43
God Kom Back To Di Temple
Di man take mi go di east gate and I kon si Israel God glory dey kom from di east. God vois sound like nois from sea and en glory shine kover di eart. Dis vishon bi like di one wey I si before wen God kom distroy Jerusalem and di one wey I si near Chebar River. Den I fall face groun. God glory shine pass di east gate kon enter di temple. Den God Spirit karry mi go inside di kourtyard and God glory full di temple.
Di man stand near mi and I hear wen God dey tok to mi from di temple sey: “Man pikin, na my throne bi dis. I go stay here with Israel pipol kon rule dem forever. Di pipol for Israel or dia kings nor go disgrace my name wey dey holy again or woship anoda god or dia king wey don die. Di kings build di door post and door-mot join my own and na di wall separate us. Na all dis bad tins wey dem dey do, make dem dey disgrace my name wey dey holy and I distroy dem, bikos I dey vex. Naw, dem must stop to woship any oda god kon beri all doz kings dead body wey dem dey serve. If dem do like dis, I go stay with dem forever.”
10 God kon sey, “Man pikin, tell Israel pipol about di temple, so dat dem go undastand di plan. Make shame katch dem, bikos of di sin wey dem dey kommit. 11 Den, if shame don katch dem for wetin dem do, make yu tish dem about di temple plan: how en design bi; di door-mot; en shape; as dem take arrange evritin for der and all en rules and laws. Rite evritin give dem, so dat dem go fit read how dem arrange di temple kon do di rules and obey di laws.
12 “Dis na di temple law: All di aria wey dey near am on-top di mountin, der holy.
Di Altar
13 “Na di altar measurement bi dis, just as dem measure di temple: Di korna go high rish like two fit kon almost wide rish two fit, while di rim for outside, go long rish nine inches. Na so di altar go high rish. 14 Di size wey low pass from di altar go rish di top go almost high rish four fit. Di oda size for di altar go almost wide rish two fit and di small side go bi seven fit. Anoda part for di altar still get space wey almost rish two fit. 15 Di top part where dem for dey do sakrifice still high rish seven fit. Di four korna high pass all di remainin ones for di top. 16 Di altar top na skware and na twenty-one fit for each side. 17 Di middle part na skware too and e long pass twenty-four fit kon wide rish twenty-four and half fit for di four side; di korna go bi ten and half inches and di suroundin go bi about two fit. En step face di east side.”
Dem Santify Di Altar
18 God wey get pawa kon tell mi, “Man pikin, make yu listin to wetin I dey tell yu. Wen dem build di altar, yu go sakrifice animal put. Di animal wey dem sakrifice, yu go pour en blood put take dedikate am. 19 Doz priests wey kom from Levi tribe wey bi Zadok shidren-shidren, na only dem go fit kom inside my present kom serve mi. Na mi, wey bi God wey get pawa dey kommand yu. Yu go give dem one yong melu make dem offa as sakrifice for sins. 20 Yu go take some of en blood kon put am for di four horn, di korna for di altar, di one for middle and round di korna dem. Like dis, yu go klean di altar kon make am dey holy. 21 Yu go take di melu wey dem offa as sakrifice for sin kon burn am for one place outside di temple aria.
22 “Di next day, yu go take one man goat wey dey okay kon offa am as sakrifice for sin. Yu go use en blood take klean di altar, just as yu do with di melu own. 23 Wen yu don do dat one finish, take one small melu and ram wey dey okay, 24 den bring dem kom meet mi. Di priest go pour salt for dia body kon burn dem as ofrin give mi.
25 “Each day for seven days, yu go offa one goat, one melu and one ram give mi as sakrifice for sin. All of dem must dey okay. 26 For seven days, di priests go klean di altar, so dat e go dey ready wen dem won use am. 27 Wen di seven days don finish, di priests go bring dia ofrin and di pipol ofrin kom. Den I go dey happy with all of una.
Mi, God wey get pawa, don tok.”