14
One day, Saul pikin, Jonatan kon tell en savant wey dey karry en tins, “Make wi go Filistia sojas kamp wey dey di oda side.” But e nor let en papa know.
Saul sidan for outside for Gibeah under one tree wey en fruit bi like gold for Migron. Di sojas wey dey with am na about six hundred. (Di priest wey wear di priest garment na Ahijah wey bi Ahitub broda Ikabod pikin and na Finehas wey Eli di priest for Shiloh born, na-im bi Ahitub papa.) Di men nor know sey Jonatan don leave dem.
For Mikmash road wey Jonatan must pass before e rish Filistia sojas kamp, two big rock dey der for each side: dem dey koll one Bozez and di oda one na Seneh. Di rock wey face nort dey near Mikmash and di oda one wey dey sout dey near Gibeah.
Jonatan kon tell en savant, “Kom make wi go di oda side go meet all dis men wey dem nor sekonsaiz. May bi God fit fight for us. Nor-tin go fit stop God to save us, weda dem many or small.”
Di savant ansa, “Make yu do evritin wey dey yor mind. Do as yor mind dey tell yu. I dey with yu go rish di end.”
Jonatan kon sey, “Okay! Wi go-go fight doz men. If dem sey, ‘Make una wait, wi dey kom meet una’, wi go stay for der until dem kom. 10 But if dem sey, ‘Make una kom’, wi go-go meet dem. Bikos like dat, wi go know sey God go help us and na dis go bi di sign to us.”
11 Wen Jonatan and en savant kon let Filistia sojas know sey dem dey around, Filistia pipol kon sey, “Si! Hibru pipol dey kom out from di hole wey dem hide put.” 12 Den Filistia sojas wey dey for Mikmash road kon tell Jonatan and en savant, “Make una kom meet us, so dat wi go show una pepper!”
Den Jonatan kon tell en savant, “Make yu follow mi for back, bikos God don give dis men to Israel!”
13 Jonatan and en savant kon waka go with dia belle for groun. E attack all Filistia sojas for der and en and en savant kon kill dem. 14 For di first fight, Jonatan and en savant kill about twenty men and di aria big rish half-akar land.
15 Den fear kon katch di remainin Filistia sojas wey dey di kamp, field and evriwhere. Dem fear and di eart kon dey shake. Na God kause dis fear.
16 Saul men wey dey wosh for Gibeah for Benjamin kon si as all Filistia sojas dey run anyhow. 17 So Saul kon tell di soja wey dey with am, “Gada evribody make wi si who nor dey here with us.” Wen dem gada di sojas, Jonatan and en savant nor dey der.
18 So Saul tell Profet Ahijah, “Go bring di efod kom here.” (Bikos for dat day, Ahijah karry am for di sojas front.) 19 As Saul dey tok to di priest, di fear for Filistia pipol kamp dey strong more-more. So Saul kon tell di priest, “Time nor dey to ask God!”
20 Den en and en men kon mash dey go fight Filistia pipol wey don dey fear and kill each oda with swod. 21 Hibru pipol wey don first go fight Filistia pipol before, kom out kon join Israel pipol wey dey with Saul and Jonatan. 22 Wen all Israel pipol wey dey hide for Efraim kountry for hill hear sey Filistia pipol dey run, demsef kon kom out bigin porshu dem. 23 So God kon save Israel pipol dat day and di fight kontinue go rish Bet-Aven.
Jonatan Go Against En Papa
24 Naw, di men for Israel don dey hongry, bikos Saul make dem swear sey: “E nor go betta for any man wey go chop food before evening! Make nobody chop anytin until I don revensh my enemies!”
So nobody chop anytin 25 even doh sey dem si honey full groun wen dem enter di forest. 26 Di honey dey rush like wota, but nobody try to chop from am, bikos dem dey fear di swear wey dem make. 27 But Jonatan nor hear about di swear wey en papa and di sojas swear. E kon take di rod wey dey en hand take pak di honey. Wen e chop am, en body kon fresh. 28 Den one soja kon tell am, “Yor papa make all di sojas dem swear sey, ‘E nor go betta for any man wey go chop food today!’ Dis na why di sojas dem don taya.”
29 Den Jonatan ansa, “My papa don kause wahala for di land. Si as my body just fresh wen I taste only small for di honey. 30 True-true, if to sey di sojas chop some for Filistia pipol food, yu nor know sey wi for fit kill dem well-well?”
31 Dat day Israel sojas kill Filistia pipol from Mikmash go rish Aijalon and dem kon taya. 32 So di sojas kon rush with honga, bigin kill both sheep, kattle and melu. Dem kill dem kon chop di animal, di blood and evritin. 33 So dem kon tell Saul wetin dey happen, “Si, di sojas don sin against God as dem dey chop evritin plus blood sef.”
Saul kon sey, “All of una don break di kovenant! So make una roll one big stone kom here.” 34 Den e kon kommand: “Make una go tell di pipol make all of dem bring dia animals kom here. Dem go kill-am chop for my front; but make dem nor chop di blood, so dat God nor go vex for dem.” So for dat nite, all of dem kon bring dia animal kill and chop for der. 35 Den Saul build one altar for God and dis na di first time wen e dey build altar for God.
36 Saul kon sey, “Make wi go porshu Filistia pipol for nite; wi go kill dem until day go break and make wi nor sorry for anybody.”
Di sojas ansa, “Make yu do wetin yu like.”
But di priest kon sey, “Make wi ask God first for here.”
37 So Saul ask God, “Make wi porshu Filistia pipol? Yu go give dem to us?” But God nor ansa am dat day.
38 Den Saul sey, “Una wey bi di sojas oga, make una kom. Make una find out who make di pipol sin today. 39 Bikos as long as God wey save Israel dey alive, even if na Jonatan my pikin kause am, e must die today!” But nobody for di sojas tok anytin.
40 Den e kon tell di sojas, “Una go dey dis side, why mi and my pikin Jonatan go dey di oda side.”
Di sojas ansa Saul, “Make yu do wetin yu know sey dey good.”
41 Den Saul sey, “My Oga wey bi Israel God! Wetin make Yu neva ansa mi today? Ansa mi with di holy stone. If na mi or my pikin kause dis sin, den make Yu ansa by Urim; but if na yor pipol kause am, make Yu ansa by Tummim.” Den God pick Saul and en pikin thru dice wey dem trow and Israel pipol kon dey save. 42 Den Saul kon sey, “Make una trow di dice for mi and my pikin.” Wen dem trow am, e kon katch Jonatan.
43 So Saul tell Jonatan, “Tell mi wetin yu do.”
Jonatan kon tell am, “I use my rod take taste small for di honey. I must die!”
44 Saul kon sey, “Make God ponish mi well-well, if I nor kill Jonatan!”
45 But di sojas sey, “Make Jonatan wey win dis war for Israel, die? E nor go ever happen! As long as God dey alive, one hair for Jonatan head nor go even fall rish groun! Bikos na with God help, e take do wetin e do today.” So di sojas nor let dem kill Jonatan.
46 Den Saul stop to porshu Filistia pipol and dem kon go back to dia house.
47 Afta Saul don bikom Israel king, e fight all dia enemies wey dey round dem wey bi: Moab, Ammon and Edom pipol, Zobah king and Filistia pipol. Anywhere e for go fight, God dey make am win. 48 E do great tins kon kill all Amalek pipol, den save Israel pipol from dia enemies hand.
Saul Family
49 Saul pikin dem name na Jonatan, Ishvi and Malki-Shua. E get two girls; di senior one na Merab, while di yonga one na Mikal. 50 Saul wife name na Ahinoam wey bi Ahimaaz pikin. Di oga for Saul sojas na Abner wey bi Ner pikin and Ner na Saul papa broda. 51 Na Abiel born Kish wey bi Saul papa and Ner wey bi Abner papa.
52 All di time wen Saul dey alive, e always dey fight with Filistia pipol. So wen ever Saul si pesin wey strong and get mind, e go add am join en sojas.