey get di eart. If anybody dey plan bad for dem, fire go kom out from dia mout kon burn dia enemy finish. And if any man dey plan bad for dem, na so too E go take die. Dis two men get di pawa to klose di sky, so dat rain nor go fall as dem dey profesai. Dem still get di pawa to turn wota to blood and to kause bad tins to happen for di eart. And wen dem don tok finish, di beast wey kom out from di pit go follow dem fight kon win and kill dem. Dia dead body go dey for di main street for Jerusalem wey pipol dey koll “Sodom and Egypt” and dis na di town where dem for nail Christ for cross. And for three and half days, all di pipol, tribes, language and nashons go dey look dia dead body. Dem nor go allow anybody beri dem. 10 Sinnas go dey happy bikos of dem and dem go dey give gift to each oda to celebrate di two profet deat, bikos di profets trobol dem well-well. 11 Afta di three and half days, God go breath life enter dia body and dem go wake-up! Fear go katch all doz wey dey look dem. 12 Den one loud vois from heaven go tell di two profet, “Make una kom up!” And dem go-go heaven inside kloud as dia enemies go dey look dem. 13 For dat same time, betta eartkweke go happen and if dem divide di town into ten, one part go distroy finish. 7,000 pipol go die for di eartkweke and evry oda pesin go fear kon bigin tank God wey dey heaven.
14 Di sekond deat don pass, but si, di third one go soon kom.
Di Sevent Trumpet
15 Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven:
“All di kingdom for di world
don bi God and Christ own.
E go rule forever and ever.”
16 Di twenty-four eldas wey sidan for di throne before God, go fall face groun kon woship God. 17 And dem go sey:
“Awa Oga God wey dey mighty,
wi dey tank yu.
Di one wey dey since and wey go always dey,
bikos naw, yu don show yor pawa kon start to rule.
18 Di nashons dey vex,
but di time wey yu go ponish dem,
don rish.
And na naw yu go judge doz
wey don die
kon reward yor savants;
di profets; doz wey dey good
and evribody wey dey fear yor name,
both small and big.
Dis na di time to distroy doz
wey dey kause wahala for di eart.”
19 Den for heaven, God Temple kon open and en Kovenant Box dey inside di temple. Tonda kon dey make nois and spark, den strong eartkweke happen and big-big ice-blok kon dey fall.