8
Di Sevent Key
Wen di Lamb open di sevent key, evriwhere for heaven kon kwayet for like thirty minutes. Den I si seven angels wey stand for God present and E give dem seven trumpets. Den anoda angel whole gold plate for hand kon stand near di altar. And God sey make e mix many incense join God pipol prayers and e go bi ofrin before di gold altar. Di smoke from di incense, plus God pipol prayers kon dey go up go meet God from di angel hand. Di angel take di basin wey dem dey burn incense put kon pak fire full am from di altar, den e trow am kom di eart and tonda with strong lite and heavy eartkweke kon happen.
Di Seven Trumpets
Di seven angels wey whole di seven trumpets dey ready to blow dem.
Di first angel blow en own and dem kon trow stone with fire wey mix with blood kom di eart. So if dem divide di eart into three, one part burn finish. And if dem divide di trees wey dey di eart into three, one part with all di green grass, burn finish too.
Den di sekond angel blow en trumpet and dem trow mountins wey fire dey, enter di sea. If dem divide di sea into three, one part kon turn to blood. And wen dem divide evritin wey get life for di sea into three, one part die finish. Den wen dem divide all di ship for di world into three, one part burn finish too.
10 Den di third angel blow en trumpet and one big star from di sky fall kom from heaven like tosh wey dey bring fire. Wen dem divide evritin for di river into three, e fall for one part. 11 Di star name na “Bitterness.” So if dem divide di wota into three, one part betta and di wota kon kill pipol wey drink from am.
12 Den di fourt angel blow en trumpet and wen dem divide di sun, moon and stars into three, dem fall for one part and di part kon dark. So if dem divide day and nite into three, one part for di day nor get sun again and one part for di nite, moon and star nor kon dey shine again. 13 Den I look and I hear one eagle dey shaut as e dey fly for sky, “E go bad well-well! E go bad well-well! E go bad well-well for pipol wey dey dis eart, bikos of wetin go happen wen di last three angels go blow dia trumpets.”