40
Ezekiel For Jerusalem
Twenty-five years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di tent day for di new year wey bi di fourteent year afta dem skata Jerusalem, God kon tosh mi with en hand and E take mi enter di town. So, for inside vishon, God karry mi go Israel land kon put mi on-top one high mountin. For my front, I si sometin wey bi like one big town. E take mi near am, den I si one man wey dey shine like bronze. E whole tape and stik wey dem take dey measure and e stand near di gate. E kon tell mi, “Man pikin! Listin well-well and look evritin wey I dey show yu, bikos dis na di rizin why dem bring yu kom der, so dat yu go tell Israel pipol evritin wey yu si.”
Di East Gate
I si wall wey dey round di temple for outside. Di man take en stik wey e take dey measure, wey long rish ten fit kon measure di wall. Di wall high and tick rish ten fit. Den e klimb go di east gate go measure where dem dey pass enter and e deep rish ten and half fit. For en front, e get one road wey pesin fit pass and three guard-room dey der. Each room na like skware wey bi ten and half fit and di wall wey separate dem tick pass eight fit. Afta di guard-room, anoda road dey wey long pass ten fit and yu go pass der go di big room wey face di temple. Den e measure di room wey face inside and na ten and half fit. E measure di room for di gate and na fourteen fit. And na dis room end di gate wey dey near di temple, but di end side for di wall tick pass three fit. 10 Three guide rooms dey for each gate and all of dem na di same size and all di wall wey separate dem, na di same tickness dem get too. 11 Den, di man measure as di road wide rish and evritin pass twenty-two fit, but di space wey dey between di gate na seventeen and di half fit. 12 For di guide rooms front, e get one wall wey high rish about two fit and dem tick rish ten and half fit. 13 Den e measure di distance from di back wall from one room go rish di room wey dey afta di road and e pass forty-three fit. 14 Pesin fit pass di ending room go where di kourt dey. E measure dat room and e high rish hundred fit. 15 So from outside di gate go rish di last room, e pass eighty seven fit and half. 16 Small-small whole dey di outside wall for all di rooms and di inside wall wey dey between di rooms. Dem karve palm trees for di inside wall wey face di road.
Di Kourtyard For Outside
17 Di man karry mi pass di gate enter di kourt. Na thirty rooms dem build join di wall for outside and for dia front, e get one place where dem pak stone full 18 and e many round di kourtyard. Di kourtyard for outside low pass di inside. 19 E get one gate wey dem dey pass go di kourt for inside. E measure from di first gate go rish di sekond and na one hundred and seventy-five fit for di east and di nort.
Di Nort Gate
20 Den di man measure di gate for nort wey yu go pass go di kourtyard. 21 Di three guard-room wey dey di passage side; di wall wey divide dem plus di big room, all of dem na di same size with doz wey dey for di east gate. Di gate lengt na eighty seven and half fit and e wide pass forty-three fit. 22 Di big room, di window and di tree wey dem karve put, bi like di ones wey dey di east gate. Na seven steps yu go pass before yu go rish di gate and di big room face di kourtyard for di end. 23 For di oda side for di kourtyard from di nort gate, anoda road dey wey dem dey pass go inside di kourt, just as e bi for di east. Di man kon measure how dem two far from each oda and na one hundred and seventy-five fit.
Di Sout Gate
24 Den di man take mi go di sout-side and anoda gate dey der. E measure am and na di same size with di oda ones. 25 Windows dey di room for dis gate, just like di oda ones. Di lengt for dis gate pass eighty seven fit and e wide pass forty-three fit. 26 E get seven steps and di big room still face di kourtyard for di end. Palm tree wey dem karve for di wall wey dey inside, face di passage. 27 For der, e still get one gate wey dem fit pass go inside di kourtyard. Di man measure how e take far from di sekond gate and na one hundred and seventy-five fit.
Di Kourtyard For Inside: Di Sout Gate
28 Di man take mi pass di sout gate kon enter inside di kourt. E measure di gate and na di same size with di ones wey dey outside di kourt. 29 Di guard-room, di big room and di wall for inside na di same size with di ones wey dey di oda gates. Windows still dey der too. 30 Di total lengt long pass forty-three fit and e wide pass eight fit. 31 En big room face di oda kourtyard and dem still karve palm tree for di wall wey dey di passage. Na eight steps dem go pass rish der.
Di Kourtyard For Inside: Di East Gate
32 Di man take mi pass di east gate enter inside di kourtyard. E measure di gate and na di same size like di oda ones. 33 En guard-room, en big room and di wall for inside, na di same measurement like di oda gates. Windows still dey der and for di big room too. Di lengt pass eighty seven fit and e wide pass forty-three fit. 34 Di big room face di kourt for outside. Dem still karve palm tree for di wall wey dey di passage. Na eight steps dem go pass rish der.
Di Kourtyard For Inside: Di Nort Gate
35 Den di man take mi go di gate for nort. E measure di gate and na di same size like di oda ones. 36 Like di odas, e still get guide rooms, walls wey dem design for inside, big room and windows for evriwhere: Di lengt pass eighty seven fit and e wide pass forty-three fit. 37 Di big room face di kourt for outside. Dem still karve palm tree for di wall wey dey di passage. Na eight steps dem go pass rish der.
House Where Dey Near Di Nort Gate
38 For di kourtyard for outside, e get one small room wey dem build join di gate for inside for di nort side. Yu fit from der go di big room wey face di kourt and na der dem for dey wosh di animals wey dem won burn as sakrifice. 39 For dis big room, four tabol dey der; two der for each side for di room. Na for dis tabol dem for dey kill di animals wey dem won sakrifice; weda dem won burn or sakrifice am for sin or as ofrin. 40 For outside di room, four tabol wey bi like di same dey der, two-two for di side wey dem dey pass for di nort gate. 41 So, na eight tabol dey where dem for dey kill di animals wey dem won sakrifice: four dey inside and four dey outside di room for di kourtyard. 42 Di four tabol for di small room where dem for dey prepare di ofrin wey dem won burn, na stone dem take make dem. Dem long pass two fit; wide pass two fit and high pass one fit. All di knife wey dem take dey kill di animals, dey on-top di tabols. 43 Di hooks wey dey di tabol na three inches dem long rish. All di meat wey dem go take do sakrifice dey dis tabol.
44 Den di man take mi enter di room for inside. E get two rooms for inside di kourt, one face sout near di nort gate and di oda one face nort near di sout gate. 45 Di man kon tell mi, “Di room wey face di sout na for di priest wey dey serve for di temple, 46 while di one wey face nort, na for di priest wey dey serve for di altar. All di priest na Zadok shidren-shidren; na dem bi di only pipol for Levi tribe wey fit go serve God for inside en temple.”
Di Kourtyard And Di Temple
47 Di man measure inside di kourt and e wide and long rish one hundred and seventy-five fit. Di temple dey for di west side and di altar dey di temple front.
48 Den di man take mi enter di temple. E measure where dem dey pass enter and e deep pass eight fit and wide pass five fit. 49 Steps dey wey pesin dey pass go di room for inside wey long rish thirty-five fit and e almost wide rish twenty fit. Two marks dey der: One for each of di side where dem for dey pass enter.