5
Di Kovenant Box Kause Wahala For Filistia Pipol
Naw, Filistia pipol don karry God Kovenant Box from Ebeneza go Ashdod. Dem take di Kovenant Box go Dagon temple kon put am near Dagon. Wen di pipol for Ashdod wake-up di next day, Dagon don fall for groun for di box front. So dem take Dagon kon put am back for where e suppose dey. But wen dem wake-up di next day again, Dagon dey groun for di Kovenant Box front. Dis time, en head and hand don break komot and e liedan face di door. Na only di body remain. Bikos of dis, go rish today, nobody fit enter Dagon temple again, bikos anybody wey won enter di temple for Ashdod, go first mash Dagon head pass.
God really attack di pipol wey dey stay Ashdod and E kause betta wahala for dem. God put sore for all di pipol body, both doz wey dey Ashdod and doz wey dey stay near der. Wen Ashdod pipol si wetin dey happen, dem kon sey, “Make dem komot Israel God Kovenant Box from here, bikos e don attack both wi and Dagon wey bi awa god!” So dem gada all Filistia pipol leaders kon sey, “Wetin wi go do to dis box wey bi Israel pipol God own?”
Di leaders ansa, “Make dem karry am go Gat.” So dem kon karry di box go.
But afta dem don komot am, God attack di town again kon make all of dem dey fear. E make sore full di pipol body.
10 So dem karry di box go Ekron, den di pipol for Ekron kon shaut dey sey, “Dem don bring Israel God Kovenant Box kom here, so dat e go kill awa pipol!” 11 So dem gada all Filistia pipol leaders kon sey, “Make una komot di Oga wey bi Israel God box from dis place! Make una karry am go back to where e dey before, so dat e nor go kill wi and awa pipol!” Di angel wey dey kill pipol dey di town dey waka and God dey ponish di pipol well-well. 12 Doz wey nor die, get sore full body and di kry wey di town pipol dey kry, dey even rish heaven.