41
Di Temple
Leta, di man take mi go di Holy Place for di centre room. E measure di passage wey dem dey pass enter: e deep rish ten and half fit for each side. Wide rish eighteen fit and di wall for di two side almost tick rish nine fit. E measure di room and e long rish seventy fit kon wide rish thirty-five fit.
Den e go inside-inside di room kon measure di passage: e almost deep rish four fit kon wide rish ten fit and half and di wall for di two side tick pass twelf fit. E measure di room and na thirty-five fit e bi. Dis room dey afta di room for centre. Den e kon tell mi, “Dis na di Most Holy Place.”
Di Room Wey Dem Build Join Di Temple Wall
Di man measure as di temple wall bi and e tick rish ten fit. Round di wall for di temple, small-small rooms dey wey wide rish seven fit. Di room dem dey three story building and each story get thirty rooms. Di wall for outside di temple tin pass di ones wey dey bottom, so dat dem go fit build di rooms make dem rest for di wall body. So, wen yu si di temple wall for outside, e bi like sey na di same tickness e get go rish top. For outside di temple wall and di rooms, dem build two wide step for der where pesin go pass klimb go di middle house and di one wey dey up.
Di outside wall for dis rooms tick rish ten and half fit; e get one door wey dem take dey enter di rooms wey dey di nort side for di Temple and one room dey to pass enter di sout-side for di temple too. I si sey di road to go di building so, wide rish eight fit 10 and di open space for di kourt wide rish thirty-five fit for all di side. 11 Between di road and di building wey di priest dey use, e get one open space wey almost wide rish nine fit.
Di Building For West
12 For di end for di open space for di west side for di temple, e get one building wey long rish one hundred and fifty-seven and half fit and e wide rish one hundred and twenty-two and half fit; en wall tick rish nine fit.
Di Temple Measurement
13 Di man measure outside di temple and e long rish one hundred and seventy-five fit. So from di temple back go di open space go rish di west side for di building, na one hundred and seventy-five fit. 14 Di distance from di temple front plus di open space for di two side, na one hundred and seventy-five fit. 15 E measure di building lengt go rish di west; plus di bottom for di two side and na one hundred and seventy-five fit e bi.
How Di Temple Bi
16 Di passage wey dem dey pass enter di temple room, di Holy Place and di Most Holy Place, dem do dem with betta wood from groun go rish di window kon kover dem (dem kover di windows too), 17 go rish di space for outside and evriwhere for inside and outside wey dem measure. 18 Dem karve angel put for der kon design am with palm tree and palm tree still dey di two angel middle. Each angel wey dem karve get two face: 19 human being face wey dem draw face di palm tree for one side and lion face wey dem draw face di tree for di oda side. Na so dem karve dem for evriwhere for di temple; 20 from groun go rish di door-mot, dem karve and dekorate di angels for outside di temple too. 21 Na skware shape dem do put for di Holy Place door and dem resemble each oda.
Di Wood Altar
22 For di road wey dem dey pass enter di Most Holy Place, e get sometin for der wey bi like altar wey dem do with wood. E high pass five fit and almost wide rish four fit. En korna; di base and en sides, na wood dem take make dem. Den di man tell mi, “Dis na di tabol wey dey God present.”
Di Door
23 E get one door for where di passage for end for di Holy Place and one door still dey for di Most holy place. 24 Each door still get two-two small doors where pesin fit pass. 25 Dem karve angel and palm tree for di door for di Holy Place, just as dem karve for di walls. And e get one kanopy wey wood full for outside di room. 26 Na small-small windows wey dem dekorate with palm tree dey di wall. Dis na how di open space and di kanopy for di temple, bi like.