7
Di 144,000 Pipol
Den, I si for angels stand for di for korna for di eart and dem whole di for breeze, so dat e nor go blow for di eart, di sea or for any tree. Den I si anoda angel dey kom down from di east. E karry God key, den e kon shaut give doz for angels wey dem don give pawa to ponish land and sea sey, “Make una wait! Make una nor ponish di land, sea or di trees, until wi don put God mark for en savants fore head.” Den I hear di nomba wey dem put God mark for dia fore head. Dem bi 144,000 from all di tribes for Israel:
Dem mark 12,000 from Judah tribe, 12,000 from Reuben tribe, 12,000 from Gad tribe.
And from Asher tribe, na 12,000 dem mark, 12,000 from Naftali tribe, 12,000 from Manasseh tribe,
12,000 from Simeon tribe, 12,000 from Levi tribe, 12,000 from Issakar tribe,
12,000 from Zebulun tribe, 12,000 from Josef tribe and 12,000 from Benjamin tribe.
Afta all dis tins, I look up kon si crowd wey nobody fit kount. Dem kom from difren tribe, kountry, group, language and dem stand for di throne and di Lamb front. Dem wear white klot kon whole palm tree branches for hand 10 dey shaut sey:
“Awa God wey sidan for di throne and di Lamb,
na yu get pawa to save pipol!”
11 And all di angel stand round di throne; di eldas and di four creatures. Dem fall face groun kon bigin woship God. 12 Dem kon dey sey:
“Make praiz, glory, wisdom,
tanks, honor,
authority and pawa
bi awa God own forever and ever. Amen!”
13 Den one for di eldas kon ask mi sey, “Dis pipol wey wear long white klot so, where dem from kom?” 14 I kon ansa, “My oga, na yu know di ansa.” Den e sey, “Dis pipol die bikos of Christ. Dem don use di Lamb blood take wosh dia klot, naim make am white like dat! 15 Dis na why dem stand for God throne front kon dey serve am for en Temple, both for nite and day time. 16 Hongry nor go ever katch dem again. Dem go always get wota to drink; sun nor go ever beat dem again. 17 Bikos di Lamb for di throne, go bi dia Shepad. E go take dem go drink from di river wey dey give life. And evry tears wey dey dia eyes, God go klean am komot.”