4
Woship For Heaven
Afta all dis tins, I look up kon si one door wey open for heaven! Den di vois wey I first hear kon tok to mi like loud trumpet sey: “Make yu kom up, so dat I go show yu wetin go happen afta dis tins.” So for di vishon, I si one throne for heaven wey pesin sidan put! Di pesin wey sidan for di throne bi like jasper and karnelian stone. Rainbow dey round di throne and e bi like sey dem make am with emerald stone. Twenty-four oda thrones dey round di first throne and twenty-four eldas sidan put for di thrones. Dem wear white klot and gold crown dey dia head. Lite dey shine kom out from di throne and tonda dey make nois from am too. For di throne front, seven tosh wey get fire dey burn for der. Dis na God seven spirit. Di throne front dey shine like mirror and e bi like crystal. For centre and around di throne, for creatures wey get eye full body, dey for der too.
Di first one bi like lion, di sekond one bi like melu, di third one get human being face and di fourt one bi like eagle. Each for di for creatures get six feada and eye full di feadas. Dem nor dey ever rest for nite or day and dem dey always sey:
Holy! Holy! Holy! Na-im bi di God wey dey mighty.
Di Pesin wey dey since, wey dey naw and wey go soon kom.
Wen ever di for creatures dey tank, praiz and honor di Pesin wey sidan for di throne wey dey alive forever and ever, 10 di twenty-four eldas go bow woship di Pesin wey dey live forever and ever. Dem go remove dia crown put for en throne front kon sey:
11 “Awa Oga and God! Yu dey worthy
to receive glory, honor and pawa,
bikos na yu kreate evritin as yu wont.”