12
Di Woman, Di Pikin And Di Dragon
Den one big sign kon appear for heaven: I si one woman wey take sun tie en body like klot, di moon dey under en leg and one crown with twelf stars, dey for en head. Di woman get belle and e dey kry well-well, bikos e won born naw. Den I si anoda sign for heaven: I si one big red dragon with seven heads and ten horns and seven crowns, dey di heads. If dem divide di sky into three, di dragon tail swip one part komot kon trow dem kom di eart. E stand for di woman front as e won born and e dey wait to kill di pikin wey di woman won born. Di woman born boy wey go rule di world with strong hand. But dem take di pikin kon go gi-am to God for en throne. So di woman run enter di wildaness, di place where God don prepare to kare for am for 1,260 days.
Den big fight kon happen for heaven. Mikael and en angels kon fight against di dragon and en angels. Mikael and en angels win di fight, so dem kon porshu di dragon and en angels komot from heaven by force. Dis dragon na di old snake wey bi di devil or Satan, wey dey deceive di world. Dem trow am kom down from heaven with en angels. 10 Den I hear one loud vois for heaven dey sey, “Salvashon; pawa; authority wey Christ get and God kingdom, don kom at last. Bikos di pesin wey dey akuiz awa brodas and sistas evriday, God don trow am kom down. 11 God pipol don win Satan with di Lamb blood and with di word wey dem tok about Christ. Dem nor too kare for dia life, so dem even dey ready to die. 12 So, heavens make yu happy! But wahala go happen for di eart and sea, bikos di devil don kom meet una with strong vexnashon and en time too short.”
13 Wen di dragon know sey dem don trow am go di eart, e porshu di woman wey born di boy. 14 But dem give di woman two feada like eagle own, so dat e go fly go di place where dem prepare for am for wildaness. For der, dem go kare for am kon protet am from di dragon for three and half years. 15 Den di dragon try to kill di woman with plenty wota wey e spit kom out from en mout. 16 But di eart help di woman bikos e swallow di wota wey kom out from di dragon mout. 17 Di dragon dey vex for di woman, so e kon decide to fight all di shidren wey di woman born, dat is, evribody wey keep God kommandment and bilive Jesus Christ. 18 Den di dragon stand near di sea.