4
Filistia Pipol Karry Di Kovenant Box
Den Samuel tell Israel pipol wetin God tok.
Israel pipol kon go fight Filistia pipol. Dem kamp for Ebeneza and Filistia pipol kamp for Afek. Filistia pipol kon gada dia sojas go fight Israel pipol. Wen di fight start, Filistia pipol kon win and kill about 4,000 Israel men for di war. Wen di sojas kom back to dia kamp, Israel leaders kon sey, “Wetin make God let Filistia pipol win us like dis? Make wi karry God Kovenant Box from Shiloh, follow body. If di box dey with us, e go save us from awa enemies.”
So dem send some sojas go Shiloh go karry God Kovenant Box wey dey for di cherubim centre. Eli two boys pikin, Hofni and Finehas, dey der with God Kovenant Box.
Wen God Kovenant Box rish di kamp, Israel pipol kon shaut well-well, sotey di groun kon dey shake. Wen Filistia pipol hear di pipol shaut, dem kon sey, “Wetin make Israel pipol dey shaut like dis for Hibru kamp?”
Fear katch Filistia pipol, bikos dem fill sey difren gods don enter Israel kamp. Dem kon sey, “Dis one bad for us! Wi neva si anytin like dis before o-o! Dis one sirious well-well! Na who go save us from dis big-big gods? Dis na di gods wey kill Egypt pipol with difren diziz for di desert! So Filistia pipol, make una dey strong kon bihave like men, if not una go serve Hibru pipol di way wey dem don serve una! Make una fight dem like men!”
10 So Filistia pipol kon fight and kill Israel pipol well-well till di remainin ones, run go house. Di pipol wey dem kill many well-well; 3,000 sojas wey dey waka for groun die for di war; 11 dem take di Kovenant Box go and Eli two boys, Hofni and Finehas die too.
Eli Die
12 Dat day, one man from Benjamin tribe run from di war front go Shiloh. E shirt don tear and dirty full en head. 13 Wen e rish Shiloh, Eli sidan for chair for outside dey look di road, bikos en mind dey disturb am about di Kovenant Box. As di man enter di town go tok wetin happen, di whole town kon dey kry.
14 Wen Eli hear dem dey kry, e kon sey, “Wetin dey happen?”
Di man run go meet Eli kwik-kwik. 15 Dis time, Eli na ninty-eight years. En eyes open, but e nor dey fit si well. 16 Di man kon tell Eli, “I run komot from di war front today!”
Eli kon ask am, “My pikin, na wetin dey happen for dat side!”
17 Di man ansa, “Israel pipol don run from Filistia pipol! Dem don kill di sojas well-well! Yor two boys, Hofni and Finehas, don die too. And dem don karry God Kovenant Box go!”
18 As di man koll God Kovenant Box, Eli kon fall from en chair go back near di gate. En neck break and e kon die, but e don old well-well. E judge Israel pipol for forty years.
19 En pikin, Finehas wife get belle and don nearly born. Wen e hear sey Filistia pipol don take di Kovenant Box and en husband and en husband papa don die, e shaut well-well kon born. But di pains too mush for am. 20 As e dey die, di wimen wey dey with am kon sey, “Nor fear! Yu don born boy!” But e nor ansa dem or listin to wetin dem dey tok.
21 E koll di pikin Ikabod, wey mean “God glory don komot from Israel,” e dey tok about di Kovenant Box wey Filistia pipol don karry go, en husband and husband papa wey don die. 22 E kon sey, “God glory don komot from Israel, bikos Filistia pipol don karry God Kovenant Box go.”