42
Two Building Near Di Temple
Den di man take mi go di kourtyard for outside and wi pass di building for di nort side for di temple wey nor far from di one wey dey di west side for di temple. Dis building long rish one hundred and seventy-five fit for di nort side and wide rish eighty seven and half fit. Opposite di space wey bi thirty-five fit wey dey for di kourt for inside and outside, dem build am as three story and dem face each oda. For di nort side, dis building passage wide pass seventeen and half fit. Naw, di room on-top di building small pass di ones wey dey middle and bottom, bikos e big pass di down and middle rooms, bikos dem build dem as three story and dia pilas nor tick like di kourt own; so di top own nor tosh groun like di down and middle floor. But for di outside wall for di building wey face di main door-mot, e long pass eighty seven fit. Di room for di outside kourt long rish eighty seven and half fit, while di ones wey face di temple, long rish one hundred and seventy-five fit. Under di rooms, for di east end for di building, na der di wall for start, e still get where dem dey pass enter di kourtyard for outside.
10 For der, e get one room wey resemble di rooms for di sout-side for di temple and dis room nor far from di rooms wey dey di west side for di temple. 11 For di rooms front, e get one passage wey bi like di one wey dey di nort side. E get di same measurement; di same design and na di same road, dem dey pass enter. 12 One door dey under di rooms for di sout-side for di building and for di east end where di wall for start.
13 Di man kon tell mi, “Dis two buildings wey face di open space so, dey holy. Na for inside dem, di priest wey dey enter God present, for dey chop di ofrin wey holy pass. Bikos di rooms dey holy, di priests go put di ofrin wey holy pass for der: di korn wey dem sakrifice for sin or for ofrin. 14 Wen di priests enter di temple kom out and dem won go outside for di kourtyard, di holy klot wey dem wear take serve God, dem must leave am for dis rooms before dem komot. Dem must wear anoda klot before dem go-go where pipol gada dey wait dem.”
Di Measurement For Di Temple Aria
15 Wen di man don measure inside di temple finish, e take mi go outside thru di east gate kon measure outside di aria. 16 E measure di east side and na eight hundred and seventy-five fit. 17 Den e measure di nort side, di 18 sout-side and na eight hundred and seventy-five fit dem bi too. 19 E still measure di west side and all of dem na di same lengt wey bi eight hundred and seventy-five fit. 20 E measure dem from di four side. Di wall wey dey der, na to separate wetin dey holy from wetin nor dey holy and e long rish eight hundred and seventy-five fit and e still wide rish eight hundred and seventy-five fit too.