44
Di East Gate
Den di man take mi go outside di gate for di east side for di temple aria. Dem klose di gate. God kon sey, “From naw go, dem nor go ever open dis gate and as e dey so, na so e go dey. Dem nor go let human being use am, bikos mi di Oga wey bi Israel God, don pass am enter. E must dey klose like dat forever. Di prince wey dey rule naw fit go der go chop di holy food for my present. E go enter kon pass di big room for inside, go out.”
Rule For Di Temple
Den di man take mi pass di gate for nort go di temple front. As I still dey look, I kon si God glory dey shine for di temple. At wons, I fall face groun and God kon tell mi, “Man pikin, listin well-well to evritin wey yu hear and si. I go tell yu di rules and di laws for di temple. Listin well-well, so dat yu go know di pesin wey go fit enter and kom out from di temple and doz wey nor suppose enter. Go tell doz bad pipol wey dey Israel sey, mi God wey get pawa nor go sorry for dem again, bikos of di yeye tins wey dem dey do. Dem don dirty my temple, bikos dem dey allow pipol wey neva sekonsaiz enter. Pipol wey nor dey obey mi dey enter di temple wen dem dey offa animal give mi as sakrifice. So my pipol don break di kovenant with all dis yeye tins wey dem dey do. Dem nor dey kare for di holy place for my temple, instead na strenjas dey lead dem for my temple. Mi wey bi God wey get pawa, dey kommand una sey, strenjas wey neva sekonsaiz; doz wey nor dey obey mi, make dem nor ever enter my temple, even if na strenjas wey dey stay with my pipol.”
Dem Remove Levi
10 God tell mi, “I dey ponish Levi tribes wey join Israel pipol sin kon still woship juju. 11 Dem fit still serve mi for di temple kon stand for di gate den do di temple work. Dem fit kill di animals wey pipol kom offa as sakrifice and dem must dey to serve di pipol. 12 But bikos dem follow odas go serve juju kon make Israel pipol sin, mi God wey get pawa dey swear sey I must ponish dem. 13 Dem nor go serve as priest or go near anytin wey dey holy to mi or enter my Most holy place. Dis ponishment na for di yeye tins wey dem don do. 14 Na di work wey dem go do for di temple, I dey tell dem so.”
Di Priests
15 God wey get pawa sey, “All di priests from Levi tribe wey bi Zadok shidren-shidren must kontinue to serve mi, even wen all di odas for Israel nor gri serve mi again. So naw, na dem go serve, enter my present kon offa di animals and di blood for di sakrifice, give mi. 16 Na only dem go enter my temple; serve mi for my altar kon lead odas to woship mi.
17 “Wen dem enter di gate where dem go pass go di kourtyard for inside di temple, dem must wear linen klot. Anytime dem dey work for di kourtyard or di temple, make dem nor wear anytin wey dem make with wool. 18 Dem must wear turban and linen trousers without belt, so dat dem nor go sweet. 19 Before dem go-go di kourt for outside where pipol dey, dem go first pul dia klot wey dem wear take work inside di temple kon leave am for di holy rooms. Dem go wear anoda klot, so dat dia holy klot nor go tosh pipol.
20 “Make priest nor barb en hair or let am grow too mush. Dem must let am grow rish one stage kon maintain am like dat. 21 Priests nor go drink any wine before e go inside di kourt. 22 Priests nor go marry woman wey nor dey with en husband again; na only Israel woman wey neva sleep with man before, e go marry or anoda priests wey don die, wife. 23 Na priests go tish my pipol di difren between wetin dey holy and wetin nor dey holy; wetin dey klean and wetin nor klean.
24 “Wen any kase dey kourt, na di priests go judge am akordin to my law. Dem go make sure sey dem kontinue di festival akordin to my rules and laws and dem must keep di Sabat Day holy.
25 “Anybody wey bi priest must nor tosh dead body, if not, e nor go dey klean again. Unless di dead body na en mama, papa, pikin, broda or sista wey neva marry before. 26 Afta e don dey klean again, e must wait for seven days 27 den kon go di kourt for di temple go offa sakrifice to klean ensef, so dat e go fit serve for di temple again.
Mi, God wey get pawa, don tok.”
28 “Na mi bi di priests propaty for life and una nor go give dem any propaty; I bilong to dem and evritin wey dem wont, na mi. 29 Di korn ofrin, di sin ofrin and all di oda ofrins; dem go bi di priests own and evritin for Israel wey di pipol give mi, go bi di priests own too. 30 Di priests go get di betta part for evry first fruit or food for Israel and evritin where Israel pipol go offa give mi. Anytime di pipol bake bread, dem must give di priests di first bread as ofrin and my blessing go dey dia house. 31 Di priests nor go chop bird or animal wey die on dia own or wey anoda animal kill.”