5
Wen Dem Open Di Book
Den I si sey di Pesin wey sidan for di throne, hold one book for en rite hand. Dem rite sometin put for di front and back kon lock am with seven keys. Den I si one strong angel dey shaut with loud vois sey: “Na who dey holy rish to break di keys and open dis book?” But nobody for heaven, eart or under eart fit open di book or look inside. So I start to kry, bikos nobody dey holy rish to open di book or look inside. Den one among di eldas kon tell mi, “Make yu nor kry again! Look, di lion for Judah tribe, wey kom from David family, don win. So e go open di book and break di seven keys.”
Den I si one Lamb wey bi like sey dem don kill-am, but e stand for di throne centre with di for creatures and di twenty-four eldas. E get seven horns and seven eyes wey bi God seven spirit, wey E send enter di eart. Den e waka go kollect di book from di Pesin wey sidan for di throne. And wen e take di book, di for creatures and di twenty-four eldas fall for di Lamb front. Each of dem whole harp and basin wey incense full. Dis incense na God pipol prayers. Dem kon dey sing new song sey:
“Yu holy rish to take di book
kon open di keys,
bikos dem kill yu
and na yor blood save all God pipol
from evry tribe, language, group and kountry.
10 Yu don choose dem as kings and priests
wey go serve God and dem go rule for di eart.”
11 As I dey look, I kon hear many tazon angels vois as dem stand round di throne; di for creatures and di eldas. 12 All of dem kon dey sing with loud vois sey:
“Di Lamb wey dem kill,
make glory, pawa, propaty,
wisdom and honor, bi en own!”
13 Den I hear evritin wey God kreate for heaven, eart, under eart, sea and evritin wey dey inside dem dey sing sey:
“Make praiz, honor, glory and pawa to rule,
bi di Pesin wey sidan for di throne
and di Lamb own, forever and ever!”
14 And di for creatures kon sey, “Amen!” Den di eldas fall face groun kon start to woship God.