22
River Wey Dey Give Life
Den di angel show mi di river wey dey give life. Di river klear like crystal and e dey pour kom from God and di Lamb throne. E dey rush pass di town main road. For each side for di river, di tree wey dey give life dey bear twelf fruit and e dey bear one evry mont. Di leaf for di tree na to heal evry nashon for di world. Anytin wey God don swear for, go vanish. God and di Lamb throne go dey for dat town and en savants go woship am for der forever. Dem go si en face and en name go dey dia fore head. Nite nor go dey again and dem nor nid lantan or sun lite, bikos God go bi dia lite and dem go rule forever and ever with am.
Jesus Go Kom
Den di angel tell mi, “Pipol fit trust dis word bikos na true. God wey bi di profets spirit Oga God, don send en angels kon show en savants wetin go soon happen.”
(Si! I go soon kom!
God don bless di pesin wey go obey di profesy wey dey dis book.)
Na mi, John, hear and si dis tins. Wen I hear and si dem, I bow for groun to woship di angel wey dey show mi dis tins. But e tell mi, “Nor do like dat! I bi savant like yu, like yor brodas di profets and doz wey go obey di words wey dey dis book. So make wi woship only God!” 10 Den e tell mi, “Nor klose di words wey dey dis book, bikos di time don near. 11 Make di pesin wey dey do bad, kontinue to dey do bad and doz wey get dirty life must kontinue to live like dat. Di pesin wey dey do wetin good for God eye, make e kontinue to do am and di ones wey dey holy, must kontinue to dey holy.”
12 (Si! I go soon kom
and my reward dey with mi.
I go pay evribody
akordin to wetin dem don do!
13 Na mi bi di Alfa and Omega,
di First and di Last,
di Startin and di Ending!)
14 God don bless doz wey wosh dia klot klean, so dem go get authority to chop from di tree wey dey give life and dem go fit pass di gate enter di town. 15 Pipol wey dey do like dogs, doz wey dey do majik and kill odas; doz wey dey serve juju and dey like to lie, all of dem nor go enter di town.
16 “Mi, wey bi Christ, I don send my angel make e kom tell di pipol for di church di trut about dis tins. I kom from David family and na mi bi di brite Star wey dey shine for morning!” 17 Di Spirit and di Bride sey, “Kom!” Make di pesin wey hear sey, “Kom!” And anybody wey wota dey hongry, make e kom; di pesin wey wont di wota wey dey give life, make e drink from am free of sharge.
18 I dey warn evribody wey dey read di profesy wey dem rite for dis book: If anybody add join wetin dey dis book, di wahala wey dey dis book, God go add am join en life. 19 And if anybody remove any word from dis profesy book, wetin suppose bi en own for di tree wey dey give life and for di holy town wey dem diskribe for dis book, God go take am from am.
20 Di Pesin wey dey tok dis tins, know sey dis tins na true. Jesus Christ sey, “True-true, I go soon kom!” Amen! Oga God Jesus, make yu kom! 21 Make Oga God Jesus Christ grace dey with all of una. Amen!