6
Filistia Pipol Riton Di Box
Di Kovenant Box dey for Filistia pipol land for seven monts. So Filistia pipol koll di priest and doz wey dey si vishon kon sey, “Wetin wi go do with di Kovenant Box? Make una tell us how wi go take karry am go back to where e suppose dey.”
Dem kon ansa, “If una won riton Israel God box go back to where e dey before, una must karry sometin join am. Una must put ofrin wey go show sey wetin una do nor good. Den una go dey well and una go know wetin make God dey ponish una.” Dem kon ask, “Na wetin bi di ofrin wey wi go karry follow am?”
Di priest and doz wey dey si vishon kon ansa, “Una leaders na five. So make una karry five gold sore and five gold rat, bikos na di same sickness do una with una leaders. Una go make image wey bi like di sore and rat wey dey distroy di whole land, den kon honor Israel God. May bi E go sorry for una, una gods and una land. Wetin make una dey sturbon like Egypt pipol and dia king? Wen God ponish dem, dem nor sey make Israel pipol dey go?
“So make una go make truck, plus two melu wey dem neva put wood cross dia head before. Make una karry dem for di truck kon drive dem with dia pikin go di yard. Den make una take di Kovenant Box put for di truck kon add di gold tins wey una won give God join am, as ofrin for wetin una don do so. Den una go send am go. But make una dey look am. If only di truck go by ensef to Bet-Shemesh borda, den make una know sey na God give una dis big wahala. But if e nor go like dat, den wi go know sey nor bi en dey give us dis wahala; instead, e just happen to us like dat.”
10 So di men go do as di priest tell dem. Dem take two melu kon join dem to di truck; dem put dia pikin from di yard. 11 Dem kon put di Kovenant Box for der, plus di cupboard, di gold rat and sore image. 12 Den di melu kon go strait to Bet-Shemesh. Dem dey make nois as dem dey go. Dem nor turn face left or rite. Filistia pipol leaders follow dem for back until dem rish Bet-Shemesh borda.
13 By dis time, di pipol for Bet-Shemesh dey harvest wetin dem plant for dia farm. Wen dem look up kon si di box, dem happy well-well. 14 Di truck enter one field for Bet-Shemesh and na Joshua own, den e stop for der near one big stone. Di pipol skata di truck, kill and offa di two melu as burnt ofrin give God. 15 Doz wey kom from Levi tribe, karry di Kovenant Box with di cupboard wey get di gold tins wey follow di box kon go put am near di big stone. So Bet-Shemesh pipol offa burnt ofrin and sakrifice to God. 16 Di five Filistia pipol leaders dey wosh wetin dey happen, but dem go back to Ekron for dat same day.
17 Dis na di towns wey Filistia pipol leaders for bring di gold sore wey dem offa to God, so dat E go forgive dem dia sin: Ashdod, Gaza, Ashkelon, Gat and Ekron. 18 Dem still bring gold rat for each towns wey di five kings dey rule; from di strong ones go rish di village dem, plus di Great Abel where dem put di Kovenant Box, until di day wey e rish Joshua (wey kom from Bet-Shemesh), field.
19 But God kill some of Bet-Shemesh pipol, bikos dem go look inside di box; pipol wey God kill na 50,070. Di pipol kry, bikos God kill dia pipol. 20 Di pipol wey dey stay Bet-Shemesh kon ask, “Na who go fit stand before di Oga awa God wey dey holy? Na where wi won send di box go, so dat God go leave us?”
21 So dem kon send messenja go meet di pipol wey dey Kiriat-Jearim sey, “Filistia pipol don riton di Kovenant Box. Make una kom take am go house.”