21
New Heaven And Eart
Den I si new heaven and new eart. Di first heaven and eart nor dey again and di sea vanish. And I si di holy town, di new Jerusalem, dey kom down from heaven from God and dem dress am like woman wey won go meet en husband. And I hear one loud vois from di throne dey sey: “Make yu look! God house don dey with human being naw. E go stay with dem and dem go bi en pipol. God ensef go dey with dem. E go klean evry tears from dia eye and deat nor go dey again. To dey mourn, kry and pain nor go dey again, bikos di tins wey dey before, don vanish.”
And di Pesin wey sidan for di throne kon sey: “Make yu look! I dey make evritin new!” Den E kon tell mi, “Make yu rite all dis tins, bikos dis word na word wey pipol fit trust and na true.” E still tell mi, “God don do am finish! Na mi bi di Alfa and Omega, di startin and di ending. Anybody wey dey hongry for wota, I go gi-am wota wey dey give life and e nor go pay. Di pesin wey win, go inherit dis tins. I go bi en God and e go bi my pikin. But for pipol wey fear nor dey let dem do wetin good; doz wey nor bilive mi, doz wey nor dey obey mi; doz wey kill odas; pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey do majik; pipol wey dey serve juju and evribody wey dey tok lie, na inside di fire and sulfur dem go-go. And na dat bi di sekond deat.”
Di New Jerusalem
Den one for di seven angel wey bin whole di seven basin wey di seven last ponishment full, waka kon tell mi sey, “Make yu kom, so dat I go show yu di woman wey won marry; di Lamb wife!” 10 So for di vishon, di angel karry mi go one big fine mountin and e show mi di holy town, di new Jerusalem as e dey kom out from heaven from God. 11 Di town get God glory and di way e dey shine, bi like stone wey dear; like jasper stone wey dey shine. 12 E get big wall wey high with twelf gate and dem rite di twelf tribes for Israel put. 13 Three gate dey for di east side, three dey for di nort, three dey for di sout and three dey for di west side. 14 Di town wall get twelf foundashon and dem rite di Lamb twelf apostle name put for di twelf foundashon.
15 Di angel wey tok to mi, whole ruler for hand wey e go take measure di town, en foundashon stone and di wall. 16 Dem build di town like skware and as e long rish, na so e still wide rish too. E measure di town with di ruler and na 1,000 for hundred mile e bi (as e long rish, na so e still wide and high rish, all of dem dey ekwol). 17 E still measure di wall and na one hundred and forty-four cubit e bi and na as human being dey measure, naim di angel take measure. 18 Na jasper dem take make di town wall and na pure gold wey klear like glass, dem take make di town ensef. 19 Dem take difren stone wey dear take design di wall. Di first foundashon stone wey dem use na jasper, den safaya, agate, emerald, 20 onyx, karnelian, chrysolite, beryl, topaz, krisoprase, jacint and ametist. 21 Di twelf gate for di town na twelf stones wey dear. Dem make each gate with one stone! Na pure gold wey klear like glass dem take make di town main road.
22 I nor si any temple for di town, bikos Oga God, di one wey get all pawa and di Lamb, na dem bi di temple. 23 Di town nor nid sun or moon to shine, bikos God glory dey shine put and na di Lamb bi en lite. 24 Na di town lite go show pipol road and di kings wey dey for di world go bring evritin wey dem get kom inside. 25 Dem nor go ever klose di gate for day (and nite nor go dey der). 26 Dem go take evritin wey di nashons get enter di town. 27 But know dirty or yeye tin go ever enter di town. Pesin wey dey do bad or dey lie, nor go ever enter der, but di pipol wey go enter, na only doz wey dem rite dia name for di Lamb Life Book.