13
Saul Fail God
Saul na thirty years wen e start to rule; e rule for more dan forty years.
Saul selet 3,000 men from Israel for ensef. 2,000 from di men, dey with Saul for Mikmash and for Bethel kountry for di hill; while di remainin 1,000 dey with Jonatan for Gibeah for Benjamin. E kon send di rest pipol go house.
Leta, Jonatan kill Filistia sojas for Gibeah and all Filistia pipol kon hear about am. Den Saul blow trumpet take koll all di Hibru pipol make dem kom fight. Israel pipol hear sey Saul don kill Filistia sojas wey gada for Gibeah and Filistia pipol kon hate dem. So all Israel pipol kon go join Saul for Gilgal.
Filistia pipol gada to fight Israel pipol; dem get 3,000 shariot, 6,000 men for horse and dia sojas plenty like san-san wey dey wotaside. Dem kon go kamp for Mikmash wey dey di east side for Bet-Aven. Dem attack Israel pipol well-well and Israel sojas kon run go hide for di kaves, holes, inside rocks, pits and wells; some run cross Jordan River kon enter Gad and Gilead aria.
Saul still dey Gilgal and di pipol wey dey with am, don dey fear. E wait Samuel for der for seven day, just as Samuel don tell am, but Samuel neva still kom Gilgal. So di sojas kon dey run leave Saul. So Saul sey, “Make una karry di burn ofrin and di peace ofrin kom.” Den e kon do burnt ofrin. 10 Wen e don do di ofrin finish, Samuel kon kom. Saul kon go outside go greet am.
11 But Samuel sey, “Wetin yu don do so?”
Saul ansa, “Wen I si sey di sojas don dey run leave mi and yu neva kom for di time wey yu suppose kom and I hear sey Filistia pipol don gada for Mikmash, 12 I kon sey, ‘Filistia pipol go kom meet mi for Gilgal and I neva ask God make E favor us.’ So I kon do di ofrin.”
13 Den Samuel tell Saul, “Na foolish tin yu don do so o-o! Yu nor obey di kommandment wey di Oga yor God give yu. If to sey yu obey, God for make yu king for Israel forever. 14 But naw, yor kingdom go end. Bikos yu nor obey am; God go fine di kind pesin wey E wont kon make am king wey go rule en pipol.”
15 Den Samuel go Gilgal and from der to Gibeah for Benjamin. Saul shek di sojas wey still dey with am and dem bi like six hundred.
16 So Saul, en pikin Jonatan and di sojas wey dey with am kon kamp for Gibeah for Benjamin, while Filistia pipol kamp for Mikmash. 17 Filistia sojas divide dia kamp into three group. One group face di road wey dem dey pass go Ofrah for Shual land; 18 anoda group face di road wey go Bet-Horon and di last group kon dey waka go di road wey go di borda where dem for dey si Zeboim Valley for di desert side.
19 E nor get anybody wey fit do iron work for Israel, bikos Filistia pipol nor wont make Israel pipol dey make swods and spears. 20 So wen Israel pipol wont sharpen or do any knife, den must go do am for Filistia pipol land. 21 Di money wey dem dey pay na one koin to sharpen axe and ripair shepad stik, den two koin to sharpen big and small hoes.
22 So wen di war start, na only Saul and en pikin get swod and spear, no oda soja for Israel karry swod or spear.
Jonatan Start Di Fight
23 Filistia pipol kon send some sojas make dem go block Mikmash road.